TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Naija get di second-highest nomba of pipu wey get HIV for di world?
Share
Latest News
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?
Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?
Shin Najeriya ta dakatar da ‘yarjejeniyar ma’adinai’ da Amurka bayan hana biza?
FACT CHECK: Did Nigeria halt ‘mineral deal’ with US after visa restrictions?
FACT CHECK: Viral image depicting ‘Obasanjo prostrating for Ladoja’ photoshopped
Wike tụ̀rụ̀ àsị́. Peter Obi mèrè ńtụ̀líáká ọ̀chị́chị́ ḿpághárá m̀gbè ọ́ bụ̀ gọ́vánọ̀ Anambra
Irọ́ ni Wike pa. Peter Obi ṣètò ìdìbò ìjọba ìbílẹ̀ nígbà tí ó jẹ́ gómìnà Ìpínlẹ̀ Anambra
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Naija get di second-highest nomba of pipu wey get HIV for di world?

Claire Mom
By Claire Mom Published February 10, 2025 4 Min Read
Share

On January 28, Chinonso Egemba, di Nigerian medical expert aka Aproko Doctor, claim sey Nigeria get di second-highest nomba of pipu wey dey live wit human immunodeficiency virus (HIV) for di world.

Aproko Doctor share di claim for im X handle, wey get like 2.3 million followers.

Im bin dey chuk mouth for US President Donald Trump executive decision to cancel moni for HIV treatment for kontris wey still dey develop.

As Trump give di executive order, di US Department of State suspend di moni wey dem bin dey give from di president’s emergency plan for AIDS relief (PEPFAR).

According to di World Health Organisation (WHO), PEPFAR dey provide HIV treatment for more dan 20 million pipu wey dey live wit di disease for di world, including 566,000 children under 15 years of age.

For di post, di medical influencer bin dey explain how di money wey US govment cancel to treat HIV go affect how antiretroviral drugs go dey available.

Wen dem challenge Aproko Doctor about di source of im informate, im share screenshot of report from di United Nations Children’s Fund (UNICEF) website.

“Nigeria get di second highest nomba of pipu wey dey live wit HIV for di world,” na so Aproko Doctor write.

For di article wey dem publish in 2018, UNICEF tok sey Nigeria get 190,950 HIV/AIDS infections per year – di second highest rate for di world. Di global bodi tok sey Nigeria get di world’s second-highest burden of HIV/AIDS, wit an estimated three million people wey dey live wit HIV. Di article show sey di informate wey UNICEF quote na since 2015.

E dey necessary to understand sey di burden of di virus dey different from di informate of pipu wey dey live wit am. Di HIV burden na di overall impact of di virus, including di nomba of pipu wey dey live wit di virus, di rate of new infections, and di deaths caused by di virus, among odas.

WETIN WE CHECK

To confam di mata, CableCheck look di WHO’s HIV country intelligence dashboard. As of 2023, di dashboard show informate about pipu wey dey live wit HIV for at least 134 countries.

Di informate show sey South Africa get di highest nomba of pipu wey dey live wit HIV, wit 7.7 million individuals, followed by India at 2.5 million, Mozambique wit 2.4 million, and Nigeria as nomba four wit 2 million.

Country Number of Persons Living With HIV
South African 7,700,000
India 2,500,000
Mozambique 2,400,000
Nigeria 2,000,000
United Republic of Tanzania 1,700,000
Uganda 1,500,000
Kenya 1,400,000
Zambia 1,300,000
Zimbabwe 1,300,000
Brazil 1,000,000

Table wey show di top 10 kontris wit di highest nomba of pipu wey dey live wit HIV.  Informate: WHO 

Dis informare mean sey Nigeria get di fourth-highest nomba of pipu wey dey live wit HIV globally and di third-highest for Africa.

For report wey di WHO released in July 2024, approximately 39.9 million people bin dey live wit HIV at di end of 2023. Di report no give di breakdown of informate for each kontri. Howeva, an estimated 26 million pipu wey dey live wit di virus dey Africa.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey Nigeria get di second-highest nomba of pipu wey dey live wit HIV for di world no correct. Recent informate from di WHO show anoda tin.

TAGGED: HIV rate in Nigeria, News in pidgin, WHO

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom February 10, 2025 February 10, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?

Ótù onye nà Facebook ekwuola na Naijiria emegwarụla mgbachibido visa nke mba US site n'ịkwụsị…

July 18, 2025

Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára ti sọ pé…

July 18, 2025

Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?

One Facebook user claim sey Nigeria revenge against di recent United States visa restriction by…

July 18, 2025

Shin Najeriya ta dakatar da ‘yarjejeniyar ma’adinai’ da Amurka bayan hana biza?

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa Najeriya ta mayar da martani…

July 18, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?

Ótù onye nà Facebook ekwuola na Naijiria emegwarụla mgbachibido visa nke mba US site n'ịkwụsị nkwekọrịta azụmahịa akụ ọnatarachi dị…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára ti sọ pé orílẹ̀ èdè Nàìjíríà hùwà sí…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?

One Facebook user claim sey Nigeria revenge against di recent United States visa restriction by stopping one alleged mineral deal…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

Shin Najeriya ta dakatar da ‘yarjejeniyar ma’adinai’ da Amurka bayan hana biza?

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa Najeriya ta mayar da martani ne kan takunkumin da Amurka…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?