TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Na true sey Trump dey deport 3.7m Nigerians from di US?
Share
Latest News
Did Tinubu attend same school with Alexander Zingman? Here is what we know
FACT CHECK: Did Nigeria deploy peace support mission to Israel?
FACT CHECK: Did lawmakers skip the national anthem during Tinubu’s Democracy Day speech?
FACT CHECK: Did a military coup oust Paul Biya as Cameroon’s president?
FACT CHECK: Ndume erred. 22 governors didn’t endorse Jonathan in 2015
Rárá, Pope Leo kò bẹ Tinubu kó tú Nnamdi Kanu sílẹ̀ ní àtìmọ́lé
Ḿbà, Pope Leo áyọghị Tinubu kà ọ́ tọ́pụ̀ Nnamdi Kanu nà ǹgá
No, Pope Leo no beg Tinubu to release Nnamdi Kanu
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Na true sey Trump dey deport 3.7m Nigerians from di US?

Claire Mom
By Claire Mom Published January 24, 2025 5 Min Read
Share

One social media user don claim sey United States President Donald Trump plan to deport 3.7 million Nigerians.

Di claim, wey dem make on Monday — di same day wey Trump enta office — tok sey di deportations go hapun on Tuesday.

“My goat Donald Trump dey deport all these pipu tomoro see who be nomba 1 for di list,” @Zaddy_Bruh, di X user wey get Russian flag next to im username, tweet give im followers.

Nigeria sidon ontop di eight-kontri list wit 3.7 million pipu wey dem allegedly suppose deport; next na Zimbabwe wit 765,000, Ghana wit 1.2 million, Mozambique wit 123,000, and Bangladesh wit 1.9 million.

Oda kontris wey dey di list na Brazil wit 6.9 million, di Democratic Republic of Congo (DRC) with 2.1 million, and Mexico with 17.8 million.

Dem bin no list di kontris according to di one wey get di biggest nomba but na Nigeria di pesin first call.

So far, di tweet don gada pass 2.7 million views, 16,000 likes, 2000 retweets, 1400 bookmarks, and 1300 comments wey dey mostly express fear about di alleged planned action.

WETIN WE CHECK

Before im win di presidential election in November, Trump tok sey controlling immigration go be one of im main actions.

Most of di time, di US president dey describe illegal immigrants as animals wey dey increase crime rates for di US.

During im inauguration, im announce some executive orders wey im go immediately implement on im first day for office.

One of these actions na national emergency wey im declare for di US-Mexico border and action wey require army to go tighten security for border.

“All illegal entry go immediately stop. And we go begin di process of returning millions and millions of criminal animals back to di places wey dem come from,” na so Trump tok.

Di president also tok sey im administration restore di “Remain in Mexico” programme, wey require pipu wey dey seek refuge for US to wait for Mexico as dem dey process dia papers.

Trump no mention any oda kontri but im no hide im feelings toward illegal immigrants.

According to one 2024 Migration Policy Institute (MPI) report, nearly 46.2 million immigrants dey live for US.

Di report’s informate bin come from di US Census Bureau (using im 2022 American Community Survey [ACS], 2023 Current Population Survey [CPS], and 2000 decennial census) and di US Department of Homeland Security (DHS).

Di latest informate from di DHS show sey Mexicans account for 4.81 million in 2022, representing di largest illegal immigrant group.

Afta Mexico, di next largest illegal immigrant populations bin come from Guatemala, El Salvador, and Honduras.

Oda ontop di top 10 list bin include di Philippines, Venezuela, Colombia, Brazil, India, and China.

As of 2023, informate from di United States Census Bureau show sey di population of Nigerians for di kontri na 604,077.

Also, e dey important to note sey deportation from di US dey follow one long process wey no fit dey achievable in one day as di social media user claim.

Di US Immigration and Customs Enforcement (ICE) fit hold di foreign national for detention center before trial or deportation.

After dem detain di non-citizen, dem fit appear before judge for immigration court during di deportation process.

In addition, no US government statement don comot to confam di tweet wey claim sey dem go deport 3.7 million Nigerians. No correct US media outlet folo report di mata.

FINAL TOK

No evidence dey to support di claim sey Trump order di deportation of some kontri pipu from di US.

TAGGED: immigrants in US, News in pidgin, Nigerians in US, Trump

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom January 24, 2025 January 24, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Did Tinubu attend same school with Alexander Zingman? Here is what we know

During the launch of the renewed hope mechanisation programme in Abuja on Monday, President Bola…

June 24, 2025

FACT CHECK: Did Nigeria deploy peace support mission to Israel?

A Facebook video purports that Nigeria deployed troops for a joint peace support mission in…

June 24, 2025

FACT CHECK: Did lawmakers skip the national anthem during Tinubu’s Democracy Day speech?

A viral X post claims that Nigeria’s new national anthem was not recited during the…

June 13, 2025

FACT CHECK: Did a military coup oust Paul Biya as Cameroon’s president?

Reports of a military coup in Cameroon ousting President Paul Biya have gone viral on…

June 13, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Rárá, Pope Leo kò bẹ Tinubu kó tú Nnamdi Kanu sílẹ̀ ní àtìmọ́lé

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé ibaraẹnisọrẹ orí ayélujára sọ pé Robert Francis Prevost, Pope Leo XIV…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 10, 2025

Ḿbà, Pope Leo áyọghị Tinubu kà ọ́ tọ́pụ̀ Nnamdi Kanu nà ǹgá

Ótù onye na Facebook ekwuola na Pope Leo na ụfọdụ ndị Bishop yọrọ onye isiala Bola Tinubu ka ọ tọpụ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 10, 2025

No, Pope Leo no beg Tinubu to release Nnamdi Kanu

One Facebook user claim sey Pope Leo XVI and oda bishops join mouth beg President Bola Tinubu to release Nnamdi…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 10, 2025

A’a, Paparoma Leo bai nemi Tinubu ya saki Nnamdi Kanu ba

Wani mai amfani da Facebook ya yi ikirarin cewa Paparoma Leo na 16 da wasu limaman coci sun roki shugaban…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 10, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?