TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Na true sey TB Joshua wife promise Peter Obi 8 million votes?
Share
Latest News
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?
Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?
Shin Najeriya ta dakatar da ‘yarjejeniyar ma’adinai’ da Amurka bayan hana biza?
FACT CHECK: Did Nigeria halt ‘mineral deal’ with US after visa restrictions?
FACT CHECK: Viral image depicting ‘Obasanjo prostrating for Ladoja’ photoshopped
Wike tụ̀rụ̀ àsị́. Peter Obi mèrè ńtụ̀líáká ọ̀chị́chị́ ḿpághárá m̀gbè ọ́ bụ̀ gọ́vánọ̀ Anambra
Irọ́ ni Wike pa. Peter Obi ṣètò ìdìbò ìjọba ìbílẹ̀ nígbà tí ó jẹ́ gómìnà Ìpínlẹ̀ Anambra
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Na true sey TB Joshua wife promise Peter Obi 8 million votes?

Claire Mom
By Claire Mom Published August 4, 2022 4 Min Read
Share

Some posts wey dey evriwhere for social media claim sey wife of di late TB Joshua promise Peter Obi, presidential candidate of di Labour Party (LP), eight million votes.

For one Youtube video wey News Express Nigeria TV post on July 17, dem tok sey Evelyn Joshua, wife of di late prophet, don stand gidigba wit Obi as election dey come for 2023.

Di video get “2023 Presidency: Evelyn TB Joshua don promise Peter Obi 8 million votes” as di headline and more dan 530 pipu don watch am. 

Some oda Facebook pages folo cari di tori.

For Nolly Roll, one Facebook page wey get more dan 3 million followers, di post get pass 10,000 likes, 1,300 comments and 724 shares.

We notice sey na di same tin most of di Facebook pages wey share di post write.  Dem join di post wit picture of di late pastor, or im wife. Some pages even join di two pictures.

“I go give Peter Obi 8 million votes from my church. Normally, I no dey support any politician, but Peter Obi no be ordinary candidate. Na pesin wey go change Nigeria,” na so all di Facebook pages write.

Di post folo reach Twitter.

Wetin we check

TheCable try folo di Synagogue Church of All Nations (SCOAN) tok, to check weda Evelyn Joshua tok dat kain tin.

But dem no ansa any of our calls, later dia number no come dey go.

We come search dia ogbonge social media pages see sey, on July 15, dem release message for dia Facebook and Instagram.

Pipu bin claim sey Evelyn Joshua tok sey God tell her one candidate like dat go win di 2023 elections, na why dem release di message.

“We don notice sey plenti socia media posts claim sey pastor Evelyn Joshua tok sey God tell her one candidate like dat go win di 2023 Nigerian elections. Abeg, no be true, pastor Evelyn Joshua no tok anytin like dat. If you wan hear any true tori from SCOAN, na from Emmanuel TV or any of our confam social media pages,” na so di post tok.

As we check dia Facebook, we see sey dem bin post di same tin on June 20, but dem no tok anytin about di 8million votes for Obi.

TheCable come folo Julius Abure, national chairman of di Labour Party, tok.

Im tok sey, “plenti pipu dey support Obi for dia own way and we no get any wahala wit am.” Im sey “Change dey really hungry Nigerians.”

About di “8 million votes wey di church promise” as pipu claim, im sey “di synangogue church never folo Peter Obi or di parti tok in any way.”

Final tok

Di claim wey tok sey Evelyn Joshua promise di presidential candidate 8million votes no be true.

 

TAGGED: Labour Party, peter obi, SCOAN, TB JOshua

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom August 4, 2022 August 4, 2022
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?

Ótù onye nà Facebook ekwuola na Naijiria emegwarụla mgbachibido visa nke mba US site n'ịkwụsị…

July 18, 2025

Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára ti sọ pé…

July 18, 2025

Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?

One Facebook user claim sey Nigeria revenge against di recent United States visa restriction by…

July 18, 2025

Shin Najeriya ta dakatar da ‘yarjejeniyar ma’adinai’ da Amurka bayan hana biza?

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa Najeriya ta mayar da martani…

July 18, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?

Ótù onye nà Facebook ekwuola na Naijiria emegwarụla mgbachibido visa nke mba US site n'ịkwụsị nkwekọrịta azụmahịa akụ ọnatarachi dị…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára ti sọ pé orílẹ̀ èdè Nàìjíríà hùwà sí…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?

One Facebook user claim sey Nigeria revenge against di recent United States visa restriction by stopping one alleged mineral deal…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

Shin Najeriya ta dakatar da ‘yarjejeniyar ma’adinai’ da Amurka bayan hana biza?

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa Najeriya ta mayar da martani ne kan takunkumin da Amurka…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 18, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?