TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Na true sey South Africa election bin no record any kasala as Obi tok?
Share
Latest News
Finnish court no release Simon Ekpa, give am $50,000 compensation
Ilé ẹjọ́ ní Finland kò dá ẹjọ́ pé kí wọ́n tú Simon Ekpa sílẹ̀ ní ẹ̀wọ̀n, wọn kò sì fún un ní àádọ́ta ẹgbẹ̀rún dọ́là owó gbàmábínú
Ụ́lọ́ị́kpé Finland átọ́pụ́ghị́ Simon Ekpa nà ńgà, máọ́bụ́ kwụ́ghàchị́ yá ụ́gwọ́ $50,000
Kotun Finnish ba ta saki Simon Ekpa ba, ta ba shi diyyar dala 50,000
FACT CHECK: Finnish court didn’t free Simon Ekpa, award him $50,000 compensation
Ńgághárị́wé méré ńké Napel kà é bị́pụ́tárá dị́kà ọ́gbákọ́ ndị̀ ná-áchọ́ ńtọ́pụ̀ Nnamdi Kanu na-ngà
Fídíò ẹ̀hónú ní Nepal ni àwọn ènìyàn ń pín, tí wọ́n ní Nàìjíríà ló ti ṣẹlẹ̀ kí ìjọba lè tú Nnamdi Kanu sílẹ̀
Old Nepal protest video comot for internet as Abuja protest for Nnamdi Kanu release
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Na true sey South Africa election bin no record any kasala as Obi tok?

Claire Mom
By Claire Mom Published June 19, 2024 4 Min Read
Share

Peter Obi, presidential candidate of di Labour Party (LP) in 2023, tok sey South Africa recent election bin no get any kasala.

Obi make di claim as im bin dey compare di elections for Nigeria with South Africa.

“Di outcome of di recent South African election result na shining example of wetin transparent and efficient democratic electoral process suppose resemble,” na so di former Anambra govnor tweet.

“With about 60% voter turnout, over 90% of early polling, diaspora voting, di results and updates bin dey enta as e dey hapun without any form of kasala during di election.

“Dis tin show sey dia system stand gidigba. Di smooth online dissemination of results cement dia commitment to democratic principles and technological advancement.”

South Africa national and provincial elections bin hapun on May 29. Later dat same evening, results begin enta small small with di final result announcement on June 2.

Di elections bin gada global attention sake of how di ruling African National Congress (ANC) lose di majority of seats wey dem need to win di kontri parliament. Na so di party do by force coalition.

Na di first time ANC, wey don dey power since di end of apartheid in 1994, go fail to secure majority of di votes.

President Cyril Ramaphosa accept wetin hapun, say na di the people’s wish.

Di way Ramaphosa take accept di outcome without wahala make pipu inside and outside kontri troway am salute, including Obi.

But how many tins dey correct inside Obi observations?

CLAIM 1: SOUTH AFRICA ELECTIONS BIN NO GET KASALA

Verdict: E no correct.

One of di claims wey Obi make be sey technical glitches bin no hapun during di election.

Di tok no correct.

In di early hours of May 31, di results page of di kontri Electoral Commission (IEC) seize for about two hours.

Di IEC apologize for di glitch but dem no tok why e off. Dem assure citizens sey dem no tamper with di results.

Di development no sidan well with di uMkhonto we Sizwe (MK) party wey former President Jacob Zuma dey support. Dem accuse di IEC of “serious transgressions”.

Zuma claim sey di MK party get “proof” sey vote-rigging bin allegedly hapun “for di background” when di IEC dashboard crash, dey threaten sey im supporters go provoke if dem no arrange di results.

CLAIM 2: ‘60% VOTER TURNOUT, DIASPORA VOTING’

Verdict: E near correct.

Obi claim sey di elections bin get 60 percent voter turnout.

According to di South African Government News Agency, voter turnout bin tanda at 58.57 percent.

Di turnout fall from di 66.05 percent wey comot for di 2019 national elections.

Howeva, di claim wey Obi make about diaspora voting bin dey correct.

Di IEC don dey permitted to organise out-of-kontri voting since 2009 and dem use di same process for last month election.

Citizens wey wan vote outside di kontri must dey registered to vote and must produce South African identity document (ID) wen dem dey vote for international voting station inside accredited mission.

FINAL TOK

Di claims wey Obi make sey South African elections bin no record one kasala bin mostly no correct. Di elections bin get kasala and di voter turnout bin dey less dan 60 percent. Howeva, dem bin do diaspora voting.

TAGGED: claim, hitch-free election, peter obi, South Africa election

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom June 19, 2024 June 19, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Finnish court no release Simon Ekpa, give am $50,000 compensation

Some social media users don claim sey one Finnish court give judgment make dem release…

October 23, 2025

Ilé ẹjọ́ ní Finland kò dá ẹjọ́ pé kí wọ́n tú Simon Ekpa sílẹ̀ ní ẹ̀wọ̀n, wọn kò sì fún un ní àádọ́ta ẹgbẹ̀rún dọ́là owó gbàmábínú

Àwọn ènìyàn kan tí wọ́n ń lo àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára sọ pé…

October 23, 2025

Ụ́lọ́ị́kpé Finland átọ́pụ́ghị́ Simon Ekpa nà ńgà, máọ́bụ́ kwụ́ghàchị́ yá ụ́gwọ́ $50,000

Ụfọdụ ndị na soshal midia ekwuola na ụlọikpe dị na Finland nyere ịwụ ka-tọghapul Simon,…

October 23, 2025

Kotun Finnish ba ta saki Simon Ekpa ba, ta ba shi diyyar dala 50,000

Wasu masu amfani da shafukan sada zumunta sun yi ikirarin cewa wata kotu a Finland…

October 23, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Finnish court no release Simon Ekpa, give am $50,000 compensation

Some social media users don claim sey one Finnish court give judgment make dem release Simon Ekpa, pro-Biafra agitator, wey…

CHECK AM FOR WAZOBIA
October 23, 2025

Ilé ẹjọ́ ní Finland kò dá ẹjọ́ pé kí wọ́n tú Simon Ekpa sílẹ̀ ní ẹ̀wọ̀n, wọn kò sì fún un ní àádọ́ta ẹgbẹ̀rún dọ́là owó gbàmábínú

Àwọn ènìyàn kan tí wọ́n ń lo àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára sọ pé ilé ẹjọ́ kan ní orílẹ̀…

CHECK AM FOR WAZOBIA
October 23, 2025

Ụ́lọ́ị́kpé Finland átọ́pụ́ghị́ Simon Ekpa nà ńgà, máọ́bụ́ kwụ́ghàchị́ yá ụ́gwọ́ $50,000

Ụfọdụ ndị na soshal midia ekwuola na ụlọikpe dị na Finland nyere ịwụ ka-tọghapul Simon, Ekpa, onye ndú otu nwere…

CHECK AM FOR WAZOBIA
October 23, 2025

Kotun Finnish ba ta saki Simon Ekpa ba, ta ba shi diyyar dala 50,000

Wasu masu amfani da shafukan sada zumunta sun yi ikirarin cewa wata kotu a Finland ta yanke hukuncin sakin Simon…

CHECK AM FOR WAZOBIA
October 23, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?