TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Na true sey South Africa election bin no record any kasala as Obi tok?
Share
Latest News
Kò sí ọ̀rọ̀ tó seé gbàgbọ́ nípa ọ̀rọ̀ tó sọ pé Amẹ́ríkà kọlu Burkina Faso pẹ̀lú ohun ìjà olóró
No evidence sey US strike Burkina Faso with missiles
Babu wata hujjar Amurka ta jefa makamai masu linzami Burkina Faso
Ò nwéghị íhé ákáébe gósị́rị́ nà US tụ̀rụ̀ Burkina Faso bọ́mbụ̀
FACT CHECK: No evidence US struck Burkina Faso with missiles
FRSC sị̀ nà íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ọ́rụ́ ha nà ónyé ọ̀kwà ụ́gbọ́àlà nà-ènwé ńsògbụ́ mèrè n’áfọ̀ 2020
FRSC sọ pé 2020 ni ìjà láàárín àwọn òṣìṣẹ́ àwọn àti onikẹkẹ maruwa tí áwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ ṣẹlẹ̀
Viral video wey show kasala between keke rider and our officers na from 2020, na so FRSC tok
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Na true sey South Africa election bin no record any kasala as Obi tok?

Claire Mom
By Claire Mom Published June 19, 2024 4 Min Read
Share

Peter Obi, presidential candidate of di Labour Party (LP) in 2023, tok sey South Africa recent election bin no get any kasala.

Obi make di claim as im bin dey compare di elections for Nigeria with South Africa.

“Di outcome of di recent South African election result na shining example of wetin transparent and efficient democratic electoral process suppose resemble,” na so di former Anambra govnor tweet.

“With about 60% voter turnout, over 90% of early polling, diaspora voting, di results and updates bin dey enta as e dey hapun without any form of kasala during di election.

“Dis tin show sey dia system stand gidigba. Di smooth online dissemination of results cement dia commitment to democratic principles and technological advancement.”

South Africa national and provincial elections bin hapun on May 29. Later dat same evening, results begin enta small small with di final result announcement on June 2.

Di elections bin gada global attention sake of how di ruling African National Congress (ANC) lose di majority of seats wey dem need to win di kontri parliament. Na so di party do by force coalition.

Na di first time ANC, wey don dey power since di end of apartheid in 1994, go fail to secure majority of di votes.

President Cyril Ramaphosa accept wetin hapun, say na di the people’s wish.

Di way Ramaphosa take accept di outcome without wahala make pipu inside and outside kontri troway am salute, including Obi.

But how many tins dey correct inside Obi observations?

CLAIM 1: SOUTH AFRICA ELECTIONS BIN NO GET KASALA

Verdict: E no correct.

One of di claims wey Obi make be sey technical glitches bin no hapun during di election.

Di tok no correct.

In di early hours of May 31, di results page of di kontri Electoral Commission (IEC) seize for about two hours.

Di IEC apologize for di glitch but dem no tok why e off. Dem assure citizens sey dem no tamper with di results.

Di development no sidan well with di uMkhonto we Sizwe (MK) party wey former President Jacob Zuma dey support. Dem accuse di IEC of “serious transgressions”.

Zuma claim sey di MK party get “proof” sey vote-rigging bin allegedly hapun “for di background” when di IEC dashboard crash, dey threaten sey im supporters go provoke if dem no arrange di results.

CLAIM 2: ‘60% VOTER TURNOUT, DIASPORA VOTING’

Verdict: E near correct.

Obi claim sey di elections bin get 60 percent voter turnout.

According to di South African Government News Agency, voter turnout bin tanda at 58.57 percent.

Di turnout fall from di 66.05 percent wey comot for di 2019 national elections.

Howeva, di claim wey Obi make about diaspora voting bin dey correct.

Di IEC don dey permitted to organise out-of-kontri voting since 2009 and dem use di same process for last month election.

Citizens wey wan vote outside di kontri must dey registered to vote and must produce South African identity document (ID) wen dem dey vote for international voting station inside accredited mission.

FINAL TOK

Di claims wey Obi make sey South African elections bin no record one kasala bin mostly no correct. Di elections bin get kasala and di voter turnout bin dey less dan 60 percent. Howeva, dem bin do diaspora voting.

TAGGED: claim, hitch-free election, peter obi, South Africa election

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom June 19, 2024 June 19, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Kò sí ọ̀rọ̀ tó seé gbàgbọ́ nípa ọ̀rọ̀ tó sọ pé Amẹ́ríkà kọlu Burkina Faso pẹ̀lú ohun ìjà olóró

Ẹnì kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ orí ayélujára tí sọ pé…

August 28, 2025

No evidence sey US strike Burkina Faso with missiles

One social media user don claim sey United States missiles hit Burkina Faso, causing Ibrahim…

August 28, 2025

Babu wata hujjar Amurka ta jefa makamai masu linzami Burkina Faso

Wani mai amfani da shafukan sada zumunta ya yi ikirarin cewa makamai masu linzami da…

August 28, 2025

Ò nwéghị íhé ákáébe gósị́rị́ nà US tụ̀rụ̀ Burkina Faso bọ́mbụ̀

Ótù onye na soshal midia ekwuola na a tụrụ ngwa agha US n'obodo Burkina Faso…

August 28, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Kò sí ọ̀rọ̀ tó seé gbàgbọ́ nípa ọ̀rọ̀ tó sọ pé Amẹ́ríkà kọlu Burkina Faso pẹ̀lú ohun ìjà olóró

Ẹnì kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ orí ayélujára tí sọ pé orílẹ̀ èdè Amẹ́ríkà ti kọlu…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 28, 2025

No evidence sey US strike Burkina Faso with missiles

One social media user don claim sey United States missiles hit Burkina Faso, causing Ibrahim Traoré, army presido, to revenge.…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 28, 2025

Babu wata hujjar Amurka ta jefa makamai masu linzami Burkina Faso

Wani mai amfani da shafukan sada zumunta ya yi ikirarin cewa makamai masu linzami da Amurka ta harba a Burkina…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 28, 2025

Ò nwéghị íhé ákáébe gósị́rị́ nà US tụ̀rụ̀ Burkina Faso bọ́mbụ̀

Ótù onye na soshal midia ekwuola na a tụrụ ngwa agha US n'obodo Burkina Faso nke mere ka onye ndu…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 28, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?