TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Na true sey police arrest Naira Marley and Sam Larry sake of Mohbad?
Share
Latest News
Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́
Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true
Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà
Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne
FACT CHECK: Kemi Badenoch’s claim that her children can’t get Nigerian citizenship is false
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?
Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Na true sey police arrest Naira Marley and Sam Larry sake of Mohbad?

Claire Mom
By Claire Mom Published September 20, 2023 4 Min Read
Share

E neva tey wey one post for social media claim sey police arrest Naira Marley, di popular musician, and Samson Balogun aka Sam Larry, music promoter, sake of Mohbad as im kpai.

“Dem don arrest Naira Marley and Sam Larry!! Dem go question dem ontop di viral videos wey sey dem abuse Mohbad, di musician wey don die,” na so di post wey @Mrklassiq_ make tok.

As e be so, di post don gada 3.3M views, 30.4K likes and 2,622 reposts ontop X – former Twitter.

Apart from X, di same type of claim comot for Facebook, where dem tok sey police arrest Naira Marley and Sam Larry.

MOHBAD

Mohbad na former musician under Marlian Records, wey Naira Marley get. Mohbad bin kpai on September 12 at di age of 27 and dem bury am di next day. 

Di tins wey make di musician die don dey cause kasala for social media and even among Nigerians wey di tin consign togeda wit music fans.

On October 5 2022, di late singer bin cari mata come X sey Marlian Records “beat” am.

“Just because I wan change my manager wey be dia broda, see wetin dem do me for Marlian House,” na so im bin tweet wit one video  wey show as different marks wit blood dey im bodi.

Im still come ask for help inside di tweet, sey “I dey die inside”.

Some pipu bin tok sey Marlian Records bin make sure sey di singer see pepper  togeda with beating for different times till im die.

Meanwhile, one petition wey Mohbad bin submit to di Force Criminal Investigation Department (FCID) Annex, Alagbon for Lagos on June 27 2023 don comot for internet. Mohbad bin report sey dem bin dey allegedly threaten im life, malicious damage, assault, togeda with oppression from Sam Larry. 

As Sam Larry don deactivate im Instagram account tey tey as plenty pipu attack am afta Mohbad kpai, Naira Marley still dey lose followers for social media as im fans no too dey happy wit am again.

DEM NEVA ARREST NAIRA MARLEY AND SAM LARRY 

TheCable check see sey di police neva arrest either Naira Marley or Sam Larry for questioning sake of Mohbad death.

“Di report no correct; na lie; we neva arrest anybody,” na so Oluniyi Ogundeyi, spokesperson for di Lagos annex of di FCID, tok.

Meanwhile, TheCable bin report sey di Nigerian police don begin investigations into di singer death wey e still neva sure wetin kill am.

On Monday, September 18, 2023, di Lagos state govment set up one 13-man panel to look into di mata and dem conclude sey dem go dig im dead body comot go check for hospital if e dey necessary.

FINAL TOK

Di claim wey sey Naija police don arrest Naira Marley and Sam Larry no correct. Dem still dey investigate di mata and dem neva arrest anybody so far.

TAGGED: Marlian Records, Mohbad, Naira Marley, Pidgin factcheck, Pidgin news, Sam Larry, TheCable pidgin

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom September 20, 2023 September 20, 2023
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị…

July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass…

July 22, 2025

Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà

Kemi Badenoch, arábìnrin tó jẹ́ olórí ẹgbẹ́ òsèlú alátakò tí wọ́n ń pè ní Conservative…

July 22, 2025

Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne

Kemi Badenoch, shugabar jam'iyyar masu ra'ayin rikau ta Burtaniya, ta yi ikirarin cewa ba za…

July 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị enyenwu ụmụ ya ikike ịbụ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass her right of Nigerian citizenship…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà

Kemi Badenoch, arábìnrin tó jẹ́ olórí ẹgbẹ́ òsèlú alátakò tí wọ́n ń pè ní Conservative Party ní orílẹ̀ èdè United…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne

Kemi Badenoch, shugabar jam'iyyar masu ra'ayin rikau ta Burtaniya, ta yi ikirarin cewa ba za ta iya mika hakkinta na…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?