TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Na true sey Netflix comot all Toyin Abraham film sake of alleged power abuse?
Share
Latest News
FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated
MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army
Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́
Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true
Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà
Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne
FACT CHECK: Kemi Badenoch’s claim that her children can’t get Nigerian citizenship is false
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Na true sey Netflix comot all Toyin Abraham film sake of alleged power abuse?

Claire Mom
By Claire Mom Published July 17, 2024 3 Min Read
Share

Some social media posts claim sey Netflix don comot all di film produced by Toyin Abraham, di Nollywood actress, from dia platform.

On July 10, @KadunaResident, one X user, claim sey di streaming platform don comot all di film wey Abraham dey inside.

“BREAKING: I hear sey Netflix don delete all Toyin Abraham film today? Comrades, abeg lower your weapon. Na person mama,” na so di user write.

So far, di post don gada pass 636,000 views, 4,200 likes, and 808 reposts for X.

Dem also share di post here and here.

WETIN HAPUN BEFORE

Abraham na one of plenti celebrities wey don face quarrel for social media ontop sey she support President Bola Tinubu during di 2023 presidential elections.

Recently, dem drop accusation ontop di filmmaker head sey she cari police go arrest one social media influencer wey im name na Big Ayo and im mama sake of sey dem cari her name put for poto poto.

Ayo bin allege sey Abraham collect moni from Tinubu cari her husband Kolawole Ajeyemi go hospital make dem put hair ontop im bald head.

“Mrs @toyin_abraham1 walai aiye e ti ta! You collect Tinubu money use do hair transplant for your husband. Stoppid fool,” na so di post wey im don delete now bin tok.

For Instagram live session on Wednesday, di actress denied di claim, sey she no tell police make dem arrest Ayo mama but instead she report di case to di cybercrime unit.

Abraham tok sey she no go take any insult wey dem give her children and she vow sey she go take action against critics wey dey bully her for social media.

Howeva, her tok vex plenti Nigerian X users, as some begin dey write letter give streaming platforms like Netflix and Prime Video sey make dem comot her movies sake of alleged “abuse of power”.

One user bin share copy of im letter to Netflix and im urge others to do di same. Some threaten sey dem go report Abraham social media accounts if police no release Big Ayo.

WETIN WE CHECK

To comfam di social media claim, TheCable search Netflix to check weda di movies wey Abraham produced still dey di platform.

Di search find sey films wey get di actress, including ‘Ijakumo’, ‘Malaika’, ‘Prophetess’, ‘Elevator Baby’, and several more, still dey available for Netflix streaming.

Screenshot of Abraham’s movies streaming on Netflix
Screenshot of Abraham’s movies streaming on Netflix

FINAL TOK

Netflix neva comot Abraham films from dia platform.

TAGGED: Fact check in pidgin, Netflix, News in pidgin, Toyin Abraham

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom July 17, 2024 July 17, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated

A video showing a bridge collapse incident is circulating across social media platforms, especially on…

July 24, 2025

MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army

The Nigerian Army says a viral video claiming the arrest of a foreign arms dealer…

July 24, 2025

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị…

July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass…

July 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị enyenwu ụmụ ya ikike ịbụ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass her right of Nigerian citizenship…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà

Kemi Badenoch, arábìnrin tó jẹ́ olórí ẹgbẹ́ òsèlú alátakò tí wọ́n ń pè ní Conservative Party ní orílẹ̀ èdè United…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne

Kemi Badenoch, shugabar jam'iyyar masu ra'ayin rikau ta Burtaniya, ta yi ikirarin cewa ba za ta iya mika hakkinta na…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?