TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Na true sey Nasarawa never boro moni since Tinubu enta office?
Share
Latest News
FACT CHECK: Video showing gunmen seizing armoured vehicle from Burkina Faso — NOT Nigeria
Viral post wey claim sey dem don pass ‘Cybercrimes Act 2025’ no correct
Ózí na-ekwu nà é mepụ̀tálá ìwú megidere cybercrime bụ̀ àsị́
Irọ́ ni fídíò tó sọ pé Nàìjíríà ti sọ ‘Cybercrimes Act, 2025’ di òfin
Hoton hoto hoto ko bidiyo mai zagaya yanar gizo da sauri akan hanyar ”Dokar Laifukan gizo 2025′ karya ce
Fídíò Tinubu níbi tí ó ti ń rọ́ kẹ̀kẹ̀ mọ̀ àwọn ọmọ Nàìjíríà nítorí pé wọ́n pe ọ̀rọ̀ rẹ̀ ní AI kìí se òótọ́
Bidiyon Tinubu na barazana ga mutanen dake kirar maganar a matsayin AI, hadawa akayi
Video wey Tinubu dey threaten citizens wey call im statements AI na fake
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Na true sey Nasarawa never boro moni since Tinubu enta office?

Claire Mom
By Claire Mom Published December 10, 2024 3 Min Read
Share

Abdullahi Sule, di govnor of Nasarawa, tok sey di state no take any loan since President Bola Tinubu enta office.

Sule make dis claim during town hall meeting wey Channels TV organise sake of di tax reform bills mata.

“I hear as pesin tok sey since President Tinubu enta office, govnors don dey get beta revenue, and dem wan sabi wetin di govnors dey do wit di revenues,” na so di govnor tok.

“Go di different states; you go tok wetin di govnors dey do wit di revenue.

“For Nasarawa state, I neva boro moni since President Tinubu enta office, but today, I fit boast of di 10,000 hectares of land wey I use for agriculture, all di equipment I don buy for agriculture, all di payments we don make… I fit dey tok dey go.”

WETIN WE CHECK

Tinubu enta office February and officially dey sworn in on May 29, 2023.

To confam Sule claim, TheCable check di domestic and external debt records of sub-nationals from di Debt Management Office (DMO) covering di time from di start of Tinubu administration to di present.

DOMESTIC DEBT 

In June 2023, one month afta Tinubu enta office, di DMO show Nasarawa domestic debt as N71.11 billion.

Nasarawa’s domestic debt as of June 2023

By June 2024, dis nomba drop go N23.94 billion.

Nasarawa’s domestic debt as of June 2024

Dis show 66 percent reduction for di state domestic debt since di president enta office.

EXTERNAL DEBT 

Review of Nasarawa external debt informate from DMO show sey e tanda at $52.33 million in June 2023.

Nasarawa’s external debt as of June 2023

By June 2024, e increase small to $52.36 million.

Nasarawa’s external debt as of June 2024

Dis show growth of less dan one percent since Tinubu enta office.

FINAL TOK

Di claim wey Sule make sey im administration neva boro since Tinubu enta office dey largely correct, according to available data from the DMO.

TAGGED: Abdullahi Sule, Nasarawa, News in pidgin

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom December 10, 2024 December 10, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: Video showing gunmen seizing armoured vehicle from Burkina Faso — NOT Nigeria

A video depicting some gunmen taking over armoured vehicles has been attributed to an incident…

September 1, 2025

Viral post wey claim sey dem don pass ‘Cybercrimes Act 2025’ no correct

One post for social media platforms claim sey di national assembly don pass di “Cybercrimes…

August 30, 2025

Ózí na-ekwu nà é mepụ̀tálá ìwú megidere cybercrime bụ̀ àsị́

Ózí a hụtara na soshal midia kwuru na ụlọ ọme iwu Naijiria emeputala iwu megidere…

August 30, 2025

Irọ́ ni fídíò tó sọ pé Nàìjíríà ti sọ ‘Cybercrimes Act, 2025’ di òfin

Ọ̀rọ̀ kan lori àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára sọ pé ilé ìgbìmọ̀ asòfin àgbà…

August 30, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Viral post wey claim sey dem don pass ‘Cybercrimes Act 2025’ no correct

One post for social media platforms claim sey di national assembly don pass di “Cybercrimes Act 2025” into law. Dem…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 30, 2025

Ózí na-ekwu nà é mepụ̀tálá ìwú megidere cybercrime bụ̀ àsị́

Ózí a hụtara na soshal midia kwuru na ụlọ ọme iwu Naijiria emeputala iwu megidere "mpụ e ji ịntanetị eme…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 30, 2025

Irọ́ ni fídíò tó sọ pé Nàìjíríà ti sọ ‘Cybercrimes Act, 2025’ di òfin

Ọ̀rọ̀ kan lori àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára sọ pé ilé ìgbìmọ̀ asòfin àgbà ní orílẹ̀ èdè Nàìjíríà ti…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 30, 2025

Hoton hoto hoto ko bidiyo mai zagaya yanar gizo da sauri akan hanyar ”Dokar Laifukan gizo 2025′ karya ce

Wani rubutu da aka buga a dandalin sada zumunta ya yi iƙirarin cewa majalisar dokokin ƙasar ta amince da dokar…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 30, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?