TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Na true sey lion dey born wen rain dey fall and sun dey shine?
Share
Latest News
Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́
Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar
Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́
Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu
FACT CHECK: Viral photos of Nigerian Christians bearing arms in churches are misleading
Da’awar cewa Davido da Chioma suna tsammanin ɗansu na uku karya ne
Òótọ́ kọ́ ni ọ̀rọ̀ tó sọ pé Davido àti Chioma ń gbaradì fún ọmọ wọn kẹta
Evidence no dey sey Davido and Chioma dey expect dia third pikin
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Na true sey lion dey born wen rain dey fall and sun dey shine?

Claire Mom
By Claire Mom Published May 6, 2023 5 Min Read
Share

One old Naija tori claim sey lion dey born anytime wey rain dey fall and sun comot.

No bi for onli Naija dem dey tok di tin, oda kontris get di one wey dem dey believe. 

For Albania, wen rain fall and sun comot, dem go tok sey Romani wedding dey hapun somewhere. For some oda places, dem sey either devil dey marry, or e dey beat im wife. 

For Hawaii, dem sey di tin dey hapun because hole dey for heaven. In fact, dem dey call am pukalani for Hawaii, meaning sey hole dey sky. 

For Estonia, dem dey describe di tin as “orphan tears”, sey di sun bi di grandmother wey dey dry di tears. Pipu for Maldives sey dat kain rain dey fall wen big pesin wey no dey belive in dia God kpai. Some belive sey di tin dey bring good luck.

WETIN BE DI DIFFERENCE BETWEEN SHOWER AND RAIN?

For many kontris wey dem dey speak English, dem dey call di strange weather “sun showers”. E dey strange because before rain fall, sky suppose black wit cloud so dat sun no go fit shine.

Showers dey come from cumulus clouds because of wetin dem dey call convection, and dem no dey tey. Also, dem dey no dey too heavy, na why e dey fall for small place.

Rain gan gan dey come from stratus clouds wey bi di main weather system. Rain, no bi like showers, e dey usually heavy and e dey fall wella.  

HOW SCIENCE TAKE EXPLAIN SUN SHOWERS

Sun showers dey hapun anytime wey cloud break, na dat time sun go come see small space shine. Dem dey also hapun wen one heavy wind fit just blow small water from where rain dey fall cari am go anoda area wey cloud no dey. Na why e dey be like sey sun dey shine. 

Most of di time, di showers dey hapun wen weda no too dey stable, especially during spring and summer, wen di sun angle dey allow am shine under cloud.

Sun showers dey common wen di sun dey low ontop horizon, maybe around middle of afternoon or middle of morning, or wen rain showers dey move east. E dey hard for dem to move wen di sun dey fully shine.

Scientists explain sey anytime wey weather no too stable, di temperature difference for some places di make air tanda for some places, and fall for anoda area. 

For di places wey air dey tanda, wetin dey hapun bi sey di air go come coolele come get small water inside am, naim make cloud go come form and den showers go fall. For di places wey air dey fall, e go come blow di cloud comot so dat sky go clear. Na dat time sun fit shine and den maybe showers go fall. 

Di same temperature wey dey change for different places wey dey make sun showers dey fall, naim dey make wey rainbow dey comot, as long as sey dey sun no dey too shine.

In some oda cases, sun shower dey hapun wen one single rain shower cloud dey pass and di angle wey di sun dey take shine dey no dey cover im light from di cloud. Sometimes, wen rain comot for cloud, sun light still fit pass di cloud even as rain di fall, but dis one no too common.

FINAL TOK

E no get any science tok wey claim sey sun shower dey hapun wen animal dey born. Di tori get different meaning for different cultures and kontris for di world. 


This content was produced with support from the Independent Media Response Fund, an initiative of the Check Global Program at Meedan to respond to global challenges through hyperlocal initiatives. The fund is supported by the Swedish International Development Cooperation Agency (Sida). 

TAGGED: Fact check pidgin, Pidgin news, Sun showers, why does rain fall when sun is shining?

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom May 6, 2023 May 6, 2023
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke…

December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church…

December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní…

December 4, 2025

Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu

Afta bandits attack worshippers Christ Apostolic Church (CAC) branch for Oke Isegun inside di Eruku…

December 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke Isegun n'obodo Eruku nke Kwara…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church (CAC) a reshen cocin Christ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní ẹ̀ka Christ Apostolic Church (CAC)…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu

Afta bandits attack worshippers Christ Apostolic Church (CAC) branch for Oke Isegun inside di Eruku community for Kwara state on…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?