TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Na true sey CBN don introduce N5000 and N2000 notes?
Share
Latest News
FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated
MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army
Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́
Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true
Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà
Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne
FACT CHECK: Kemi Badenoch’s claim that her children can’t get Nigerian citizenship is false
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Na true sey CBN don introduce N5000 and N2000 notes?

Claire Mom
By Claire Mom Published November 19, 2022 5 Min Read
Share

One video wey dey show N5,000 and N2,000 notes don dey evriwhere for internet.

For di video wey dem share for Twitter on October 27, one woman bin dey show bundles of N5,000 and N2,000 notes.

I hope this is a joke . pic.twitter.com/p8GM6YS1pA

— Dr Penking™🇳🇬🇦🇺 (@drpenking) October 27, 2022

Di woman claim sey na one “mad man” bin deposit di moni for di bank branch wey she dey work.

“I hope sey na joke be dis,” na so dem write on top di video. E get more dan 33k views, 1,028 likes and 367 retweets.

Dem folo share di video for Instagram and plenti accounts for Facebook, where plenti Nigerians wey no know wetin dey hapun shock.

On October 26, Godwin Emefiele, govnor of di Central Bank of Nigeria (CBN), bin tok sey di bank go change di design of some naira notes.

Emefiele tok di new design, wey go dey ontop N200, N500 and N1000 go comot around middle of December 2022. 

Di CBN govnor bin tok sey dem bin dey change di naira design because of some challenges wey dey affect di way di kontri dey manage currency. Im tok sey if to sey dem no change di design, yawa for gas for di CBN and di whole kontri.

WETIN WE CHECK

TheCable cari di video check for Invid, one internet tool wey dey check di koko for any video, to check wetin dey inside. Keyframe analysis of di video show sey e don dey Facebook and YouTube since 2020. 

As we check di video well, we see sey one side of wetin dem claim sey na N5000 note get di foto of one man wey dey wear cap, and for di oda notes, na foto of three women side by side. 

Keyword search for Google show sey di CBN bin announce in August 2012 sey dem go introduce N5,000 notes

Sanusi Lamido, di CBN govnor dat time, bin sey na di faces of three ogbonge Nigerian female activists go dey ontop di new notes. Im sey na Margaret Ekpo, late politician and social mobiliser; Hajia Gambo Sawaba, late politician and activist, and Funmilayo Kuti, late politician and women’s rights activist.

Lamido explain sey di N5000 note go improve di quality of banknotes, go get beta feature for pipu wey dey blind, and reduce di cost of production, distribution and disposal of banknotes.

But plenti pipu no gree for di mata. The Institute of Chartered Accountants of Nigeria (ICAN) tok sey if di N5000 note comot, naira go weak pass as e dey.

Na so di Nigerian government come suspend di introduction of di N5000 note. Dem sey make di “CBN go gather more informate for di mata.”

Also, di CBN ontop dia Twitter handle on May 31, 2020, tell Nigerians sey make dem no cari believe di fake pictures and videos wey dey internet dat time. 

“All di videos and pictures of N2,000:00 and N5,000:00 banknotes no correct. Make di members of di public no believe wetin dem dey see and make dem report anybodi wey get di notes to law enforcement agencies,” na so di CBN tweet.

Videos and pictures of purported circulation of N2,000:00 and N5,000:00 banknotes are false and fake. Members of the public are advised to disregard such falsehood and to report anyone found in possession of such banknotes to the law enforcement agencies

— Central Bank of Nigeria (@cenbank) May 31, 2020

Pipu dey share di old video for social media because dia bodi dey shake ontop di new naira notes wey CBN tok say go comot around middle of December 2022.

 

Meanwhile, di CBN bin sey na N200, N500, and N1000, dem go redesign. Di bank no tok anyting about N2000 or N5000 notes.  

FINAL TOK

Di video wey dey evriwhere for internet wey dey claim sey federal govment dey introduce N2,000 and N5,000 notes no correct. Di misleading video don dey internet since 2020.

TAGGED: Fact check pidgin

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom December 13, 2023 November 19, 2022
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated

A video showing a bridge collapse incident is circulating across social media platforms, especially on…

July 24, 2025

MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army

The Nigerian Army says a viral video claiming the arrest of a foreign arms dealer…

July 24, 2025

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị…

July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass…

July 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị enyenwu ụmụ ya ikike ịbụ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass her right of Nigerian citizenship…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà

Kemi Badenoch, arábìnrin tó jẹ́ olórí ẹgbẹ́ òsèlú alátakò tí wọ́n ń pè ní Conservative Party ní orílẹ̀ èdè United…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne

Kemi Badenoch, shugabar jam'iyyar masu ra'ayin rikau ta Burtaniya, ta yi ikirarin cewa ba za ta iya mika hakkinta na…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?