TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Na true say Obasanjo support Peter Obi, tok say na ‘man wey pure’?
Share
Latest News
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal
No, Nigeria no send peace support mission go Israel
A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba
Ǹjẹ́ Tinubu àti Alexander Zingman lọ sí ilé-ìwé kan náà? Èyí ni ohun tí a mọ̀
Tinubu nà Alexander Zingman ọ̀ gàrà ótù ụ́lọ̀ákwụ́kwọ́? Lèé íhé ányị́ mà
Tinubu go di same school wit Alexander Zingman? Na wetin we sabi be dis
Shin Tinubu ya halarci makaranta daya da Alexander Zingman? Ga abin da muka sani
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Na true say Obasanjo support Peter Obi, tok say na ‘man wey pure’?

Claire Mom
By Claire Mom Published June 20, 2022 2 Min Read
Share

For June 14, one Twitter account wey get di name of former president Olusegun Obasanjo, tok say Peter Obi, di presidential candidate for Labour Party, na pesin wey pure.

Di Twitter account wey dey always post tori about di former president bin get 5000 followers wen di Obi tweet comot. Now, di account don almost get 10,000 followers.

Di post wey get Obasanjo and Obi picture tok say, “Peter Obi no be saint, but among politicians for Nigeria today, na man wey pure.”

Di tweet don get pass 33,000 likes, 8,000 retweets and 900 comments.

Some pipo for social media wey dey look di post believe say na Obasanjo post am. Dem tok say na better tin im do.

Festus Agene, wey follow dem join body, tok say, “na beta approval from Baba Obj be dis.”

Dave Saint sef tok say, “to dey pure na  somtin wey today politicians no get, but PO [Peter Obi] get am full ground. Bad belle pipu, wey dey carry bad politicians give Nigerians to vote for 2023, sake of say dem wan chop, God no go gree. Thanks, Olusegun Obasanjo for di kind words to PO.”

A good validation from Baba OBJ…I am OBIdient https://t.co/fHyFboX4GG

— Primus1 (@firsty1_) June 16, 2022

https://twitter.com/DaveZaint/status/1537346351062732800?s=20&t=tIuJwznYCqlMmnsONYjnWA

He is not a saint but among politicians in Nigeria today, Peter Obi is a bundle of integrity. pic.twitter.com/M3THSJWqS2

— Olusegun Aremu Obasanjo (@Oolusegun_obj) June 15, 2022

Wetin we check

Internet search show say no beta media house carry di tori wey di former president tok dat kain tin.

Wen TheCable contact Kehinde Akinyemi, wey dey do tok tok for Obasanjo, im tok say no be true, say di former president no tok dat kain tin.

He con add join say Obasanjo no get Twitter account, say im no even get any social media account sef.

 

Final tok

Di social media post wey tok say Obasanjo give Peter Obi hand of support no be true. Na fake account post am.

 

Dis tori comot in partnership wit Report for the World, global service program wey dey support local public interest journalism.

 

 

TAGGED: Elections2023, Obasanjo, peter obi

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom June 20, 2022 June 20, 2022
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí…

June 28, 2025

Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal

Ótù ihe ngosị si na Facebook kwuru na Naijiria zipụrụ ndị agha ka ha gaa…

June 28, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission.…

June 28, 2025

A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba

Wani faifan bidiyo na Facebook ya nuna cewa Najeriya ta tura dakaru domin aikin hadin…

June 28, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró

Ìròyìn lati inú fídíò Facebook kan sọ pé Nàìjíríà fi àwọn ọmọ ogun ránṣẹ́ sí orílẹ̀ èdè Ísírẹ́lì kí rògbòdìyàn…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

Ḿbà, Naijiria ézipụ̀ghị̀ ńdị́ ágha ńkwàdó ùdó nà òbòdò Isreal

Ótù ihe ngosị si na Facebook kwuru na Naijiria zipụrụ ndị agha ka ha gaa kwàdó udo na mba Isreal.…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

No, Nigeria no send peace support mission go Israel

One Facebook video claim sey Nigeria send soldiers go Israel for joint peace support mission. One male broadcaster wey dey…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

A’a, Najeriya ba ta tura tawagar taimakon zaman lafiya zuwa Isra’ila ba

Wani faifan bidiyo na Facebook ya nuna cewa Najeriya ta tura dakaru domin aikin hadin gwiwa na tallafawa zaman lafiya…

CHECK AM FOR WAZOBIA
June 28, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?