TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Na geoengineering dey cause climate change?
Share
Latest News
No, Emefiele no return N4trn to FG
Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà
Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn
A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba
FACT CHECK: No, Emefiele didn’t return N4trn to FG
FAKE NEWS ALERT: Akume hasn’t been replaced as SGF, says presidency
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Slurs, smears, slander… how gendered disinformation targets high-profile Nigerian women
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Na geoengineering dey cause climate change?

Claire Mom
By Claire Mom Published April 11, 2023 7 Min Read
Share

One social media post claim sey na geoengineering dey cause climate change. Di post still claim sey di smoke wey dey comot from aeroplane wen e dey fly dey change weather wey go come cause climate change.

“I no know who suppose hear dis tin but #ClimateChange na #Geoengineering,” na so di post tok.

Di message for di post bin originally comot for Twitter on December 16, 2021. 

Later, di same pesin wey write di message share di post for Instagram on February 17, where more dan 900 pipu like am.

I don't know who need to hear this but #ClimateChange is actually #Geoengineering & those trails you see in the sky aren't water vapor, they're #StratosphericInjections aka #Chemtrails & you can look up the countless patents & protocols for #WeatherModification yourself. Wake up.

— the nomad soul ☥ (@krysticmystic) December 16, 2021

NA GREENHOUSE EMISSIONS DEY CAUSE CLIMATE CHANGE 

Di tins wey dey cause climate change na actitvities wey human beings dey do, mostly di tins wey dey make carbon dioxide (CO2) and oda greenhouse gases comot wen dem burn fossil fuel coal and oil. 

Fossil fuel na material wey dey originally comot from under ground like coal, oil, and natural gas. Plenti pipu dey comot di materials come burn am as fuel. 

Di two main tins wey dey increase CO2 for air na wen pipu dey burn fossil and anytime wen dem cut tree. Na di tin wey folo cause global warming.

Scientists don explain sey 30 percent of di sunlight wey dey reach earth dey  bounce back to space, while 70 percent dey enta di climate energy system. 

As di earth dey bounce back some of di heat wey e don collect go back space, greenhouse gases for di air like water vapour, carbon dioxide, methane and nitrous oxides go come help trap di heat, through one process wey dem dey call di greenhouse effect. 

With di help of greenhouse gases, di planet go come dey warm for living tins. But, some of these gases don too plenti for air and e dey make di world hot pass di way e suppose dey. 

Some activities wey human beings dey do for big industries don follow increase di amount of greenhouse gases wey dey air, which mean sey heat and global warming don increase.

Na because sey heat don too much for di world naim make wey rain no dey fall for some places,  heavy flooding, and some kain weather effects wey dey destroy tins.

DI TIN WEY JOIN CLIMATE CHANGE AND GEOENGINEERING

Climatologists (pipu wey dey study weather) don claim sey di best wey to slow down climate change na to reduce di greenhouse gases wey dey air and one of di best ways na for pipu to begin dey use clean energy sources like nuclear energy, solar, wind, and hydro.

Because of di slow waka wey pipu dey make to use clean energy, and di poor rate of reducing di gases, some kontris for di world dey consider how dem go use  technology help di climate kasala. These kain help go touch somtin for di atmosphere wey go reduce di effects of climate change.

Geoengineering na big process wey dey change climate wit technology. E dey dvided into carbon geoengineering and solar geoengineering.

Carbon geoengineering dey designed to comot carbon dioxide from di atmosphere, while solar geoengineering dey try change di amount of energy wey dey comot from sun wey di atmosphere go absorb come later release. Di name of di process wey solar geoengineering dey try do na cloud brightening.

Gloria Okafor, postdoctoral research scientist, at di Nigerian Maritime University for Delta state, Nigeria, tell TheCable sey geoengineering na climate intervention “wey dem still dey study wella”. 

“Dem still dey develop am, and dem neva finish to sabi all di tins wey consign am including di negative effects” na so di university lecturer tok. 

“E no correct to sey geoengineering, wey dey try reduce di greenhouse gases for air and di effect of climate change, dey cause climate change.” 

DI ‘SMOKE’ WEY DEY COMOT FROM AEROPLANE GET WATER INSIDE, DEM NO DEY CHANGE CLIMATE

Di social media post also claim sey di white line wey dey comot from aeroplane na “stratospheric injections” wey suppose change di climate. 

“Those white lines wey you dey see for sky no be water, dem bi #StratosphericInjections aka #Chemtrails & you fit check di plenty materials wey dey tok about #WeatherModification. Wake up.”

E get some kain claims for internet without scientific proof, wey tok sey di white lines for sky wey dey comot from jet na chemtrails.

Some of di pipu wey dey loud these claims folo tok sey di white lines contain poison, wey govment spray on purpose so dat dem fit control population.

As science pipu dey call am contrails, di long white lines dey comot wen water vapour and some fine particules of soot from burning jet fuels freeze into ice crystals for up inside sky.

According to climatologists, no proof dey to show sey di white lines wey dey comot from aeroplanes dey change di the weather in any way. 

FINAL TOK

Di two claims no correct.  

Experts tok sey sense no dey for di claim wey sey na geoengineering dey cause climate change. Also, no proof dey to show sey chemtrails dey change weather, in fact, dem no dey strong enough to affect weather or any climate condition.


This content was produced with support from the Independent Media Response Fund, an initiative of the Check Global Program at Meedan to respond to global challenges through hyperlocal initiatives. The fund is supported by the Swedish International Development Cooperation Agency (Sida). 

TAGGED: chemtrails, Climate Change, climate claims, Fact check pidin, geoengineering, global warming, pidgin English

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom April 11, 2023 April 11, 2023
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin…

July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára,…

July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru…

July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook…

July 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin Emefiele, di forma govnor of…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára, tí ó ṣe àfihàn ẹni…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru na Godwin Emefiele, onye bụbu…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook yana ikirarin Godwin Emefiele, tsohon…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?