TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Masturbation dey make hair comot for man head?
Share
Latest News
FACT CHECK: Video wey show sey gunmen bin seize armoured vehicles na for Burkina Faso — NO BE Nigeria
FACT CHECK: Video showing people using ropes to cross river NOT from Nigeria
Burkina Faso ni ìṣẹ̀lẹ̀ nínú fídíò tó sàfihàn àwọn agbébọn pẹ̀lú ọkọ̀ ogun jíjà ti ṣẹlẹ̀ — kìí se Nàìjíríà
Íhé ńgósị́ ébé ndị́ ómékómè nà-éwèghárá ụ́gbọ́àlà ndị́ ághá sì Burkina Faso
Bidiyon da ke nuna yan ta’adda na kwace motoci masu sulke daga Burkina Faso – BA Najeriya ba
FACT CHECK: Video showing gunmen seizing armoured vehicle from Burkina Faso — NOT Nigeria
Viral post wey claim sey dem don pass ‘Cybercrimes Act 2025’ no correct
Ózí na-ekwu nà é mepụ̀tálá ìwú megidere cybercrime bụ̀ àsị́
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Masturbation dey make hair comot for man head?

Claire Mom
By Claire Mom Published September 5, 2022 5 Min Read
Share

One post for social media claim sey masturbation na one of di main tins wey dey make hair comot  for man head.

Eric @amerix, di pesin wey first post am for Twitter, claim sey na frequent ejaculation dey shift all di hair wey dey man head go back.

“One of di main reasons why men hair dey comot na because of masturbation. Frequent ejaculation dey make all di vitamins wey dey make hair grow comot for body.  If you see any man wey im hair dey shift go back, remind am make im try dey hold imsef,” na so di tweet tok.

One of the primary causes of hair loss is MASTURBATION.

Indiscriminate ejaculation leads to the intentional loss of vital nutrients responsible for hair growth.

Every time you meet a man with a receding hairline, remind him about semen retention.#BetterTogether

— Eric (@amerix) August 23, 2022

Di post get more dan 1, 400 retweets and 8, 800 likes.

For Facebook, different accounts share di post plenti times. One example na Emem Nelson wey claim sey im bi doctor. More dan 8, 000 pipu dey follow am.

Jay Ade, anoda user for Facebook, repost di claim ontop Medriod Elite City, one public group for Facebook wey get over 9, 000 followers.

WETIN WE CHECK

Di Merriam-Webster dictionary define masturbation as di action wey pesin dey touch imsef especially around di private part till most times wey im reach oragsm.

According to di explanation wey di dictionary give, no bi only to touch body be masturbation, sometimes e fit be wen pesin dey think sexual tins or wen anoday pesin dey touch your body without sex.

TheCable come folo some medical experts tok, to confam weda anytin for science dey support if masturbation or frequent ejaculation dey make men hair comot.

Best Ordinioha, professor of public health and community medicine, tok sey di claim no get head, sey notin dey join masturbation with hair loss for medicine.

Im sey di pesin wey make di post for Twitter just dey find pipu wey go folo am tok.

“E be like di pesin just dey post tins wey go make pipu fear. Dis kain tins go dey make pipu dey look men wey their hair dey comot anyhow. Wen pipu see dem, e go be like na wetin dem dey always do be dat,” na so di professor of medicine tok.

“For health science, na increased testosterone dey make hair shift go back, testosterone na di hormone for man body. But as I tok before, nothing for science show sey frequent ejaculation dey cause baldness.”

“Pipu wey get high testosterone body go wan dey have sex evritime but e get some kain tins wey dey reduce am: stress fit make man no fit give woman belle, and sex no go dey im mind again. E be like di pesin wey post dat tin overstretch am.”

SOME TINS WEY DEY MAKE MEN HAIR COMOT

Francis Agbaraolorunpo, medical expert for di University of Lagos, sey some tins like, how your family genetics dey, medical conditions and too much use of chemicals fit cause make hair comot for man head, but masturbation no folo join.

“One of di main tins wey dey cause hair loss na genetics, meaning sey dem fit born you like dat. Anoda tin fit be sey di pesin get am from im parents,” na so im tok.

“Some pipu hair fit fall comot if dem get alopecia or anoda serious medical condition like cancer. For dat kain case, even woman fit get hair loss

“If you see man wey im hair shift go back, most of di times, dat gene dey im family, e fit be sey na gene wey bin no dey show before, but e fit come comot for di pesin body wem im dey expose to some kain conditions for im enviroment.”

However, di medical expert tok am again sey masturbation no di cause hair loss or di way man dey look, im sey dat one na psychological issue.

Im come tok sey sometimes wen pesin no too dey confident, im fit dey masturbate, sey e fit cause “infertility issues”.

“Any man wey dey masturbate wella fit get low sperm count wen im wan jam woman.”

FINAL TOK

Di claim wey sey masturbation na one of di main tins wey dey cause men hair dey comot no correct. According to science, notin jam masturbation wit hair for head.

 

 

TAGGED: genetics, hair loss, masturbation

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom September 5, 2022 September 5, 2022
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: Video wey show sey gunmen bin seize armoured vehicles na for Burkina Faso — NO BE Nigeria

Some pesin for social media don dey put Naija name on top one video wey…

September 3, 2025

FACT CHECK: Video showing people using ropes to cross river NOT from Nigeria

On August 9, a Facebook user identified as Asare Obed posted a video showing people…

September 3, 2025

Burkina Faso ni ìṣẹ̀lẹ̀ nínú fídíò tó sàfihàn àwọn agbébọn pẹ̀lú ọkọ̀ ogun jíjà ti ṣẹlẹ̀ — kìí se Nàìjíríà

Àwọn ènìyàn kan tí wọ́n ń lo ohun íbaraẹnise orí ayélujára tí sọ pé fidio…

September 2, 2025

Íhé ńgósị́ ébé ndị́ ómékómè nà-éwèghárá ụ́gbọ́àlà ndị́ ághá sì Burkina Faso

Ótù ihe ngosi ebe ndị ojiegbe egbu na-ákụ̀rụ́ ụgbọala ndị agha bụ nke ndị ji…

September 2, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

FACT CHECK: Video wey show sey gunmen bin seize armoured vehicles na for Burkina Faso — NO BE Nigeria

Some pesin for social media don dey put Naija name on top one video wey show some men wey mount…

CHECK AM FOR WAZOBIA
September 3, 2025

Burkina Faso ni ìṣẹ̀lẹ̀ nínú fídíò tó sàfihàn àwọn agbébọn pẹ̀lú ọkọ̀ ogun jíjà ti ṣẹlẹ̀ — kìí se Nàìjíríà

Àwọn ènìyàn kan tí wọ́n ń lo ohun íbaraẹnise orí ayélujára tí sọ pé fidio kan tí ó sàfihàn àwọn…

CHECK AM FOR WAZOBIA
September 2, 2025

Íhé ńgósị́ ébé ndị́ ómékómè nà-éwèghárá ụ́gbọ́àlà ndị́ ághá sì Burkina Faso

Ótù ihe ngosi ebe ndị ojiegbe egbu na-ákụ̀rụ́ ụgbọala ndị agha bụ nke ndị ji soshal midia ebipụta ozi sịrị…

CHECK AM FOR WAZOBIA
September 2, 2025

Bidiyon da ke nuna yan ta’adda na kwace motoci masu sulke daga Burkina Faso – BA Najeriya ba

Wani faifan bidiyo da ke nuna yadda wasu ‘yan bindiga ke karbar motocin sulke na da alaka da wani lamari…

CHECK AM FOR WAZOBIA
September 2, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?