TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Kola Abiola tok sey security council neva hold meeting since 1999. Na true?
Share
Latest News
Da’awar cewa Davido da Chioma suna tsammanin ɗansu na uku karya ne
Òótọ́ kọ́ ni ọ̀rọ̀ tó sọ pé Davido àti Chioma ń gbaradì fún ọmọ wọn kẹta
Evidence no dey sey Davido and Chioma dey expect dia third pikin
FACT CHECK: Viral photos of Chioma with baby bump is from 2023
AI ni wọ́n fi se fídíò tó sàfihàn pé àwọn ISWAP yin ìbọn fún ọ̀gá àwọn òṣìṣẹ́ ológun kan
Video wey show as ISWAP shoot army general na AI
Bidiyon da ke nuna harbin Janar na soji da ISWAP aka yi shi ne AI
DISINFO ALERT: Video showing shooting of army general by ISWAP is AI-generated
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Kola Abiola tok sey security council neva hold meeting since 1999. Na true?

Claire Mom
By Claire Mom Published November 18, 2022 5 Min Read
Share

Kola Abiola, presidential candidate of di Peoples Redemption Party (PRP), claim sey di National Security Council (NSC) neva sidan for meeting since 1999. 

Abiola make dis claim for di presidential town hall meeting wey Arise Television wit di Centre for Democracy and Development (CDD) organise for Abuja. 

Im bi one of di four presidential candidates wey folo attend di town hall meeting wey hapun on Sunday.

Peter Obi, presidential candidate of di Labour Party (LP), Rabiu Kwankwaso, presidential candidate of di New Nigeria Peoples Party (NNPP) and Ifeanyi Okowa, vice-presidential candidate of di Peoples Democratic Party (PDP) wey tanda for Atiku Abubakar, di party presidential candidate, folo attend. 

Na so all of dem tok wetin dem go do for di security and economy of di kontri if dem become presido. 

Reuben Abati, di pesin wey dey handle di program come ask dem wetin dem for do, if to sey dem be commander-in-chief, wen bandits bin attack di Kaduna-Abuja train in March 2022. 

To answer di question, na so Abiola tok sey di national security council neva hold meeting since 1999. 

“That painful attack na just one of di plenti security wahala wey we don dey face for many years. Na one of di problems wey show sey bigger kasala dey. We suppose go back go check our security and di way we organise our defence,” na so Abiola tok.

“As time dey go, dem tok sey dem wan check am to see wetin no dey well and how dem fit make am beta but na di main problem be dat? I no sure but since 1999, di national security council neva do meeting for one day and na di pipu wey dey control di security for Nigeria be dat. Dem neva do meeting since 1999.”

WETIN WE CHECK

TheCable cari eye look Section 153, subsection 25 of di 1999 constitution wey get all di officials wey dey inside di NSC.

According to di section: “Di national security council suppose get “(a) di President wey go bi di chairman;  (b) the vice-president wey go bi di deputy chairman;  (c) di chief of defence staff;  (d) di minister of di govment of di federation wey go dey look di internal affairs.  (e) di minister of di govment of di federation wey go dey in charge of defence;  (f) di minister of di govment of di federation wey go dey look foreign affairs;  (g) di national security adviser  (h) di inspector-general of police; and  (i) any oda pesin wey di president feel sey fit do di work”

Subsection 26 come explain sey di council suppose advise di president on any mata wey consign public security “including ontop mata inside any agency wey di law create so dat security go tight for di kontri.”

TheCable bin report sey on October 14, President Muhammadu Buhari bin organise meeting of di national security council for di presidential villa in Abuja.

Di tori bin tok sey noted Yemi Osinbajo, vice-president, Boss Mustapha, secretary to di government of di federation (SGF), Babagana Monguno, national security adviser (NSA), and Ibrahim Gambari, chief of staff to di president, bin folo dey for di meeting.

Oda ministers wey bin folo attend di meeting na Bashir Magashi, minister of defence, Rauf Aregbesola, minister of interior, and Maigari Dingyadi, di minister of police affairs. All di service chiefs and ogas of oda security agencies bin folo attend.

Even on October 31, 2022, one tori bin comot wey sey di presido bin organise one emergency security council meeting.

Dem bin hold di meeting to see how dem fit make di security for di kontri beta.

FINAL TOK

Di claim wey Abiola tok sey NSC neva do meeting since 1999 no correct. Even on October 31, 2022, di presido bin organise meeting wit di council.

 

 

 

 

 

 

 

TAGGED: Fact check pidgin

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom November 18, 2022 November 18, 2022
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Da’awar cewa Davido da Chioma suna tsammanin ɗansu na uku karya ne

Wani rubutu ya yi ikirarin cewa tauraron Afrobeats Davido da matarsa, Chioma Adeleke, na kara…

November 28, 2025

Òótọ́ kọ́ ni ọ̀rọ̀ tó sọ pé Davido àti Chioma ń gbaradì fún ọmọ wọn kẹta

Ọ̀rọ̀ kan sọ pé Davido, gbajúmọ̀ akọrin àti Chioma Adeleke, ìyàwó rẹ̀ ń gbaradì fún…

November 28, 2025

Evidence no dey sey Davido and Chioma dey expect dia third pikin

One post claim sey Afrobeats star Davido and im wife, Chioma Adeleke, dey expect anoda…

November 28, 2025
Davido and Chioma Adeleke

FACT CHECK: Viral photos of Chioma with baby bump is from 2023

A post claims that Afrobeats star Davido and his wife, Chioma Adeleke, are expecting another…

November 24, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Da’awar cewa Davido da Chioma suna tsammanin ɗansu na uku karya ne

Wani rubutu ya yi ikirarin cewa tauraron Afrobeats Davido da matarsa, Chioma Adeleke, na kara samun haihuwa. Wani mai amfani…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 28, 2025

Òótọ́ kọ́ ni ọ̀rọ̀ tó sọ pé Davido àti Chioma ń gbaradì fún ọmọ wọn kẹta

Ọ̀rọ̀ kan sọ pé Davido, gbajúmọ̀ akọrin àti Chioma Adeleke, ìyàwó rẹ̀ ń gbaradì fún ọmọ wọn tuntun, èyí tí…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 28, 2025

Evidence no dey sey Davido and Chioma dey expect dia third pikin

One post claim sey Afrobeats star Davido and im wife, Chioma Adeleke, dey expect anoda pikin.  Joshua Ijeakhena, one social…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 28, 2025

AI ni wọ́n fi se fídíò tó sàfihàn pé àwọn ISWAP yin ìbọn fún ọ̀gá àwọn òṣìṣẹ́ ológun kan

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ń pín kiri ti sàfihàn ìgbà tí àwọn ènìyàn kan pa Musa Uba, ọ̀gá àwọn…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 20, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?