TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true
Share
Latest News
Seven ways to detect an AI-generated video
BLIND SPOT: Nigeria’s shortcomings in the age of AI scams
The rise of deepfakes and the fight for digital truth
DISINFO ALERT: Health ministry debunks AI video claiming free nationwide diabetes treatment
Video wey show as ‘security operatives’ dey break into apartment no be from south-east
Íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ǹché nà-ákpáká ụ́lọ̀ ésiteghị nà south-east
Ìṣẹ̀lẹ tí àwọn ‘òṣìṣẹ́ elétò ààbò’ fẹ́ fipá wọ ibùgbé kan kò ṣẹlẹ̀ ní gúúsù ilà oòrùn Nàìjíríà
Bidiyon da ake dangantawa da ‘jami’an tsaro’ da suka kutsa cikin gida ba daga kudu maso gabas ba ne
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Claire Mom
By Claire Mom Published July 22, 2025 6 Min Read
Share

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass her right of Nigerian citizenship give her children sake of her gender.

Badenoch make di on Sunday for interview with CNN Fareed Zakaria, as she dey try tok di difference between di immigration policies of Nigeria and Britain.

As she dey try prove her point, she claim sey e dey easy for Nigerians to get British citizenship than for foreigners to become Nigerian.

“E nearly dey impossible, for example, to get Nigerian citizenship. 
I get that citizenship sake of my parents, I no fit give am to my children because I be woman,” na so she tok.

“Yet plenti Nigerians dey come UK stay for relatively free period of time, get British citizenship. We no suppose dey do like mumu.”

Di claim wey Badenoch make cause plenty reactions from Nigerians, as dem dey criticise her sake of weda truth dey wetin she tok.

Nigerian Yoruba parents born Olukemi Adegoke for UK. Dem later cari her go Nigeria, where she spend much of her childhood before she go back UK at age 16.

Before she return to di UK, she bin do her basic education for private school inside Lagos, Nigeria, without need for student visa sake of sey she be Nigerian citizen.

Student visa (R7A) na type of visa wey dem dey give international students wey dey study for Nigeria. Nigerian citizens no be international students and dem no require student visa to study for di kontri.

She later married Hamish Badenoch, one Scottish banker, come collect im surname, become Kemi Badenoch.

Di couple get three children.

WETIN WE CHECK

CableCheck compare di claim wey Badenoch make wit di Nigerian Constitution.

According to section 25(1)(c) of di 1999 Constitution, pesin wey dem born outside Nigeria na citizen of Nigeria if any of dia parents na Nigerian citizen.

Dis mean sey only one Nigerian parent dey okay to become citizenship by birth. For Badenoch case, her children na automatic Nigerian citizens.

Citizenship by birth for Nigeria na wen pesin automatically become Nigerian citizenship immediately dem born am, sake of di citizenship status of one of dia parents or grandparents, instead of di place wey dem born am.

Di status dey grant di holder all di rights of citizenship, including di right to enter Nigeria freely and enjoy constitutional protections.

Nigerian law dey also allow pesin get two citizenship, but with specific conditions.

Section 28(1) tok sey person wey be Nigerian citizen by birth fit get anoda kontri citizenship without losing dia Nigerian citizenship.

However, pesin wey no be Nigerian citizen by birth but through registration or naturalisation must abandon dia Nigerian citizenship if dem collect anoda kontri citizenship.

In addition, di law no tok sey privileges of citizenship by birth dey entitled to one gender.

Gender dey become important only for cases wey involve foreign spouses.

Section 26(2)(a) of di Nigerian Constitution tok sey, “any woman wey dey married to or marry citizen of Nigeria before” fit become citizen too.

Foreign men wey marry Nigerian women no dey automatically eligible for citizenship by registration under dis law; dem fit qualify by naturalisation, wey get stricter requirements.

Therefore, e go dey difficult for Badenoch’s Scottish husband to automatically collect citizenship. Howeva, di tin no affect dia children, wey get Nigerian mama and Nigerian grandparents.

ASHLEIGH PLUMPTRE: CASE OF MIXED HERITAGE AND CITIZENSHIP

Ashleigh Plumptre, 27, na professional British-Nigerian footballer.

Plumptre dey play as centre-back for Al-Ittihad, one Saudi Premier League club, and di Super Falcons, di Nigerian women national team.

Tim Plumptre, her papa, na Nigerian from Lagos, while her mama na English woman.

Ahead of di 2022 Women’s Africa Cup of Nations (WAFCON), Plumptre decide to represent Nigeria, her paternal heritage, instead of England wey she bin dey play for before.

For interview dis month, Tim tok sey im consciously raise im dota wit understanding of her heritage as im bin dey carry her go visit Harry Dotun Plumptre, her grandpapa, and many of her extended Nigerian family as possible.

Plumptre dey among di 24 Nigerian players wey dey currently compete for di 2025 WAFCON.

FINAL TOK

Badenoch claim wey tok sey she not fit pass her Nigerian citizenship give her children no correct. E for dey correct if she don revoke her citizenship.

TAGGED: citizenship by birth, Kemi Badenoch, News in pidgin, Nigerian citizenship

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom July 22, 2025 July 22, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

Seven ways to detect an AI-generated video

A video announcing the launch of a free nationwide diabetes treatment recently went viral across Nigerian…

August 13, 2025

BLIND SPOT: Nigeria’s shortcomings in the age of AI scams

It sounded exactly like her, but it was not. Adeola Fayehun was thousands of miles…

August 12, 2025

The rise of deepfakes and the fight for digital truth

BY PRUDENCE OKEOGHENE EMUDIANUGHE On May 30, 2025, a 49-minute video surfaced on a YouTube…

August 12, 2025

DISINFO ALERT: Health ministry debunks AI video claiming free nationwide diabetes treatment

The ministry of health and social welfare has dismissed a viral claim alleging the launch…

August 12, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Video wey show as ‘security operatives’ dey break into apartment no be from south-east

One Facebook user don claim sey video wey show as hooded armed security operatives dey break into residential apartment hapun…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

Íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ǹché nà-ákpáká ụ́lọ̀ ésiteghị nà south-east

Ótù onye na Facebook ekwuola na ihe ngosị ebe mmadụ na-agbaka ụlọ obibi mmadụ mere na south-east. N'ụbọchị iri abụọ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

Ìṣẹ̀lẹ tí àwọn ‘òṣìṣẹ́ elétò ààbò’ fẹ́ fipá wọ ibùgbé kan kò ṣẹlẹ̀ ní gúúsù ilà oòrùn Nàìjíríà

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára sọ pé fídíò tí ó se afihan àwọn…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

Bidiyon da ake dangantawa da ‘jami’an tsaro’ da suka kutsa cikin gida ba daga kudu maso gabas ba ne

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa wani faifan bidiyo da ke nuna jami’an tsaro dauke da…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?