TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Finnish court no release Simon Ekpa, give am $50,000 compensation
Share
Latest News
Ilé ẹjọ́ ní Finland kò dá ẹjọ́ pé kí wọ́n tú Simon Ekpa sílẹ̀ ní ẹ̀wọ̀n, wọn kò sì fún un ní àádọ́ta ẹgbẹ̀rún dọ́là owó gbàmábínú
Ụ́lọ́ị́kpé Finland átọ́pụ́ghị́ Simon Ekpa nà ńgà, máọ́bụ́ kwụ́ghàchị́ yá ụ́gwọ́ $50,000
Kotun Finnish ba ta saki Simon Ekpa ba, ta ba shi diyyar dala 50,000
FACT CHECK: Finnish court didn’t free Simon Ekpa, award him $50,000 compensation
Ńgághárị́wé méré ńké Napel kà é bị́pụ́tárá dị́kà ọ́gbákọ́ ndị̀ ná-áchọ́ ńtọ́pụ̀ Nnamdi Kanu na-ngà
Fídíò ẹ̀hónú ní Nepal ni àwọn ènìyàn ń pín, tí wọ́n ní Nàìjíríà ló ti ṣẹlẹ̀ kí ìjọba lè tú Nnamdi Kanu sílẹ̀
Old Nepal protest video comot for internet as Abuja protest for Nnamdi Kanu release
An sake yin amfani da faifan bidiyo na zanga-zangar tayanar gizo yayin da Abuja ke gangamin neman a saki Nnamdi Kanu
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Finnish court no release Simon Ekpa, give am $50,000 compensation

Claire Mom
By Claire Mom Published October 23, 2025 4 Min Read
Share

Some social media users don claim sey one Finnish court give judgment make dem release Simon Ekpa, pro-Biafra agitator, wey don already collect prison sentence.

Plenti social media users bin post di claim for Facebook and Instagram — for wetin resemble copy-and-paste news post trend.

Di post also claim sey di Finnish court give Ekpa $50,000 compensation afta di Nigerian govment allegedly no show court.

Dem join di quote wit judge wey no get name for di post.

“Di Finnish court don officially release Biafran activist Simon Ekpa afta di Nigerian govment no gree appear for court to prove dia allegations against am,” na so di viral post tok.

“According to di court ruling, Ekpa detention bin dey “unlawful and politically motivated,” naim dem give am $50,000 as compensation for di illegal imprisonment.

“Afta im give im final tok, di judge reportedly tok sey:

“Simon Ekpa na free man under Finnish law. Im get evri right to express im views and defend di interests of im people, as long as im dey operate within legal boundaries.”

“Shortly afta dem release am, Simon Ekpa tok sey:

“Dem try silence me, but you no fit put truth for prison. Dis victory no be only my own-e belong to di people of Biafra and everybodi wey dey fight for justice.”

One Facebook page, also known as “I News,” wey get over 167,000 followers, folo publish di claim.

CableCheck notice sey some of di social media users and pages wey post di claim na people wey dey loyal to di separatist leader.

Dem publish di claim here, here, and here.

WETIN HAPUN BEFORE

On September 1, di Päijät-Häme district court for Finland sentence Ekpa to six years in prison for terrorism offences.

Di three-member panel of judges bin find Ekpa guilty of causing terrorism and participating in di activities of terrorist group.

Di court tok sey Ekpa bin use im “significant social media following” to cause tension for Nigeria south-east region between August 2021 and November 2024.

Di court also convict Ekpa of aggravated tax fraud and violating di provisions of di attorneys’ act.

According to di law for Finland, Ekpa get 30 days to file appeal against di district court judgment. That is, di pro-Biafra agitator must file im appeal on or before October 1, 2025.

CableCheck no fit confam weda Ekpa don file appeal, as im lawyer, Kaarle Gummerus, neva respond to our request for informate about di mata.

WETIN WE CHECK

CableCheck search different Finnish media platforms to check weda another court don allegedly release Ekpa as di viral post claim.

No beta media platform report di alleged release.

Since one district court convict am on September 1, no report don comot on weda any appeal court for Finland dey hear di mata as of October 22.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey one Finnish court don allegedly release Ekpa no correct.

TAGGED: Finland, Finnish court, News in pidgin, Simon Ekpa

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom October 23, 2025 October 23, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

Ilé ẹjọ́ ní Finland kò dá ẹjọ́ pé kí wọ́n tú Simon Ekpa sílẹ̀ ní ẹ̀wọ̀n, wọn kò sì fún un ní àádọ́ta ẹgbẹ̀rún dọ́là owó gbàmábínú

Àwọn ènìyàn kan tí wọ́n ń lo àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára sọ pé…

October 23, 2025

Ụ́lọ́ị́kpé Finland átọ́pụ́ghị́ Simon Ekpa nà ńgà, máọ́bụ́ kwụ́ghàchị́ yá ụ́gwọ́ $50,000

Ụfọdụ ndị na soshal midia ekwuola na ụlọikpe dị na Finland nyere ịwụ ka-tọghapul Simon,…

October 23, 2025

Kotun Finnish ba ta saki Simon Ekpa ba, ta ba shi diyyar dala 50,000

Wasu masu amfani da shafukan sada zumunta sun yi ikirarin cewa wata kotu a Finland…

October 23, 2025

FACT CHECK: Finnish court didn’t free Simon Ekpa, award him $50,000 compensation

Some social media users claim that a Finnish court has ruled that Simon Ekpa, a…

October 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ilé ẹjọ́ ní Finland kò dá ẹjọ́ pé kí wọ́n tú Simon Ekpa sílẹ̀ ní ẹ̀wọ̀n, wọn kò sì fún un ní àádọ́ta ẹgbẹ̀rún dọ́là owó gbàmábínú

Àwọn ènìyàn kan tí wọ́n ń lo àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára sọ pé ilé ẹjọ́ kan ní orílẹ̀…

CHECK AM FOR WAZOBIA
October 23, 2025

Ụ́lọ́ị́kpé Finland átọ́pụ́ghị́ Simon Ekpa nà ńgà, máọ́bụ́ kwụ́ghàchị́ yá ụ́gwọ́ $50,000

Ụfọdụ ndị na soshal midia ekwuola na ụlọikpe dị na Finland nyere ịwụ ka-tọghapul Simon, Ekpa, onye ndú otu nwere…

CHECK AM FOR WAZOBIA
October 23, 2025

Kotun Finnish ba ta saki Simon Ekpa ba, ta ba shi diyyar dala 50,000

Wasu masu amfani da shafukan sada zumunta sun yi ikirarin cewa wata kotu a Finland ta yanke hukuncin sakin Simon…

CHECK AM FOR WAZOBIA
October 23, 2025

FACT CHECK: Finnish court didn’t free Simon Ekpa, award him $50,000 compensation

Some social media users claim that a Finnish court has ruled that Simon Ekpa, a pro-Biafra agitator, who was recently…

Fact Check
October 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?