TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: FAKE TORI ALERT: I no tell Fubara say make im declare state of emergency for Rivers, says Obasanjo
Share
Latest News
FRSC sị̀ nà íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ọ́rụ́ ha nà ónyé ọ̀kwà ụ́gbọ́àlà nà-ènwé ńsògbụ́ mèrè n’áfọ̀ 2020
FRSC sọ pé 2020 ni ìjà láàárín àwọn òṣìṣẹ́ àwọn àti onikẹkẹ maruwa tí áwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ ṣẹlẹ̀
Viral video wey show kasala between keke rider and our officers na from 2020, na so FRSC tok
Bidiyon bidiyo na arangama tsakanin direban babur, jami’an mu daga 2020, in ji FRSC
È nwélá ọ́nwụ́ ńdị́ ụ́kà nà Naijiria n’áfọ̀ 2025 kárị́á ọ́nụ́ ọ́gụ́gụ́ ndị́ Palestinian é gbụ́rụ́ na Gaza?
Na true sey dem kill Christians for Nigeria dis year pass Palestinians for Gaza?
Ǹjẹ́ àwọn ẹlẹ́sìn ìgbàgbọ́ tí wọ́n pa ní Nàìjíríà ju àwọn ọmọ Palestine tí wọ́n pa ní Gaza lọ ní 2025?
Yi Kiristoci da aka kashe a Nijeriya a 2025 sunfi na faltunawan dake Gaza?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

FAKE TORI ALERT: I no tell Fubara say make im declare state of emergency for Rivers, says Obasanjo

Claire Mom
By Claire Mom Published March 20, 2025 5 Min Read
Share

One social media user don claim sey former President Olusegun Obasanjo chuk mouth for di political kasala wey dey hapun for Rivers state.

According to di claim, Obasanjo visit Fubara ask am sey make im close di state house of assembly and collect di security officers wey dey wit di assembly members.

Di post also claim sey Obasanjo advise Fubara sey make im order di closure of di Nigeria National Petroleum Company (NNPC) and di Niger-Delta Development Commission (NDDC) and to demolish any facility wey dem fit use plan im impeachment.

Di claim wey comot for X on Monday don gada 4.3k likes, 1.5k reposts, and 620 comments.

“OBJ DEY PARA — Close Rivers Assembly. Declare State of Emergency for Rivers State  — Obasanjo Visit SIM Fubara,” na so di post tok.

“Collect all security officers from all Rivers Assembly members. Shut down NNPC, shut down NDDC, and scata any power wey wan challenge you.

“Na you bi govnor, wey di pipu elect. You bi di Chief Security Officer of Rivers State. Wetin you order naim go stand—no bi Tinubu or Wike put you for power. Demolish any hall or arena wey dem wan use plan your impeachment. Tinubu need Rivers votes to win di 2027 election, and you dey im road”

DI RIVERS POLITICAL CRISIS

Rivers state don dey inside political kasala sake of power struggle between Siminalayi Fubara and Nyesom Wike, di govnor before am, and minister of di federal capital territory (FCT).

On Monday, di kasala swell up afta state lawmakers begin impeachment procedure ontop Fubara and Ngozi Odu, im deputy, head “sake of gross misconduct”.

On February 28, di supreme court bin gree for one federal high court ruling wey ban di Central Bank of Nigeria (CBN) and di accountant-general of di federation from releasing di monthly moni wey.Rivers suppose collect. 

Di court also cancel di local government elections wey di state conduct on October 5, 2024. Fubara promise sey im go obey wetin di court tok make im no bi like sey di state get strong head. 

Di assembly shift plenary indefinitely, afta di governor write give di assembly for di second time, sey make dem set new date to hear d budget.

Howeva, different pipu don dey chuk mouth for di mata sey make peace return to di state.

WETIN WE CHECK

CableCheck contact Kehinde Akinyemi,  media assistant to Obasanjo, wey tok sey di claim no correct.

Akinyemi tok sey di former president no visit Fubara and im no give am instruction to collect security from di lawmakers.

“As you sabi, Obasanjo no get social media account, and im no visit di governor or tok dat kain tok,” na so Akinyemi tok.

We also notice sey no confam media platform report di claim.

Di Rivers govement don also debunk di report, say na “plan to cause chaos and anarchy in the state”.

For statement wey comot on Tuesday, Nelson Chukwudi, Fubara chief informate, tok sey neither Obasanjo nor any special group visit di govnor sake of di crisis for di state.

Chukwudi add sey di govnor bin express im willingness to comply with di court ruling on di mata.

“Make evribodi sey sey no visit from PANDEF reach Governor Fubara side on di date wey dem claim, Chief Obasanjo sef no folo visit am as pipu wey hate us claim,” na so di statement tok.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey Obasanjo visit Fubara, ask am to shut di state assembly and collect all security officers attached to di lawmakers no correct.

Di former president also no order di closure of NNPC and NDDC.

TAGGED: Fubara, News in pidgin, Rivers

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom March 20, 2025 March 20, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

FRSC sị̀ nà íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ọ́rụ́ ha nà ónyé ọ̀kwà ụ́gbọ́àlà nà-ènwé ńsògbụ́ mèrè n’áfọ̀ 2020

Ngalaba Federal Road Safety Corps (FRSC) akọwala n'ihe ngosi ebe onye ọ̀kwà ụgbọala ụkwụ atọ…

August 22, 2025

FRSC sọ pé 2020 ni ìjà láàárín àwọn òṣìṣẹ́ àwọn àti onikẹkẹ maruwa tí áwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ ṣẹlẹ̀

Àjọ tó ń rí sí ààbò àwọn awakọ̀, àwọn tí wọ́n ń rìn lójú ọ̀nà…

August 22, 2025

Viral video wey show kasala between keke rider and our officers na from 2020, na so FRSC tok

The Federal Road Safety Corps (FRSC) don describe one viral video wey show as keke…

August 22, 2025

Bidiyon bidiyo na arangama tsakanin direban babur, jami’an mu daga 2020, in ji FRSC

Hukumar kiyaye hadurra ta kasa (FRSC) ta bayyana wani faifan bidiyo da ke nuna wani…

August 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

FRSC sị̀ nà íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ọ́rụ́ ha nà ónyé ọ̀kwà ụ́gbọ́àlà nà-ènwé ńsògbụ́ mèrè n’áfọ̀ 2020

Ngalaba Federal Road Safety Corps (FRSC) akọwala n'ihe ngosi ebe onye ọ̀kwà ụgbọala ụkwụ atọ na ndị ọrụ ya na-enwe…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 22, 2025

FRSC sọ pé 2020 ni ìjà láàárín àwọn òṣìṣẹ́ àwọn àti onikẹkẹ maruwa tí áwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ ṣẹlẹ̀

Àjọ tó ń rí sí ààbò àwọn awakọ̀, àwọn tí wọ́n ń rìn lójú ọ̀nà tí ọkọ̀ ń rìn àti…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 22, 2025

Viral video wey show kasala between keke rider and our officers na from 2020, na so FRSC tok

The Federal Road Safety Corps (FRSC) don describe one viral video wey show as keke rider dey open eye for…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 22, 2025

Bidiyon bidiyo na arangama tsakanin direban babur, jami’an mu daga 2020, in ji FRSC

Hukumar kiyaye hadurra ta kasa (FRSC) ta bayyana wani faifan bidiyo da ke nuna wani direban babur mai uku yana…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?