One report don claim sey US President Donald Trump threaten to capture President Bola Tinubu inside 24 hours and im security no go realise.
“If America wan capture di Nigerian president, we fit rum am inside one day and even im closest guards no go realise till we finish,” na so di report wey comot on Thursday quote Trump.
“Five years ago, di U.S. army enter Nigeria rescue our citizens wey dem kidnap and di Nigerian army bin no get any idea sey we bin dey dia. Na so dia system dey weak and disorganized.
“Nigeria must understand sey America no dey too talk we dey act fast and finish clean.”


Di post also appear for Facebook and TikTok.
Howeva, na true sey Trump threaten to capture Tinubu?
WETIN WE CHECK
Keyword search of di claim show sey local social media accounts and news platforms share di report inside 24 hours.
CableCheck notice sey di earliest version of the claim bin appear for YouTube on November 7 ontop one page called NedMedia, wey get 213,000 subscribers.
“Trump dey Consider Remove Tinubu Before Intervention? Mike Arnold Reveals sey US Fit Run Am If Im Fail,” na so dem title di video.
Dem don view am 70,345 times.
Di video begin wit one part from video wey Trump dey warn sey di US go “do things to Nigerians wey Nigeria no go happy”.
Trump bin make di comments on November 6 wen im warn sey US army fit enta Nigeria “guns-a-blazing to completely wipe out di Islamic terrorists wey dey commit these horrible wickedness”.
Di US president bin dey tok about di claims of Christian genocide for Nigeria.
Im no tok sey army go capture Tinubu inside 24 hours.
For di YouTube video, di narrator later show one tweet from Mike Arnold, former Texas mayor, wey im claim sey reveal di US plans to “remove” Tinubu.
But even di Arnold tweet no tok dat kain tin.
Instead, CableCheck notice sey na di narrator make di suggestion imself.
“Even Tinubu feel sey im job na to just appoint pesin wey go do di job,” na so di male narrator tok about tackling insecurity.
“Just appoint chief of army staff or appoint any commander, do anything — sey im job don finish. But no be wetin leadership dey about be dat. You just suppose make sure sey di pipu you appoint dey do dia work, sey dem fit do am.
“If dem no do di job, sack dem appoint pipu wey fit do di job.”
One additional search through Trump’s social media accounts, di White House website, and international media no gree wit di claims.
FINAL TOK
Evidence no dey to suggest sey Trump tok sey US army go comot Tinubu inside 24 hours. Dat kain tok for dey every credible media outlet.