TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Evidence no dey sey Trump threaten to ‘capture’ Tinubu in 24 hours
Share
Latest News
Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́
Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar
Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́
Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu
FACT CHECK: Viral photos of Nigerian Christians bearing arms in churches are misleading
Da’awar cewa Davido da Chioma suna tsammanin ɗansu na uku karya ne
Òótọ́ kọ́ ni ọ̀rọ̀ tó sọ pé Davido àti Chioma ń gbaradì fún ọmọ wọn kẹta
Evidence no dey sey Davido and Chioma dey expect dia third pikin
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Evidence no dey sey Trump threaten to ‘capture’ Tinubu in 24 hours

Claire Mom
By Claire Mom Published November 14, 2025 4 Min Read
Share
Donald Trump

One report don claim sey US President Donald Trump threaten to capture President Bola Tinubu inside 24 hours and im security no go realise.

“If America wan capture di Nigerian president, we fit rum am inside one day and even im closest guards no go realise till we finish,” na so di report wey comot on Thursday quote Trump.

“Five years ago, di U.S. army enter Nigeria rescue our citizens wey dem kidnap and di Nigerian army bin no get any idea sey we bin dey dia. Na so dia system dey weak and disorganized.

“Nigeria must understand sey America no dey too talk we dey act fast and finish clean.”

Di post also appear for Facebook and TikTok.

Howeva, na true sey Trump threaten to capture Tinubu?

WETIN WE CHECK

Keyword search of di claim show sey local social media accounts and news platforms share di report inside 24 hours.

CableCheck notice sey di earliest version of the claim bin appear for YouTube on November 7 ontop one page called NedMedia, wey get 213,000 subscribers.

“Trump dey Consider Remove Tinubu Before Intervention? Mike Arnold Reveals sey US Fit Run Am If Im Fail,” na so dem title di video.

Dem don view am 70,345 times.

Di video begin wit one part from video wey Trump dey warn sey di US go “do things to Nigerians wey Nigeria no go happy”.

Trump bin make di comments on November 6 wen im warn sey US army fit enta Nigeria “guns-a-blazing to completely wipe out di Islamic terrorists wey dey commit these horrible wickedness”.

Di US president bin dey tok about di claims of Christian genocide for Nigeria.

Im no tok sey army go capture Tinubu inside 24 hours.

For di YouTube video, di narrator later show one tweet from Mike Arnold, former Texas mayor, wey im claim sey reveal di US plans to “remove” Tinubu.

But even di Arnold tweet no tok dat kain tin.

Instead, CableCheck notice sey na di narrator make di suggestion imself.

“Even Tinubu feel sey im job na to just appoint pesin wey go do di job,” na so di male narrator tok about tackling insecurity.

“Just appoint chief of army staff or appoint any commander, do anything — sey im job don finish. But no be wetin leadership dey about be dat. You just suppose make sure sey di pipu you appoint dey do dia work, sey dem fit do am.

“If dem no do di job, sack dem appoint pipu wey fit do di job.”

One additional search through Trump’s social media accounts, di White House website, and international media no gree wit di claims.

FINAL TOK

Evidence no dey to suggest sey Trump tok sey US army go comot Tinubu inside 24 hours. Dat kain tok for dey every credible media outlet.

TAGGED: News in pidgin, Tinubu, Trump, US troops in Nigeria

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom November 14, 2025 November 14, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke…

December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church…

December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní…

December 4, 2025

Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu

Afta bandits attack worshippers Christ Apostolic Church (CAC) branch for Oke Isegun inside di Eruku…

December 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke Isegun n'obodo Eruku nke Kwara…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church (CAC) a reshen cocin Christ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní ẹ̀ka Christ Apostolic Church (CAC)…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu

Afta bandits attack worshippers Christ Apostolic Church (CAC) branch for Oke Isegun inside di Eruku community for Kwara state on…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?