TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Dis video no show sey geo-engineering dey push climate change
Share
Latest News
No, Emefiele no return N4trn to FG
Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà
Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn
A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba
FACT CHECK: No, Emefiele didn’t return N4trn to FG
FAKE NEWS ALERT: Akume hasn’t been replaced as SGF, says presidency
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Slurs, smears, slander… how gendered disinformation targets high-profile Nigerian women
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Dis video no show sey geo-engineering dey push climate change

Claire Mom
By Claire Mom Published July 7, 2023 4 Min Read
Share

One Twitter post claim some pipu dey use one high-frequency active auroral research program (HAARP) to push climate change mata.

“Dem dey use #HAARP push  #climateChange mata, and human being dey pay for am. All of us suppose gada join hand to stop dis #GeoEngineering …. Make una share dis informate #Turkey #earthquake #TurkeyEarthquake,” na so dem write for di Twitter video.

Sergeant News Network, wey im user name na, @Sgtnewsnetwork, naim post di video where e gada more dan 143.5k views. Some oda Twitter users follow share di video with di same claim, and na so thousands of pipu view am.

WETIN BI HAARP?

Di high-frequency active auroral research program na science process wey dey study di properties and behavior of di ionosphere. Ionosphere na di part of di sky for earth wey dey jam wit space.

According to di National Aeronautics and Space Administration (NASA), one US agency wey dia main wok na to study aeronautics and space research, “di ionosphere reach like 50 to 400 miles above di earth surface, near di mouth of space. 

“Along wit di neutral upper atmosphere, di ionosphere na di line between di earth lower atmosphere — where we dey live and breathe — and space.”

Dem bin first build di facility where dem dey gada informate for HAARP inside di US air force, but in August 2015, dem transfer am go di University of Alaska Fairbanks. 

HAARP na di world’s most capable high-power, high-frequency transmitter for di study of di ionosphere.

DI HAARP PROGRAM DEY PUSH CLIMATE CHANGE?

According to di official HAARP website, di ansa na big no. In fact, di program no fit create any natural disaster, tok more of to make am big.

Di study of di ionosphere no dey change weather in any way, mostly because di “radio waves for di frequency wey dey comot from HAARP no dey enta di troposphere or di stratosphere — di two levels of atmosphere wey dey produce weather for earth”. Therefore, since dem no dey jam, e no get any way wey di process dey control di weather.

DI TWITTER VIDEO NO NEW, E DON DEY INTERNET MORE DAN 10 YEARS

TheCable cari di keyframes of di video wey dey evriwhere check for Google reverse image search, wey show sey di video don dey for YouTube since April 2013. 

But one tin bi sey, di video wey don tey wey dey show as aeroplane dey release one white tin inside di atmosphere get anoda completely different meaning from di Twitter post. 

For YouTube, dem write for di video sey “Aeroplane Video – Boeing 747 supertanker water bomber aerial water drop. High Altitude water drop”

Wetin dem write for di YouTube video explain sey di Boeing 747 aircraft na firefighting aeroplane wey dem dey use quench forest fire. Di plenti white tin wey bin dey comot from di plane na water and e no get anytin to do wit geoengineering as dem bin claim.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey di HAARP project dey cause climate change and earthquakes no correct. Di project dey focus on di study of di ionosphere, and experts tok sey e no fit push climate change or cause any natural disaster.

TAGGED: Climate Change, climate change disinformation, Fact check pidgin, geo-engineering, HAARP, Pidgin news

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom July 7, 2023 July 7, 2023
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin…

July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára,…

July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru…

July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook…

July 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin Emefiele, di forma govnor of…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára, tí ó ṣe àfihàn ẹni…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru na Godwin Emefiele, onye bụbu…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook yana ikirarin Godwin Emefiele, tsohon…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?