TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Di video wey show flood dey carry white jeep na from Nigeria?
Share
Latest News
FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated
MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021
Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́
Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true
Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà
Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne
FACT CHECK: Kemi Badenoch’s claim that her children can’t get Nigerian citizenship is false
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Di video wey show flood dey carry white jeep na from Nigeria?

Claire Mom
By Claire Mom Published October 26, 2022 3 Min Read
Share

Dakore Egbuson-Akande, Nollywood actress, post some videos for her Instagram account wey dey show some places wey flood don affect wella for Niger Delta. 

On Sunday, di actress post video wey get part 1-6, di part 1 show some kain tins wey fit make pesin catch cold. No bi small struggle one white jeep bin get to drive for road wey get plenti water and potopoto. 

As e bi so, Dakore Instagram account get more dan 1.4 million followers.

As di car dey try move, e hook for inside di water. Di ogbonge wind and plenti water troway di car for deep water.

Na so pipu wey dey stand watch come dey shout as water and potopoto swallow di car wey bin get passengers. 

“Dia is fire on di mountain!!! Di kain tins wey dey dis video dey comot from many part of Nigeria and di Niger Delta dis season and e dey make cold dey catch me. My heart dey cry for dis kontri. My pipu, which way? Which time our “leaders” go cari our mata for dia head?”, na so Egbuson-Akande write.

Di video of di white jeep, togeda with di oda 5 videos wey dey show di flood wey dey affect Nigeria gather pass 6,779 likes as at di time wey dis report comot. Di actress bin no allow pipu comment for di post.

Na so TheCable come cari di video check weda e correct or not and na wetin we find be dis:

WETIN WE CHECK

We cari plenti screenshots of di first video wey get di white motor do reverse image search for Labnol. Labnol na beta tool for internet wey dey check wia picture first comot from and which oda pictures resemble di one wey you wan check.

E show sey di video don dey internet since 2017 and pipu dey always use am as example for different flood in di world. One example na di tropical Cyclone Dineo, one of di worst tropical cyclones wey don ever hapun for di south-west Indian Ocean and di southern hemisphere. 

TheCable check how sey dem bin originally record di video for Chaman, Pakistan, wen heavy rain bin dey worry di kontri in January 2017. 

For di longer version of di video, e come be like sey di pipu wey bin dey stand look come try to rescue di motor and di passengers wey bin dey inside.

FINAL TOK: Di video don dey internet since 2017 and na from Pakistan e comot, no bi Nigeria as di Nollywood actress claim.

TAGGED: Dakore Egbuson Akande, Fact check pidgin, Floods in Nigeria

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom December 13, 2023 October 26, 2022
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated

A video showing a bridge collapse incident is circulating across social media platforms, especially on…

July 24, 2025

MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021

The Nigerian Army says a viral video claiming the arrest of a foreign arms dealer…

July 24, 2025

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị…

July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass…

July 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị enyenwu ụmụ ya ikike ịbụ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass her right of Nigerian citizenship…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà

Kemi Badenoch, arábìnrin tó jẹ́ olórí ẹgbẹ́ òsèlú alátakò tí wọ́n ń pè ní Conservative Party ní orílẹ̀ èdè United…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne

Kemi Badenoch, shugabar jam'iyyar masu ra'ayin rikau ta Burtaniya, ta yi ikirarin cewa ba za ta iya mika hakkinta na…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?