TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Di moni wey Alex Otti borrow for one year pass wetin former Abia govnors borrow?
Share
Latest News
Did Tinubu attend same school with Alexander Zingman? Here is what we know
FACT CHECK: Did Nigeria deploy peace support mission to Israel?
FACT CHECK: Did lawmakers skip the national anthem during Tinubu’s Democracy Day speech?
FACT CHECK: Did a military coup oust Paul Biya as Cameroon’s president?
FACT CHECK: Ndume erred. 22 governors didn’t endorse Jonathan in 2015
Rárá, Pope Leo kò bẹ Tinubu kó tú Nnamdi Kanu sílẹ̀ ní àtìmọ́lé
Ḿbà, Pope Leo áyọghị Tinubu kà ọ́ tọ́pụ̀ Nnamdi Kanu nà ǹgá
No, Pope Leo no beg Tinubu to release Nnamdi Kanu
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Di moni wey Alex Otti borrow for one year pass wetin former Abia govnors borrow?

Claire Mom
By Claire Mom Published July 5, 2024 4 Min Read
Share

Uche Rochas, one Nigerian businessman, claim sey Alex Otti, govnor of Abia state, collect loans wey all di govnors before am no collect inside one year.

Contents
WHO BE DI PIPU WEY ROCHAS MENTION FOR DI TWEET? HOW WE CHECK DI MEAL BUDGET CLAIMHOW WE CHECK DI LOAN CLAIM

For im X page on May 28, Rochas tok sey Otti dey spend “N9m evri day ontop food from Abia state tax payers moni”.

“Im don borrow pass Orji Kalu, Theo Orji, Okezie Ikpeazu put togeda in less dan 1yr inside office,” na so Rochas tok.

“Im dey build cheap roads but di Pharisees aka obidient movement no go see anything bad inside.”

Di post don gada pass 300,000 views, 761 likes, and 181 reposts for X.

WHO BE DI PIPU WEY ROCHAS MENTION FOR DI TWEET? 

Kalu na Naija politician and businessman wey serve as govnor of Abia from May 29, 1999 to May 29, 2007.

Im be di senator wey dey represent Abia north senatorial district, while Orji serve as di state governor from 2007 to 2015 and di senator wey dey represent Abia central senatorial district from 2015 to 2023.

Ikpeazu serve as govnor from May 2015 to May 2023.

HOW WE CHECK DI MEAL BUDGET CLAIM

Rochas claim sey Otti dey spend N9 million evriday ontop food. Howeva, inside di 2024 approved budget, dem budget N595.12 million for refreshments and meals for di govnor office — bringing di daily expenditure to N1.63 million.

HOW WE CHECK DI LOAN CLAIM

To confam Rochas’ claim, TheCable first attempt to compare di first-year change for domestic and external debt profile during Orji and Ikpeazu tenure to Otti, but di informate no dey enough to make fair comparison. 

Di domestic debt records wey di Debt Management Office (DMO) gada bin start for 2011, therefore, di debt profile of govnors wey serve between 1999 and 2010 no dey inside.

DMO na agency wey govment establish to coordinate di management of Nigeria’s debt.

Debt informate for Kalu two terms and Orji first tenure for office as govnor of Abia no dey inside.

Howeva, available informate show sey Abia state domestic debt profile bin reach N142,470,717,702.46 as of June 2023, one month afta Otti enta office.

Di record folo show as di state domestic debt reduce by N3.83 billion or 2.69 percent to N138,638,007,432.32 as of December 2023 — di first six months of Otti tenure.

Also, external debt stock reduce by $3.27 million under Otti to $89,053,939.30 as of December 2023, from $92,328,683.83 as of June 2023.

During Ikpeazu tenure, di state domestic debt stock bin rise for di first year by N8.49 billion (8.92 percent) from N95,212,687,526.87 as of December 2021, to N103,710,011,090.63 as of December 2022.

Although, external debt stock under Ikpeazu dropped by $6,853,150.31 from $101,132,954.37 to $94,279,804.06 during di same period.

Also, DMO report sey di state domestic debt under Orji tanda at N31,736,723,709.99 as of December 2013, compared to N25,126,070,685.10 in December 2014 — showing reduction of N6.61 billion or 26.3 percent during im tenure.

Howeva, during Orji administration, external debt stock bin rise by $388,691.41 from $34,180,112.33 as of December 2013, to $33,791,420.92 as of December 2014.

FINAL TOK

Based on di DMO informate wey dey, e clear sey di state debt don reduce since Otti enta office. Therefore, di claim wey tok sey Otti don borrow moni pass di previous govnors combined in less dan one year for office no correct. 

Also, di claim wey tok sey Otti dey spend N9 million evriday ontop food no correct based on di 2024 approved budget.



TAGGED: Abia state, Abia state debt profile, Alex Otti

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom July 5, 2024 July 5, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Did Tinubu attend same school with Alexander Zingman? Here is what we know

During the launch of the renewed hope mechanisation programme in Abuja on Monday, President Bola…

June 24, 2025

FACT CHECK: Did Nigeria deploy peace support mission to Israel?

A Facebook video purports that Nigeria deployed troops for a joint peace support mission in…

June 24, 2025

FACT CHECK: Did lawmakers skip the national anthem during Tinubu’s Democracy Day speech?

A viral X post claims that Nigeria’s new national anthem was not recited during the…

June 13, 2025

FACT CHECK: Did a military coup oust Paul Biya as Cameroon’s president?

Reports of a military coup in Cameroon ousting President Paul Biya have gone viral on…

June 13, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

FACT CHECK: No, Abia government didn’t block arrest of 59 youths by EFCC

A Facebook user has claimed that the Abia government blocked officers of the Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) from…

Fact Check
May 24, 2025

Kìí se Nàìjíríà ni ìṣẹ̀lẹ̀ tó sàfihàn òkú àwọn ènìyàn nínú kòtò kan náà ti ṣẹlẹ̀

Àwọn ènìyàn kan ti sọ pé Nàìjíríà ni ìṣẹ̀lẹ̀ kan tó ni fídíò kan tó se àfihàn òkú àwọn ènìyàn…

Uncategorized
September 11, 2024

Viral video wey show plenti dead bodi for grave no be from Nigeria

One viral video wey show as dem mount dead bodi for wetin resemble mass grave be like e hapun for…

Uncategorized
September 11, 2024

Nje owo ti Alex Otti ya laaarin odun kan ju owo ti awon gomina Abia atijo ya?

Uche Rochas, ọkùnrin oníṣòwò kan sọ pé owó tí Alex Otti, gómìnà Ìpínlẹ̀ Abia yá láàrin ọdún kan ju gbogbo…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 5, 2024

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?