TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Di heavy rain wey fall for Brazil na becos dem yab Jesus?
Share
Latest News
FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated
MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army
Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́
Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true
Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà
Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne
FACT CHECK: Kemi Badenoch’s claim that her children can’t get Nigerian citizenship is false
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Di heavy rain wey fall for Brazil na becos dem yab Jesus?

Claire Mom
By Claire Mom Published June 3, 2023 7 Min Read
Share

Plenti social media posts claim sey di recent heavy rain wey fall for Brazil na becos dem yab Jesus during dia 2023 carnival. 

“Na small power naim God dey show Brazil di day after dem yab am,” na so di title of di Facebook video wey dey evriwhere for social media tok.

For anoda post wey get more dan 1.2 million views, one Nigerian skit maker share di viral video of di Brazilian carnival, come write sey: “Immediately Brazilians finish to yab God wit dia carnival, God destroy dia city with heavy rain.”

For di Facebook video wey plenti pipu don cari eye see, wit 56k likes and more dan 6.1k comments, di comedian make am look laik sey di dey afta dia 2023 carnival, wey dem tok sey dem yab Jesus as dem dey do dia drama, heavy rain with serious kasala hapun for Brazil. 

Anoda Facebook user post some pictures wey bi laik sey na from di 2023 carnival wit some kain foto wey dey show flooding wey no even consign Brazil.

Di post tok sey: “Flood kills plenti pipu for Brazil di day after dem yab Jesus for satanic event. Heavy rain and flood for São Paulo state, Brazil, kill at least 36 people on Sunday 25th February 2023, afta di Rio Carnival. Na di city of São Sebastião naim suffer am pass as plenti pipu miss and at least 50 houses still come collapse.”

Di post reach Twitter, Tiktok, and YouTube. 

For di video wey dey evriwhere, one actor wey wear red, wey bi laik sey na devil, come dey beat, dey suffer anoda actor, wey no dey wear plenti clothe – dey look laik Jesus wey im bin dey go im cross. Pipu don tok sey di drama mean sey devil dey do oga for Jesus, sey na yab dem dey yam Christ.

Di video wey dey evriwhere na from di February 2023 carnival for Brazil, and na true sey na di day afta di performance naim pipu die and property destroy sake of heavy rain for São Paulo?

WETIN WE CHECK

Keyword search togeda wit reverse image search ontop di keyframes show sey di skit wey dey evriwhere wey bi laik sey dem dey yab Jesus na since four years ago.

TheCable check see sey na Gaviões da Fiel, one Samba school, naim perform di skit in March 2019, during di 2019 carnival for Brazil.  Since four years ago wey dem post am for YouTube, di video don gada pass three million views.

Na so di World Christian League cari di skit go court becos of di kasala wey e cause. Di lawsuit tok sey di carnival skit dey yab Jesus, and becos of dat, make dem drop 5 million reais as compensation for di moral damages wey dem cause. 

Howeva, for 2022, Gaviões da Fiel come win di case. Di court of justice tok sey di performance no mean to “rubbish Jesus” or “to yab” am.

Di judge come still tok sey: “If you dey cari true eye look am, some people becos of dia faith, for dey feel somehow for body to dey see di pesin wey wicked pass dey defeat di pesin wey bi di biggest for di religion.” 

Di ruling add sey di performance “fit dey questioned based on im good taste”, but na still “di right of freedom of expression”.

Di 2023 carnival for Brazil start on February 17 till February 22. Pipu really wait dis year own based on di fact sey dem cancel di event during 2020 and 2021 becos of COVID. Even di one wey dem do for 2022 no too gel laik dat. Usually, na evri year dem dey run am.

BRAZIL GET IM HIGHEST RAINFALL EVER

According to di National Center for Disaster Monitoring Prediction in Brazil, all di rain wey fall for February 2023, inside di cities of di north coast of São Paulo na di highest wey dem don record for di kontri. Di last highest na for 2022. 

Tarcísio de Freitas, govnor of São Paulo, bin describe di disaster as “one of di worst incident of flooding and landslides” for di state.

On February 19, as di carnival dey hapun, na so one heavy rain fall for di the coastal region of di most populous South American nation. Becos of di rain and di flood, dem comot residents from dia house. 

Some reports tok sey di rain fall till the end of February, come dey make emergency workers no fit rescue and send relief materials to victims wella.

Also, dem bin cancel di 2023 carnival activities for di affected areas.

FINAL TOK

Di claim wey sey di viral skit – wey bi laik dem dey yab Jesus – cause di 2023 flood no correct. Di skit hapun for 2019, four years before di heavy rain wey cause kasala for Brazil last February.


This content was produced with support from the Independent Media Response Fund, an initiative of the Check Global Program at Meedan to respond to global challenges through hyperlocal initiatives. The fund is supported by the Swedish International Development Cooperation Agency (Sida). 

TAGGED: Brazil Carnival, Brazil carnival mocking Jesus, Brazil flood, Fact check pidgin, Pidgin news

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom June 3, 2023 June 3, 2023
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated

A video showing a bridge collapse incident is circulating across social media platforms, especially on…

July 24, 2025

MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army

The Nigerian Army says a viral video claiming the arrest of a foreign arms dealer…

July 24, 2025

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị…

July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass…

July 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị enyenwu ụmụ ya ikike ịbụ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass her right of Nigerian citizenship…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà

Kemi Badenoch, arábìnrin tó jẹ́ olórí ẹgbẹ́ òsèlú alátakò tí wọ́n ń pè ní Conservative Party ní orílẹ̀ èdè United…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne

Kemi Badenoch, shugabar jam'iyyar masu ra'ayin rikau ta Burtaniya, ta yi ikirarin cewa ba za ta iya mika hakkinta na…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?