TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Di carbon emissions wey comot from di Canada wildfires pass di ones from di last 100 years?
Share
Latest News
No, Emefiele no return N4trn to FG
Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà
Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn
A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba
FACT CHECK: No, Emefiele didn’t return N4trn to FG
FAKE NEWS ALERT: Akume hasn’t been replaced as SGF, says presidency
Rárá, Nàìjíríà kò fi àwọn ọmọ iṣẹ́ ológun rán sẹ sí Ísírẹ́lì láti dá rògbòdìyàn tó ń ṣẹlẹ̀ níbẹ̀ dúró
Slurs, smears, slander… how gendered disinformation targets high-profile Nigerian women
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Di carbon emissions wey comot from di Canada wildfires pass di ones from di last 100 years?

Claire Mom
By Claire Mom Published July 7, 2023 4 Min Read
Share

One post for Instagram claim sey di amount of carbon wey enta di atmosphere sake of di recent wildfires for Canada pass di ones wey human beings don cause in di last 100 years. 

“You fit TRY all dat electric car, solar power, zero emissions NONSENSE from now till tomoro but na di truth go remain: By di tym Mama Nature finish wit us, WE GO SABI,” na so dem write for di post. 

Di post get more dan 6,500 likes for Instagram. Anoda one wey resemble am also dey Facebook.

WILDFIRE FOR CANADA

Since 2023 start, wildfires don dey happen for Canada, wit huge smoke wey enta some parts of di US. By di month of June, Canada cari eye see more dan 400 wildfires, wey dey burn at di same time all ova di kontri, and dem bin no fit control more dan half of di tin. 

Di fire pursue thousands of pipu wey dey live for western Canada comot from dia house. Also, e make sure sey oil and gas companies stop dia production by force.

Becos of di kain fire wey burn, di air wey dey plenti parts of di kontri, including di Great Lakes area and some northeastern parts of di US, contaminate.

Di US environmental protection agency bin tok sey more dan 100 million people bin dey affected by air quality alerts for areas like Philadelphia, Chicago, Atlanta, Philadelphia, Pennsylvania, Syracuse, Bethlehem, and New York. 

 CO2 FROM 2023 WILDFIRES AND DI LAST 100 YEARS

Experts no gree wit di claim wey tok sey di carbon emissions wey comot from wildfires plenti pass wetin human beings don produce in di last 100 years. In fact, dem believe sey you no fit compare dem in any way.

TheCable look di Keeling Curve, evriday record of di CO2 concentration wey dey for di atmosphere, by di Scripps Institution of Oceanography at di University of California. Informate wey dey di graph show sey no serious increase dey di atmospheric CO2 for 2023 so far.

TheCable still cari eye check di carbon emission graph wey di National Oceanic and Atmospheric Administration (NOAA) publish, wey dey record any sharp increase for atmospheric CO2 since 1958. Di graph no show any beta increase for CO2 wey for support di social media claim. 

Taiwo Ogundeji, PhD student, wey dey study environmental systems and climate change for di Federal University of Agriculture Abeokuta, tell TheCable sey e no make any sense to compare emissions wey comot from three months of wildfire wit di ones wey don comot in di last 100 years or post-industrial revolution.

“Di statement no correct,” na so im tok.

“To tok sey di amount of carbon from wildfires inside some days of one year pass di one wey don gada for 100 years no get head.

“Aside from industrialisation and some oda anthropogenic contributions to atmospheric carbon, make we no forget sey plenti wildfires don dey hapun in di last 100 years.”

Werner Kurz, senior research scientist for di Canadian forest service, bin tok sey di “total emissions from all human activities since 1850 don near 10,000 times more dan di emissions from di 2023 Canadian wildfires”.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey di carbon wey comot in three days from di Canadian wildfires pass di one wey don dey earth for di last 100 years no correct. Informate wey scientists don drop about CO2 emission togeda with reviews by experts show sey di claim no get head. 

TAGGED: 2023 canada wildfires, carbon emissions from Canada wildfires, carbon emissions statistics, climate change disinformation, Fact check pidgin, Pidgin news

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom July 7, 2023 July 7, 2023
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin…

July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára,…

July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru…

July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook…

July 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

No, Emefiele no return N4trn to FG

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin Emefiele, di forma govnor of…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Rárá, Emefiele kò dá triliọnu mẹrin náírà padà fún ijọba àpapọ̀ orílẹ̀ èdè Nàìjíríà

Fídíò kan tí àwọn ènìyàn ti ń pín lórí àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára, tí ó ṣe àfihàn ẹni…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

Ḿbà, Emefiele ènyéghàchìghị̀ FG ọ́nụ́ égó N4trn

Ótù ihe ngosị nà soshal midia egosila ebe ótù onye ji Facebook ekesa ozi kwuru na Godwin Emefiele, onye bụbu…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

A’a, Emefiele bai mayarwa FG N4trn ba

Wani faifan bidiyo da ke yawo a kafafen sada zumunta ya nuna wani ma’abocin Facebook yana ikirarin Godwin Emefiele, tsohon…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?