TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Dem don release Hushpuppi from prison?
Share
Latest News
Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́
Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar
Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́
Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu
FACT CHECK: Viral photos of Nigerian Christians bearing arms in churches are misleading
Da’awar cewa Davido da Chioma suna tsammanin ɗansu na uku karya ne
Òótọ́ kọ́ ni ọ̀rọ̀ tó sọ pé Davido àti Chioma ń gbaradì fún ọmọ wọn kẹta
Evidence no dey sey Davido and Chioma dey expect dia third pikin
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Dem don release Hushpuppi from prison?

Claire Mom
By Claire Mom Published December 8, 2023 3 Min Read
Share

One video wey dey circulate for social media claim sey Ramon Abbas, aka Hushpuppi, don comot prison.

Di video don gada pass 2.2m views, 2,400 retweets, 957 comments and over 7,000 likes for X, former Twitter.

Wetin dem write for di video wey @praiseoghre share tok sey: “Hushpuppi don comot prison, make we hope sey im don learn im lesson”.

For di video, pipu wey resemble Hushpuppi friends dey welcome am for airport as im hold bag. 

Inside di video, some pipu bin dey record am for dia phone as e dey comot from di airport.

Hushpuppi’s been released from jail, let’s hope he has learnt from his mistakes 🙏🏾 pic.twitter.com/AtB6bdtMr0

— 🅱️abygirl4️⃣life🔱🔱 (@praiseoghre) November 30, 2023

Dem don share di video for some pages ontop Facebook, dey claim sey Hushpuppi no dey prison.

WHO BE HUSHPUPPI?

Huspuppi na Nigerian internet celeb wey dey serve 11-year jail term for America sake of “extensive international online fraud”.

Dem tok sey im commit crimes around money laundering, internet fraud, hacking, fake identity, scamming, banking fraud and identity theft worth Dh1.6 billion (around N168 billion).

In June 2020, di Federal Bureau of Investigation (FBI) track and arrest am through im Google account for Dubai, United Arab Emirates (UAE).

Otis D. Wright II, US district judge, sentence di internet celebrity afta dem cari am go America in July 2020.

Wright give am order make im pay back $1,732,841 to two fraud victims, afta im plead guilty to one-count charge of conspiracy to engage in money laundering in April 2021.

Right now, Hushpuppi dey serve im jail term for di Federal Correctional Institution (FCI) in Fort Dix, New Jersey.

WETIN WE CHECK

Keyword search show sey di video first comot for YouTube in 2018 by iLiteTV, during Hushpuppi birthday for Cyprus.

Di video comot again for YouTube in 2020 afta dem arrest am, make e be like sey dem release di internet celebrity from prison.

To check where Hushpuppi currently dey, TheCable still check di inmates register of di US Federal Bureau of Prisons.

Di register get di details of inmates including dia name, age, location and dia release date.

Di search results show sey Hushpuppi currently dey Fort Dix Federal Correctional Institution and im release date na April 2029.

FINAL TOK

Di claims wey tok sey Hushpuppi don comot prison no correct. Di viral clip wey be like sey e don comot na old video from 2018. 

Based on records from di US Federal Bureau of Prisons, di internet celebrity still dey prison dey serve im 11-year jail term.

TAGGED: Fact check pidgin, HushPuppi, Hushpuppi released from prison, Pidgin news, TheCable pidgin

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom December 8, 2023 December 8, 2023
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke…

December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church…

December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní…

December 4, 2025

Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu

Afta bandits attack worshippers Christ Apostolic Church (CAC) branch for Oke Isegun inside di Eruku…

December 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke Isegun n'obodo Eruku nke Kwara…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church (CAC) a reshen cocin Christ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní ẹ̀ka Christ Apostolic Church (CAC)…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu

Afta bandits attack worshippers Christ Apostolic Church (CAC) branch for Oke Isegun inside di Eruku community for Kwara state on…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?