TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Claim wey tok sey Kaduna neva attract FDI since el-Rufai comot office no correct
Share
Latest News
Video wey tok sey Nigerian church dey on fire na lie, na Ghana school
Ị́hé ńgósị́ ụ́lọ́ákwụ́kwọ́ Ghana gbáráọ́kụ́ ká á sị́ n’ọ́bụ́ ụ́lọ́ ụ́ká dị́ nà Naijiria
Bidiyon gobarar da ta faru a makarantar Ghana da aka bayyana karya a matsayin kona cocin Najeriya
Ghana ni ìṣẹ̀lẹ iná ní ilé ìwé kan tí àwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ kiri ti ṣẹlẹ̀, kìí se ilé ìjọsìn àwọn Kristẹni ní Nàìjíríà
FACT CHECK: Video of Ghanaian school fire incident falsely described as razed Nigerian church
RoundCheck to host poetry festival on media and information literacy on December 12
Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́
Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Claim wey tok sey Kaduna neva attract FDI since el-Rufai comot office no correct

Claire Mom
By Claire Mom Published March 6, 2025 2 Min Read
Share

One X user, @xagreat, don claim sey Kaduna state neva attract one single foreign direct investment (FDI) since Nasir el-Rufai, di forma govnor, comot office.

Di X user also tok sey by 2027, during di next election, dem go comot Uba Sani, di state govnor, to save Kaduna from “sinking.”

“Since Elrufai comot office, Kaduna state neva cari eye see one single Foreign Direct Investment. Na wetin dem dey call backwardness be dis,” na so di post tok.

“We go retire Uba Sani for 2027 to rescue Kaduna from any more sinking.”

Di post don attract ova 14,000 views, 232 likes, and 78 reposts as of March 4.

WHY FDI DEY IMPORTANT?

FDI na investment from one party for one kontri inside business or corporation for anoda kontri to establish lasting interest.

Di tin na major economic driver wey dey create employment opportunities, grow businesses, increases tax revenue, develop kontri,, and increase di kontri external reserves.

Also, foreign direct investment dey serve as economic performance indicator, as states wey no attract FDI come be like sey dem no enter investor eye.

WETIN WE CHECK

Dem swear Sani in as Kaduna govnor on May 29, 2023.

CableCheck review di capital importation from di National Bureau of Statistics (NBS) from di third quarter (Q3) of 2023 through di third quarter of 2024.

Di informate show sey Kaduna no get FDI between Q3 of 2023 and di second quarter (Q2) of 2024.

For di last capital importation informate of 2024, NBS report sey Kaduna attract $1.95 million for investments in Q3 2024.

NBS tok sey Kaduna bin dey among di five states wey record capital importation during di quarter, with di $1.95 million wey represent 0.16 percent of di total FDI of $1.25 billion wey Nigeria bin record within Q3 2024.

FINAL TOK
Di claim wey tok sey Kaduna neva attract FDI since el-Rufai comot office no correct.

TAGGED: FDI, kaduna state, Nasir el-Rufai, Uba Sani. news in Pidgin

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom March 6, 2025 March 6, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Video wey tok sey Nigerian church dey on fire na lie, na Ghana school

One TikTok user claim sey jihadists burn church for di northern part of Nigeria. One…

December 12, 2025

Ị́hé ńgósị́ ụ́lọ́ákwụ́kwọ́ Ghana gbáráọ́kụ́ ká á sị́ n’ọ́bụ́ ụ́lọ́ ụ́ká dị́ nà Naijiria

Ótú onye na TikTok ekwuola na ndị jihad a gbaala ụlọ ụka ọkụ na mpaghara…

December 12, 2025

Bidiyon gobarar da ta faru a makarantar Ghana da aka bayyana karya a matsayin kona cocin Najeriya

Wani mai amfani da TikTok ya yi ikirarin cewa mayakan jihadi sun lalata wata Coci…

December 12, 2025

Ghana ni ìṣẹ̀lẹ iná ní ilé ìwé kan tí àwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ kiri ti ṣẹlẹ̀, kìí se ilé ìjọsìn àwọn Kristẹni ní Nàìjíríà

Ẹnì kan tó ń lo TikTok, ibì kan lórí ayélujára tí áwọn ènìyàn ti máa…

December 12, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Video wey tok sey Nigerian church dey on fire na lie, na Ghana school

One TikTok user claim sey jihadists burn church for di northern part of Nigeria. One TikTok user — @WakaWakaplanet —…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 12, 2025

Ị́hé ńgósị́ ụ́lọ́ákwụ́kwọ́ Ghana gbáráọ́kụ́ ká á sị́ n’ọ́bụ́ ụ́lọ́ ụ́ká dị́ nà Naijiria

Ótú onye na TikTok ekwuola na ndị jihad a gbaala ụlọ ụka ọkụ na mpaghara ụ́gwụ́ nke Naịjiria. @WakaWakaplanet jiri…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 12, 2025

Bidiyon gobarar da ta faru a makarantar Ghana da aka bayyana karya a matsayin kona cocin Najeriya

Wani mai amfani da TikTok ya yi ikirarin cewa mayakan jihadi sun lalata wata Coci a yankin arewacin Najeriya. Wani…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 12, 2025

Ghana ni ìṣẹ̀lẹ iná ní ilé ìwé kan tí àwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ kiri ti ṣẹlẹ̀, kìí se ilé ìjọsìn àwọn Kristẹni ní Nàìjíríà

Ẹnì kan tó ń lo TikTok, ibì kan lórí ayélujára tí áwọn ènìyàn ti máa ń fi àwòrán tàbí fídíò…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 12, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?