TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Claim wey tok sey Kaduna neva attract FDI since el-Rufai comot office no correct
Share
Latest News
Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́
Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar
Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́
Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu
FACT CHECK: Viral photos of Nigerian Christians bearing arms in churches are misleading
Da’awar cewa Davido da Chioma suna tsammanin ɗansu na uku karya ne
Òótọ́ kọ́ ni ọ̀rọ̀ tó sọ pé Davido àti Chioma ń gbaradì fún ọmọ wọn kẹta
Evidence no dey sey Davido and Chioma dey expect dia third pikin
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Claim wey tok sey Kaduna neva attract FDI since el-Rufai comot office no correct

Claire Mom
By Claire Mom Published March 6, 2025 2 Min Read
Share

One X user, @xagreat, don claim sey Kaduna state neva attract one single foreign direct investment (FDI) since Nasir el-Rufai, di forma govnor, comot office.

Di X user also tok sey by 2027, during di next election, dem go comot Uba Sani, di state govnor, to save Kaduna from “sinking.”

“Since Elrufai comot office, Kaduna state neva cari eye see one single Foreign Direct Investment. Na wetin dem dey call backwardness be dis,” na so di post tok.

“We go retire Uba Sani for 2027 to rescue Kaduna from any more sinking.”

Di post don attract ova 14,000 views, 232 likes, and 78 reposts as of March 4.

WHY FDI DEY IMPORTANT?

FDI na investment from one party for one kontri inside business or corporation for anoda kontri to establish lasting interest.

Di tin na major economic driver wey dey create employment opportunities, grow businesses, increases tax revenue, develop kontri,, and increase di kontri external reserves.

Also, foreign direct investment dey serve as economic performance indicator, as states wey no attract FDI come be like sey dem no enter investor eye.

WETIN WE CHECK

Dem swear Sani in as Kaduna govnor on May 29, 2023.

CableCheck review di capital importation from di National Bureau of Statistics (NBS) from di third quarter (Q3) of 2023 through di third quarter of 2024.

Di informate show sey Kaduna no get FDI between Q3 of 2023 and di second quarter (Q2) of 2024.

For di last capital importation informate of 2024, NBS report sey Kaduna attract $1.95 million for investments in Q3 2024.

NBS tok sey Kaduna bin dey among di five states wey record capital importation during di quarter, with di $1.95 million wey represent 0.16 percent of di total FDI of $1.25 billion wey Nigeria bin record within Q3 2024.

FINAL TOK
Di claim wey tok sey Kaduna neva attract FDI since el-Rufai comot office no correct.

TAGGED: FDI, kaduna state, Nasir el-Rufai, Uba Sani. news in Pidgin

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom March 6, 2025 March 6, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke…

December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church…

December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní…

December 4, 2025

Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu

Afta bandits attack worshippers Christ Apostolic Church (CAC) branch for Oke Isegun inside di Eruku…

December 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke Isegun n'obodo Eruku nke Kwara…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church (CAC) a reshen cocin Christ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní ẹ̀ka Christ Apostolic Church (CAC)…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu

Afta bandits attack worshippers Christ Apostolic Church (CAC) branch for Oke Isegun inside di Eruku community for Kwara state on…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?