TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Claim wey tok sey FIFA give Kenya $1.2m to build Talanta stadium no correct
Share
Latest News
Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́
Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar
Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́
Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu
FACT CHECK: Viral photos of Nigerian Christians bearing arms in churches are misleading
Da’awar cewa Davido da Chioma suna tsammanin ɗansu na uku karya ne
Òótọ́ kọ́ ni ọ̀rọ̀ tó sọ pé Davido àti Chioma ń gbaradì fún ọmọ wọn kẹta
Evidence no dey sey Davido and Chioma dey expect dia third pikin
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Claim wey tok sey FIFA give Kenya $1.2m to build Talanta stadium no correct

Claire Mom
By Claire Mom Published October 31, 2025 4 Min Read
Share

On October 26, Dino Melaye claim sey FIFA give Nigeria and Kenya $1.2 million to build stadiums for dia kontris. 

For X tweet, di former Kogi govnorship candidate share one foto wey show di two alleged FIFA-funded stadiums, claim sey Nigerian administrators mismanage di funds.

Im shared di foto of one FIFA-funded mini-stadium for Birnin-Kebbi, Kebbi state, togeda wit di Talanta Sports Stadium wey dem dey build for Kenya.

“Di goal be sey make dem both build stadium for football development. Our moral sense don finish, we dey celebrate agbero, we dey honour tiff,” na so di tweet tok.

Di tweet gada pass 621k impressions, 8k likes, and 2.5k retweets.

For anoda version of di tweet wey get small difference, one X user, @CitizenObs, claim sey di two kontris bin collect $10 million each from FIFA for di stadiums. Di user share di same foto wey di former senator use.

WETIN HAPUN BEFORE

Di FIFA-funded $1.19m mini-stadium for Birnin-Kebbi

E neva tey wey social media users begin claim sey di Nigeria Football Federation (NFF) dey mismanage moni.

Some reports claim sey NFF misuse di FIFA funding wey dem bin give for community football and stadium development.

Di main kasala na di mini-stadium for Birnin-Kebbi wey FIFA give moni make dem build. Dem bin start construction work for di stadium in 2020 and dem inaugurate am 2023, wit quoted cost of $1.19 million.

FIFA sponsor di project through im “Forward Programme”, wey dey provide beta funding and support for football development projects all over di world.

Di stadium na one of two projects wey dey funded under di initiative. Di oda project folo be mini stadium for Ugborodo, Delta state.

TALANTA SPORTS STADIUM FOR KENYA

Recent foto of di Tantala Sports Stadium wet President William Ruto of Kenya share 

Di Talanta Stadium na multi-sports arena wey dem dey build for Nairobi, Kenya. Dem wan use di facility host di 2027 Africa Cup of Nations (AFCON) matches, wey Kenya folo host wit Tanzania and Uganda.

Di stadium go fit take at least 60,000 spectators once dem complete am. Di Kenyan government fully fund di project and dem give di contract to China Road and Bridge Corporation (CRBC).

According to The Times Kenya, local newspaper, Talanta Sports City Stadium “go cost taxpayer Sh44.7 billion,” around $344.5 million.

Di project cost bin dey inside document wey Soipan Tuya, cabinet secretary, presented give di kontri legislative committee on sports and culture for April.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey dem dey use di same amount construct di mini-stadium for Birnin-Kebbi and di Talanta Sports Stadium for Kenya no correct.

E no also correct sey na FIFA fund di construction of di Talanta project. Na di Kenyan government dey fully fund di stadium construction.

TAGGED: Dino Melaye, FIFA stadium in Nigeria, News in pidgin, Talanta sports stadium

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom October 31, 2025 October 31, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke…

December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church…

December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní…

December 4, 2025

Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu

Afta bandits attack worshippers Christ Apostolic Church (CAC) branch for Oke Isegun inside di Eruku…

December 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke Isegun n'obodo Eruku nke Kwara…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church (CAC) a reshen cocin Christ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní ẹ̀ka Christ Apostolic Church (CAC)…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu

Afta bandits attack worshippers Christ Apostolic Church (CAC) branch for Oke Isegun inside di Eruku community for Kwara state on…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?