On October 26, Dino Melaye claim sey FIFA give Nigeria and Kenya $1.2 million to build stadiums for dia kontris.
For X tweet, di former Kogi govnorship candidate share one foto wey show di two alleged FIFA-funded stadiums, claim sey Nigerian administrators mismanage di funds.
Im shared di foto of one FIFA-funded mini-stadium for Birnin-Kebbi, Kebbi state, togeda wit di Talanta Sports Stadium wey dem dey build for Kenya.
“Di goal be sey make dem both build stadium for football development. Our moral sense don finish, we dey celebrate agbero, we dey honour tiff,” na so di tweet tok.
Di tweet gada pass 621k impressions, 8k likes, and 2.5k retweets.
For anoda version of di tweet wey get small difference, one X user, @CitizenObs, claim sey di two kontris bin collect $10 million each from FIFA for di stadiums. Di user share di same foto wey di former senator use.
WETIN HAPUN BEFORE

E neva tey wey social media users begin claim sey di Nigeria Football Federation (NFF) dey mismanage moni.
Some reports claim sey NFF misuse di FIFA funding wey dem bin give for community football and stadium development.
Di main kasala na di mini-stadium for Birnin-Kebbi wey FIFA give moni make dem build. Dem bin start construction work for di stadium in 2020 and dem inaugurate am 2023, wit quoted cost of $1.19 million.
FIFA sponsor di project through im “Forward Programme”, wey dey provide beta funding and support for football development projects all over di world.
Di stadium na one of two projects wey dey funded under di initiative. Di oda project folo be mini stadium for Ugborodo, Delta state.
TALANTA SPORTS STADIUM FOR KENYA

Di Talanta Stadium na multi-sports arena wey dem dey build for Nairobi, Kenya. Dem wan use di facility host di 2027 Africa Cup of Nations (AFCON) matches, wey Kenya folo host wit Tanzania and Uganda.
Di stadium go fit take at least 60,000 spectators once dem complete am. Di Kenyan government fully fund di project and dem give di contract to China Road and Bridge Corporation (CRBC).
According to The Times Kenya, local newspaper, Talanta Sports City Stadium “go cost taxpayer Sh44.7 billion,” around $344.5 million.
Di project cost bin dey inside document wey Soipan Tuya, cabinet secretary, presented give di kontri legislative committee on sports and culture for April.
FINAL TOK
Di claim wey tok sey dem dey use di same amount construct di mini-stadium for Birnin-Kebbi and di Talanta Sports Stadium for Kenya no correct.
E no also correct sey na FIFA fund di construction of di Talanta project. Na di Kenyan government dey fully fund di stadium construction.