TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Christ Embassy: No bi us write di viral statement wey dey praise Tinubu
Share
Latest News
FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated
MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army
Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́
Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true
Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà
Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne
FACT CHECK: Kemi Badenoch’s claim that her children can’t get Nigerian citizenship is false
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Christ Embassy: No bi us write di viral statement wey dey praise Tinubu

Claire Mom
By Claire Mom Published May 28, 2023 3 Min Read
Share

Loveworld Inc., di main kompani wey get Christ Embassy International, don comot hand for di viral statement wey dey praise Bola Tinubu, di president-elect.

Pipu tok sey di statement wey dey evriwhere for social media comot from Chris Oyakhilome, oga kpatakpata of Loveworld Inc., and Christ Embassy.

Dem tok sey Oyakhilome describe Tinubu as di man wey God favour from di house of Pharoah. According to di statement, di foma Lagos govnor wey Nigerians don too badmouth naim go come transform di kontri.

“Some of us bin support VP Osinbajo during di contest inside APC and I bin write against BAT and I tok sey time don reach for new man,” na so one part of di statement tok.

“Dem set trap for am. For my life, I neva see any man wey pipu don badmouth pass am but e dey jump pass evri trap wey dem set. For di 8 years wey im help Buhari win, na so so insult dey folo am. Na only angel fit survive di tins wey dat man suffer.

“All di powers wey dey dis Naija no gree for am, but di man still survive dia wicked plan. Dis man na from di house of Pharaoh. Im sabi di system and e don chop from am. Im sabi where all di beta tins for the kontri dey. I dey pray sey e sabi wetin e mean to get life wey nobody go forget am. Di man don too suffer.

“Dis man no bi fool. Im get sense pass plenti of all im opponents join. Di only tin wey remain na for im to write im name inside history book and na by to get di ordinary man for mind. Im don dey find am wella, no bi today. Im no fit do am alone but e fit show di road. Make we support am.”

Di claims folo comot for Twitter.

Imagine their congregation taking them serious 🤣🤣🤣🤣 https://t.co/o3ZOgu2xSk

— Emerald 💚 هداية (@Mz_Tosyn) March 13, 2023

"TINUBU IS OUR MOSES. HE'S THE ONE GOD CHOSE FOR THIS PERIOD. HE'LL EXCEL."

…Pastor Oyakhilome reverse .

— June12 Mandate (@Gen_Buhar) March 12, 2023

"TINUBU IS OUR MOSES. HE'S THE ONE GOD CHOSE FOR THIS PERIOD. HE'LL EXCEL."

– PASTOR OYAKHILOME

Dey don dey leave Peter obi behind.

— Qudus Akanbi Eleyi of Lagos. (@EleyiLagos) March 12, 2023

LOVEWORLD: PASTOR CHRIS NO WRITE DAT STATEMENT

Di department wey dey in charge of informate for Loveworld comot hand for di statement. Dem tell TheCable sey di viral statement no comot from dem or Christ Embassy.

Loveworld com add sey di claims don dey internet since March, even as dem don tok taya sey no bi di church release am.

“Fake news. E no get head. Dem no get video to prove am, no audio, e just comot from air. No bi from Pastor Chris,” na so di statement wey dem send give TheCable tok.

TAGGED: Bola Tinubu, Christ Embassy, Christ Oyakhilome

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom December 13, 2023 May 28, 2023
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated

A video showing a bridge collapse incident is circulating across social media platforms, especially on…

July 24, 2025

MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army

The Nigerian Army says a viral video claiming the arrest of a foreign arms dealer…

July 24, 2025

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị…

July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass…

July 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị enyenwu ụmụ ya ikike ịbụ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass her right of Nigerian citizenship…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà

Kemi Badenoch, arábìnrin tó jẹ́ olórí ẹgbẹ́ òsèlú alátakò tí wọ́n ń pè ní Conservative Party ní orílẹ̀ èdè United…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne

Kemi Badenoch, shugabar jam'iyyar masu ra'ayin rikau ta Burtaniya, ta yi ikirarin cewa ba za ta iya mika hakkinta na…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?