TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Charly Boy no tok true sey Nnamdi Kanu son win ‘international brain competition’
Share
Latest News
Finnish court no release Simon Ekpa, give am $50,000 compensation
Ilé ẹjọ́ ní Finland kò dá ẹjọ́ pé kí wọ́n tú Simon Ekpa sílẹ̀ ní ẹ̀wọ̀n, wọn kò sì fún un ní àádọ́ta ẹgbẹ̀rún dọ́là owó gbàmábínú
Ụ́lọ́ị́kpé Finland átọ́pụ́ghị́ Simon Ekpa nà ńgà, máọ́bụ́ kwụ́ghàchị́ yá ụ́gwọ́ $50,000
Kotun Finnish ba ta saki Simon Ekpa ba, ta ba shi diyyar dala 50,000
FACT CHECK: Finnish court didn’t free Simon Ekpa, award him $50,000 compensation
Ńgághárị́wé méré ńké Napel kà é bị́pụ́tárá dị́kà ọ́gbákọ́ ndị̀ ná-áchọ́ ńtọ́pụ̀ Nnamdi Kanu na-ngà
Fídíò ẹ̀hónú ní Nepal ni àwọn ènìyàn ń pín, tí wọ́n ní Nàìjíríà ló ti ṣẹlẹ̀ kí ìjọba lè tú Nnamdi Kanu sílẹ̀
Old Nepal protest video comot for internet as Abuja protest for Nnamdi Kanu release
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Charly Boy no tok true sey Nnamdi Kanu son win ‘international brain competition’

Claire Mom
By Claire Mom Published October 7, 2025 4 Min Read
Share
Charly Boy

Charly Boy, chief Nigerian musician, don claim sey di son of Nnamdi Kanu, leader of di proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB), win international world brain competition.

Charly Boy make di claim for tweet on Wednesday.

“Nnamdi Kanu son don shock di the world as e become di first child ever to win English, Mathematics, and Russian Language for one international world brain competition,” na so di post tok.

“Di 11-year-old prodigy outshine di United Kingdom for dia very own language, comot as di champion. E still go defeat some of di strongest young minds for di world, e confam sey e sabi book ontop di global stage.

“Dis historic victory no only place am for evribodi eye but e don folo write im name for di record books as one of di most gifted children for im generation.”

So far, di post don gada 952.2k views, 24k likes, 4.6k retweets, and 689 bookmarks.

Some mixed reactions bin dey among di 1.4k comments. While some users bin dey try verify di informate from Grok, X’s AI assistant, odas welcome di development.

But di informate wey di musician give no complete.

Charly Boy no mention di date, di specifics of the competition including di title, or di winner name.

Na wetin CableCheck find be dis.

WETIN WE CHECK

On June 14-17, di regional British Neuroscience Olympiad (BNO) 2025 bin hapun online. Dem bin hold di national competition for August for London.

Di competition, wey students fit register, dey try inspire young learners to pursue career for neuroscience and oda related STEM fields.

Di regional round competition bin task participants wit questions from neuroscience, while di national competition bin give dem multiple-choice questions, patient diagnosis challenge, togeda wit neuroanatomy and neurohistology tests.

Mehul Rathi win di competi, Pouria Karimi collect second, and Hannah Weissmann chop third.

One separate event wey im name na di “Brain Up International Championship 2025” folo hapun for di UK, wit focus on abacus and mental arithmetic skills for di world.

Dem no publicly list di specific winners of di competition. Howeva, dem mention one Myra Shaikh as di champion for one Instagram post wey bin relate wit one international abacus competition.

International Brain Bee, anoda competition, bin folo hapun but di 2025 world championship event hapun virtually for US.

Di closest tin wey resemble  international “world brain competition” for di UK recently na dat BNO event.

CableCheck run Google reverse image search ontop di foto wey Charly Boy post claim sey na Nnamdi Kanu son, and we find different result.

Di foto belong to Alejandro Cooper, one young Namibian actor, wey bin make history for di kontri as im win di ‘Best Youngest African Actor’ award for Burkina Faso on November 16.

Di 12-year-old receive di honour for im role for di film ‘Lukas’, directed by Philippe Talavera

Some Namibian news outlets bin folo report di award.

FINAL TOK

Di foto wey Charly Boy post as Nnamdi Kanu son no correct. E no also clear which “brain competition” im bin dey refer to. Confam competitions wey hapun for di UK dis year no get any winners related to Kanu.

TAGGED: Charly Boy, international brain competition, News in pidgin, Nnamdi Kanu's son

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom October 7, 2025 October 7, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

Finnish court no release Simon Ekpa, give am $50,000 compensation

Some social media users don claim sey one Finnish court give judgment make dem release…

October 23, 2025

Ilé ẹjọ́ ní Finland kò dá ẹjọ́ pé kí wọ́n tú Simon Ekpa sílẹ̀ ní ẹ̀wọ̀n, wọn kò sì fún un ní àádọ́ta ẹgbẹ̀rún dọ́là owó gbàmábínú

Àwọn ènìyàn kan tí wọ́n ń lo àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára sọ pé…

October 23, 2025

Ụ́lọ́ị́kpé Finland átọ́pụ́ghị́ Simon Ekpa nà ńgà, máọ́bụ́ kwụ́ghàchị́ yá ụ́gwọ́ $50,000

Ụfọdụ ndị na soshal midia ekwuola na ụlọikpe dị na Finland nyere ịwụ ka-tọghapul Simon,…

October 23, 2025

Kotun Finnish ba ta saki Simon Ekpa ba, ta ba shi diyyar dala 50,000

Wasu masu amfani da shafukan sada zumunta sun yi ikirarin cewa wata kotu a Finland…

October 23, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Finnish court no release Simon Ekpa, give am $50,000 compensation

Some social media users don claim sey one Finnish court give judgment make dem release Simon Ekpa, pro-Biafra agitator, wey…

CHECK AM FOR WAZOBIA
October 23, 2025

Ilé ẹjọ́ ní Finland kò dá ẹjọ́ pé kí wọ́n tú Simon Ekpa sílẹ̀ ní ẹ̀wọ̀n, wọn kò sì fún un ní àádọ́ta ẹgbẹ̀rún dọ́là owó gbàmábínú

Àwọn ènìyàn kan tí wọ́n ń lo àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára sọ pé ilé ẹjọ́ kan ní orílẹ̀…

CHECK AM FOR WAZOBIA
October 23, 2025

Ụ́lọ́ị́kpé Finland átọ́pụ́ghị́ Simon Ekpa nà ńgà, máọ́bụ́ kwụ́ghàchị́ yá ụ́gwọ́ $50,000

Ụfọdụ ndị na soshal midia ekwuola na ụlọikpe dị na Finland nyere ịwụ ka-tọghapul Simon, Ekpa, onye ndú otu nwere…

CHECK AM FOR WAZOBIA
October 23, 2025

Kotun Finnish ba ta saki Simon Ekpa ba, ta ba shi diyyar dala 50,000

Wasu masu amfani da shafukan sada zumunta sun yi ikirarin cewa wata kotu a Finland ta yanke hukuncin sakin Simon…

CHECK AM FOR WAZOBIA
October 23, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?