TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Atiku make plenti claim for Arise TV interview but how many of dem correct?
Share
Latest News
Seven ways to detect an AI-generated video
BLIND SPOT: Nigeria’s shortcomings in the age of AI scams
The rise of deepfakes and the fight for digital truth
DISINFO ALERT: Health ministry debunks AI video claiming free nationwide diabetes treatment
Video wey show as ‘security operatives’ dey break into apartment no be from south-east
Íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ǹché nà-ákpáká ụ́lọ̀ ésiteghị nà south-east
Ìṣẹ̀lẹ tí àwọn ‘òṣìṣẹ́ elétò ààbò’ fẹ́ fipá wọ ibùgbé kan kò ṣẹlẹ̀ ní gúúsù ilà oòrùn Nàìjíríà
Bidiyon da ake dangantawa da ‘jami’an tsaro’ da suka kutsa cikin gida ba daga kudu maso gabas ba ne
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Atiku make plenti claim for Arise TV interview but how many of dem correct?

Claire Mom
By Claire Mom Published August 7, 2022 8 Min Read
Share

For interview with Arise TV, Atiku Abubakar, former vice-president and di presidential candidate of di Peoples Democratic Party (PDP) make plenti claim. Some na about wetin im dey plan for Nigeria, odas na about wetin im don do before.

TheCable check wetin im tok and na wetin we find be dis.

CLAIM 1: Abraham Lincoln, one of di famous leaders for America, contest for president 5-6 times before im come finally win.

FINAL TOK: No bi true.

Abraham Lincoln no contest for president reach five or six times as Atiku claim. 

Di first time wey Lincoln contest president for 1860, im win. And dem re-elect am in 1864.

Na im be di 16th president of di United States. John Wilkes Booth come try kill am for Ford’s Theatre, Washington DC.  Lincoln die di next day on April 15, 1865.


CLAIM 2: No law for Nigeria sey make govment workers no do business. 

FINAL TOK: No bi true. Di Nigerian legislation no gree make full time govment workers do business, except na farming.

Section 6(b) of di Code of Conduct Bureau (CCB) and Tribunal Act only gree make public servants farm any type of farm.

Di same tok still dey sections 2 (a) and (b) of di fifth schedule to di 1999 Constitution.

Timi Olagunju, one lawyer and policy analyst, tell TheCable sey section 6 of di Code of Conduct Bureau (CCB) and Tribunal Act no use small mouth tok di mata.

“Di constitution dey support di CCB. Na legislation, no bi one kain law wey no get head. Section 6 tok sey anybody wey dey do govment work no suppose do any oda type of business by di side except na farming,” na so im tok.

“E dey important to know sey small space dey for di law. Di pesin fit do anoda business if no be full time govment woker.”

But Olagunju come tok sey since e become lawyer, e neva see di law punish government workers wey still dey do dia own business outside.


CLAIM 3: About 80 million pipu dey live for Egypt and dem get more dan 2 million policemen. 

FINAL TOK: All of dem no bi true. No correct information gree sey Egypt get 2 million police officers.

According to di 2015 Home Office analysis of di Egyptian armed forces,  the Egyptian National Police Force get like 350,000 pipu wey dia work na to make sure sey pipu dey obey law and evriwhere dey kampe.

In September 2014, dem put all di pipu wey dey di Egyptian armed forces at 458,500 (army: 340,000, air force: 100,000, navy: 18,500), with total of 479 000 pipu wey dem keep one side.

All di Egyptian armed forces join still no reach di ‘2 million’ wey Atiku tok.

According to one 2017 report wey Worldatlas release, dem list di top 30 kontris for di world wey get di most policemen. China dey ontop with 1.6million, followed by India and the United States wit 1,585,353 and 913,161 for di two of dem.

No kontri for di list get up to 2 million police officers. Egypt no even dey dat report.

Meanwhile, according to di United Nations Population Fund (UNFPA), na 106.2 million pipu dey live for Egypt no be 80 million as Atiku claim.


CLAIM 4: Di oil sector get 20 percent of Nigeria’s GDP. 

FINAL TOK: No bi true.

Information from Statista show sey between October 2018 and July 2021, di oil sector contribute less dan 10 percent to di national GDP. 

TheCable still check data wey di National Bureau of Statistics (NBS) release come see sey di highest amount wey di oil sector contribute between 2019 and 2021 na 9.77 percent and na for di third quarter of 2019.

In 2021, oil contribution to di GDP drop go 7.24 percent from di 8.16 percent where im bin dey for 2020.

From all di data wey TheCable check, oil contribution to di GDP in di last 3 years neva reach 10 per cent. 


Reuben Abati and Tundun Abiola

CLAIM 5: Na 17 security agencies dey dis kontri and na one part of di kontri dey control dem.

FINAL TOK: Some parts of dis tok no correct.

TheCable check see sey most of di pipu wey dey control di security agencies for Nigeria na from di North.

However, na just few of di agencies get pipu from di South as oga and dem bi; di defence intelligence agency wey get Samuel Adebayo from Ekiti (south-west) as oga.  Also, Lucky Irabor, di chief of defence staff, na from Delta state (south-south). Oladayo Amao, di current chief of air staff, na from Osun (south-west).

S/N Security agency Head of agency State of origin Geo-political zone
1. State Security Services (SSS) Mr. Yusuf Magaji Bichi Kano state North-west
2. National Intelligence Agency (NIA) Abubakar Ahmed Rufai Katsina state North-west
3. Defense Intelligence Agency (DIA) Samuel Adebayo Ekiti state South-west
4. Chief of Defence Staff General Lucky Irabor Delta state South-south
5. Nigerian Army Faruk Yahaya
(Chief of Army Staff)
Sokoto state North-west
6. Nigerian Navy Awwal Zubairu Gambo (Chief of Naval Staff) Kano state North-west
7. Nigerian Air Force Oladayo Isiaka Amao (Chief of Air Staff) Osun state South-west
8. Nigeria Police Force (NPF) Usman Alkali Baba (Inspector General of Police) Yobe State North-East
9. Nigeria Customs Service Col. Hameed Ibrahim Ali (Rtd.) Bauchi state North-east
10. Nigerian Correctional Service Haliru Nababa (Controller-General) Sokoto state North-west
11. Nigerian Security and Civil Defense Corps (NSCDC) Ahmed Abubakar Audi (Commandant General) Nasarawa state North-central
12. Nigeria Immigration Service CGI Isah Jere Idris (Comptroller General of Nigerian Immigration.) Kaduna state North-west
13. National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) Brig. Gen. Mohamed Buba Marwa (Rtd.) Adamawa state North-east
14. Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) Abdulrasheed Bawa Kebbi state North-west
15. Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC) Professor Bolaji Owasanoye SAN Ondo state South-west
16. National Security Adviser Babagana Monguno Borno state North-east

 

TAGGED: 2023 elections, ARISE TV, atiku abubakar, PDP

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom August 7, 2022 August 7, 2022
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Seven ways to detect an AI-generated video

A video announcing the launch of a free nationwide diabetes treatment recently went viral across Nigerian…

August 13, 2025

BLIND SPOT: Nigeria’s shortcomings in the age of AI scams

It sounded exactly like her, but it was not. Adeola Fayehun was thousands of miles…

August 12, 2025

The rise of deepfakes and the fight for digital truth

BY PRUDENCE OKEOGHENE EMUDIANUGHE On May 30, 2025, a 49-minute video surfaced on a YouTube…

August 12, 2025

DISINFO ALERT: Health ministry debunks AI video claiming free nationwide diabetes treatment

The ministry of health and social welfare has dismissed a viral claim alleging the launch…

August 12, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Video wey show as ‘security operatives’ dey break into apartment no be from south-east

One Facebook user don claim sey video wey show as hooded armed security operatives dey break into residential apartment hapun…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

Íhé ńgósị́ ébé ńdị́ ǹché nà-ákpáká ụ́lọ̀ ésiteghị nà south-east

Ótù onye na Facebook ekwuola na ihe ngosị ebe mmadụ na-agbaka ụlọ obibi mmadụ mere na south-east. N'ụbọchị iri abụọ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

Ìṣẹ̀lẹ tí àwọn ‘òṣìṣẹ́ elétò ààbò’ fẹ́ fipá wọ ibùgbé kan kò ṣẹlẹ̀ ní gúúsù ilà oòrùn Nàìjíríà

Ẹni kan tí ó ń lo Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ lórí ayélujára sọ pé fídíò tí ó se afihan àwọn…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

Bidiyon da ake dangantawa da ‘jami’an tsaro’ da suka kutsa cikin gida ba daga kudu maso gabas ba ne

Wani ma’abocin amfani da shafin Facebook ya yi ikirarin cewa wani faifan bidiyo da ke nuna jami’an tsaro dauke da…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 7, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?