Some social media users claim sey Joash Amupitan, di newly nominated chairman of di Independent National Electoral Commission (INEC), bin dey part of di legal team wey defend President Bola Tinubu for di election tribunal.
Some of di users wey publish di post claim sey Amupitan bin no qualify to lead di kontri electoral body sake of di alleged legal services im give Tinubu.
Di claim waka for internet afta Tinubu nominate Amupitan as di new INEC chairman as Mahmood Yakubu, wey complete im two-term of 10 years comot office.
Amupitan, 58, na professor of law for di University of Jos (UNIJOS), Plateau state, where im folo be deputy vice-chancellor (administration).
For news tori published by National Periscope, Coalition of Civil Society Organizations in Nigeria (COCSON) bin allegedly tok sey na Amupitan bi di lead counsel of di All Progressives Congress (APC) and Tinubu for di presidential election petition tribunal for di 2023 elections.
One X user, @dangbanamanger, write sey: “Di National Council of State wey include di President, VP, former Presidents, former Chief Justices, Senate President, Speaker, all Governors, and di AGF approve dis INEC Chairman. Dis same man wey former APC lawyer and part of Tinubu election tribunal legal team. E come be like sey na mumu full di opposition or dem just dey play wit Nigerians head.”
WETIN WE CHECK
To confam di claim weda Amupitan bin dey inside Tinubu legal team, CableCheck look di certified true copies (CTC) of di final tok wey di presidential election petition tribunal and di supreme court give for di 2023 presidential elections mata.
Di CTC dey normally get all di names of lawyers wey represent parties for di case.
CableCheck discover sey Amupitan name bin no dey among di lawyers for di case.
Howeva, we notice sey di name “Taiwo Osipitan” bin dey among di counsel wey represent Tinubu for di case.
E fit dey possible sey di pipu wey share di claim bin dey mistake Taiwo Osipitan for Joash Amupitan.
Taiwo Osipitan, senior advocate of Nigeria, na professor of law for di University of Lagos.
Wole Olanipekun, SAN, na di chief lawyer for Tinubu legal team for di tribunal and di supreme court.
Di counsel wey defend Tinubu, Vice-President Kashim Shettima, Kabir Masari, and di All Progressives Congress (APC) against di petition wey di Allied Peoples Movement (APM) file na:
- L.O. Fagbemi (SAN)
- Adeniyi Akintola (SAN)
- Aliyu O. Saiki (SAN)
- A.M. Rafindadi (SAN)
- Ahmad El-Marzuq (Esq)
- Omosanya Popoola (Esq)
- Folake Abiodun (Esq)
- Wole Olanipekun (SAN)
- Akin Olujinmi (SAN)
- Yusuf All (SAN)
- Babatunde Ogala (SAN)
- Funmilayo Quadri (SAN)
- A.R. Arobo (Esq)
- Akintola Makinde (Esq)
- Yinka Ajenifuja (Esq)
- Rowland Otaru (SAN)
- A.A. Malik (SAN)
- Chris E. Agbiti (Esq)
- Gabriel M. Ishom (Esq)
- Yomi Aliyu (SAN)
- G.M. Ishom (Esq)
- O.R. Iyere (Esq)
- Edeji Adaeze (Esq)
Lawyers wey represent Tinubu, Shettima, and APC for di petition wey Peter Obi, Labour Party 2023 presidential candidate, file na:
- Wole Olanipekun (SAN)
- Akin Olujinmi (SAN)
- Yusuf Ali (SAN)
- Emmanuel Ukala (SAN)
- Talwo Osipitan (SAN)
- Dele Adesina (SAN)
- Hassan Liman (SAN)
- Olatunde Busari (SAN)
- A.U. Mustapha (SAN)
- Kehinde Ogunwumiju (SAN)
- Bode Olanipekun (SAN)
- A.A. Malik (SAN)
- Funmilayo Quadri (SAN)
- Babatunde Ogala (SAN)
- Remi Olatubora (SAN)
- M.O. Adebayo (SAN)
- Emmanuel Uwadoka (Esq)
- Yinka Ajenifuja (Esq)
- Akintola Makinde (Esq)
- L.O. Fagbemi (SAN)
- Charles U. Edosomwan (SAN)
- Adeniyi Akintola (SAN)
- Afolabi Fashanu (SAN)
- Chukwuma Ekomani (SAN)
- Abiodun Owonikoko (SAN)
- Solomon Umoh (SAN)
- Hakeem O. Afolabi (SAN)
- Y.Η.Α.Ruba (SAN)
- Anthony Adeniyi (SAN)
- Mumuni Hanafi (SAN)
- Japhat Opawale (Esq)
- Olanrewaju Akinshola (Esq)
- Huwaila M. Ibrahim (Esq)
Na di lawyers wey defend Tinubu, Shettima, and di All Progressives Congress (APC) against di petition wey Atiku Abubakar,2023 presidential candidate of the Peoples Democratic Party (PDP), file for di tribunal be dis:
- Wole Olanipekun (SAN)
- Akin Olujinmi (SAN)
- Yusuf Ali (SAN)
- Emmanuel Ukala (SAN)
- Taiwo Osipitan (SAN)
- Adebayo Adelodun (SAN)
- Oladele Adesina (SAN)
- Hassan Liman (SAN)
- Olatunde Busari (SAN)
- Kehinde Ogunwumiju (SAN)
- Bode Olanipekun (SAN)
- Funmilayo Quadri (SAN)
- Babatunde Ogala (SAN)
- Remi Olatubora (SAN)
- M.O. Adebayo (SAN)
- A.A. Malik (SAN)
- Yinka Ajenifuja (Esq)
- Akintola Makinde (Esq)
- Julius Ishola (Esq)
- L.O. Fagbemi (SAN)
- Charles U. Edosomwan (SAN)
- Adeniyi Akintola (SAN)
- A. Fashanu (SAN)
- Chukwuma Ekoneani (SAN)
- Abiodun J. Owonikoko (SAN)
- Sam T. Ologunorisha (SAN)
- Solomon Umoh (SAN)
- Hakeem O. Afolabi (SAN)
- Olusola Oke (SAN)
- Aliyu O. Saiki (SAN)
- Y.H.A. Ruba (SAN)
- Anthony Adeniyi (SAN)
- Mumuni Hanafi (SAN)
- Ahmad El-Marzuq (Esq)
- Seun Ajayi (Esq)
- Omosanya Popoola (Esq)
- Adeniji Kazeem (SAN)
For di supreme court, di following lawyers represent Tinubu, Shettima, and di APC:
- Wole Olanipekun (SAN)
- Yusuf Ali (SAN)
- Emmanuel Ukala (SAN)
- Taiwo Osipitan (SAN)
- Akintola Makinde (Esq)
- Akin Olujinmi (SAN)
- Charles Uwensuji Edosomwon
- Adeniyi Akintola (SAN)
- Afolabi Fashanu (SAN)
- Olumide Olujinmi (Esq)
Check copies of di judgment here and here.
FINAL TOK
Available evidence show sey Amupitan bin no dey inside Tinubu legal team for di 2023 election tribunal.