TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Amupitan, INEC chair nominee, bin no dey inside Tinubu legal team for election tribunal
Share
Latest News
Amupitan, ẹni tí Ààrẹ Nàìjíríà ṣẹ̀ṣẹ̀ yàn gẹ́gẹ́bí alága tuntun fún INEC kò sí lára àwọn agbẹjọ́rò fún Tinubu ní ilé ẹjọ́ ìbò
Amupitan, wanda INEC ta zaba, ba ya cikin tawagar lauyoyin Tinubu a kotun zabe
FACT CHECK: Viral video showing ‘Boko Haram taking over army barracks’ NOT from Nigeria
FACT CHECK: Amupitan, INEC chair nominee, wasn’t part of Tinubu’s legal team at election tribunal
Anambra guber: Offences that can get you arrested during elections in Nigeria
Charly Boy yayi da’awar karya kan cewa Dan Nnamdi Kanu yaci gasar ‘kwakwalwa ta Duniya’
Charly Boy no tok true sey Nnamdi Kanu son win ‘international brain competition’
Irọ́ ni Charly Boy pa pé ọmọ Nnamdi Kanu ọkùnrin ṣàṣeyọrí nínú ìdíje àwọn ọlọ́pọlọ pípé ní àgbáyé
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Amupitan, INEC chair nominee, bin no dey inside Tinubu legal team for election tribunal

Claire Mom
By Claire Mom Published October 15, 2025 6 Min Read
Share

Some social media users claim sey Joash Amupitan, di newly nominated chairman of di Independent National Electoral Commission (INEC), bin dey part of di legal team wey defend President Bola Tinubu for di election tribunal.

Some of di users wey publish di post claim sey Amupitan bin no qualify to lead di kontri electoral body sake of di alleged legal services im give Tinubu.

Di claim waka for internet afta Tinubu nominate Amupitan as di new INEC chairman as Mahmood Yakubu, wey complete im two-term of 10 years comot office.

Amupitan, 58, na professor of law for di University of Jos (UNIJOS), Plateau state, where im folo be deputy vice-chancellor (administration).

For news tori published by National Periscope, Coalition of Civil Society Organizations in Nigeria (COCSON) bin allegedly tok sey na Amupitan bi di lead counsel of di All Progressives Congress (APC) and Tinubu for di presidential election petition tribunal for di 2023 elections.

One X user, @dangbanamanger, write sey: “Di National Council of State wey include di President, VP, former Presidents, former Chief Justices, Senate President, Speaker, all Governors, and di AGF approve dis INEC Chairman. Dis same man wey former APC lawyer and part of Tinubu election tribunal legal team. E come be like sey na mumu full di opposition or dem just dey play wit Nigerians head.”

Di claim comot here and here.

WETIN WE CHECK

To confam di claim weda Amupitan bin dey inside Tinubu legal team, CableCheck look di certified true copies (CTC) of di final tok wey di presidential election petition tribunal and di supreme court give for di 2023 presidential elections mata.

Di CTC dey normally get all di names of lawyers wey represent parties for di case.

CableCheck discover sey Amupitan name bin no dey among di lawyers for di case.

Howeva, we notice sey di name “Taiwo Osipitan” bin dey among di counsel wey represent Tinubu for di case.

E fit dey possible sey di pipu wey share di claim bin dey mistake Taiwo Osipitan for Joash Amupitan.

Taiwo Osipitan, senior advocate of Nigeria, na professor of law for di University of Lagos.

Wole Olanipekun, SAN, na di chief lawyer for Tinubu legal team for di tribunal and di supreme court.

Di counsel wey defend Tinubu, Vice-President Kashim Shettima, Kabir Masari, and di All Progressives Congress (APC) against di petition wey di Allied Peoples Movement (APM) file na:

  • L.O. Fagbemi (SAN)
  • Adeniyi Akintola (SAN)
  • Aliyu O. Saiki (SAN)
  • A.M. Rafindadi (SAN)
  • Ahmad El-Marzuq (Esq)
  • Omosanya Popoola (Esq)
  • Folake Abiodun (Esq)
  • Wole Olanipekun (SAN)
  • Akin Olujinmi (SAN)
  • Yusuf All (SAN)
  • Babatunde Ogala (SAN)
  • Funmilayo Quadri (SAN)
  • A.R. Arobo (Esq)
  • Akintola Makinde (Esq)
  • Yinka Ajenifuja (Esq)
  • Rowland Otaru (SAN)
  • A.A. Malik (SAN)
  • Chris E. Agbiti (Esq)
  • Gabriel M. Ishom (Esq)
  • Yomi Aliyu (SAN)
  • G.M. Ishom (Esq)
  • O.R. Iyere (Esq)
  • Edeji Adaeze (Esq)

Lawyers wey represent Tinubu, Shettima, and APC for di petition wey Peter Obi, Labour Party 2023 presidential candidate, file na:

  • Wole Olanipekun (SAN)
  • Akin Olujinmi (SAN)
  • Yusuf Ali (SAN)
  • Emmanuel Ukala (SAN)
  • Talwo Osipitan (SAN)
  • Dele Adesina (SAN)
  • Hassan Liman (SAN)
  • Olatunde Busari (SAN)
  • A.U. Mustapha (SAN)
  • Kehinde Ogunwumiju (SAN)
  • Bode Olanipekun (SAN)
  • A.A. Malik (SAN)
  • Funmilayo Quadri (SAN)
  • Babatunde Ogala (SAN)
  • Remi Olatubora (SAN)
  • M.O. Adebayo (SAN)
  • Emmanuel Uwadoka (Esq)
  • Yinka Ajenifuja (Esq)
  • Akintola Makinde (Esq)
  • L.O. Fagbemi (SAN)
  • Charles U. Edosomwan (SAN)
  • Adeniyi Akintola (SAN)
  • Afolabi Fashanu (SAN)
  • Chukwuma Ekomani (SAN)
  • Abiodun Owonikoko (SAN)
  • Solomon Umoh (SAN)
  • Hakeem O. Afolabi (SAN)
  • Y.Η.Α.Ruba (SAN)
  • Anthony Adeniyi (SAN)
  • Mumuni Hanafi (SAN)
  • Japhat Opawale (Esq)
  • Olanrewaju Akinshola (Esq)
  • Huwaila M. Ibrahim (Esq)

Na di lawyers wey defend Tinubu, Shettima, and di All Progressives Congress (APC) against di petition wey Atiku Abubakar,2023 presidential candidate of the Peoples Democratic Party (PDP), file for di tribunal be dis:

  • Wole Olanipekun (SAN)
  • Akin Olujinmi (SAN)
  • Yusuf Ali (SAN)
  • Emmanuel Ukala (SAN)
  • Taiwo Osipitan (SAN)
  • Adebayo Adelodun (SAN)
  • Oladele Adesina (SAN)
  • Hassan Liman (SAN)
  • Olatunde Busari (SAN)
  • Kehinde Ogunwumiju (SAN)
  • Bode Olanipekun (SAN)
  • Funmilayo Quadri (SAN)
  • Babatunde Ogala (SAN)
  • Remi Olatubora (SAN)
  • M.O. Adebayo (SAN)
  • A.A. Malik (SAN)
  • Yinka Ajenifuja (Esq)
  • Akintola Makinde (Esq)
  • Julius Ishola (Esq)
  • L.O. Fagbemi (SAN)
  • Charles U. Edosomwan (SAN)
  • Adeniyi Akintola (SAN)
  • A. Fashanu (SAN)
  • Chukwuma Ekoneani (SAN)
  • Abiodun J. Owonikoko (SAN)
  • Sam T. Ologunorisha (SAN)
  • Solomon Umoh (SAN)
  • Hakeem O. Afolabi (SAN)
  • Olusola Oke (SAN)
  • Aliyu O. Saiki (SAN)
  • Y.H.A. Ruba (SAN)
  • Anthony Adeniyi (SAN)
  • Mumuni Hanafi (SAN)
  • Ahmad El-Marzuq (Esq)
  • Seun Ajayi (Esq)
  • Omosanya Popoola (Esq)
  • Adeniji Kazeem (SAN)

For di supreme court, di following lawyers represent Tinubu, Shettima, and di APC:

  • Wole Olanipekun (SAN)
  • Yusuf Ali (SAN)
  • Emmanuel Ukala (SAN)
  • Taiwo Osipitan (SAN)
  • Akintola Makinde (Esq)
  • Akin Olujinmi (SAN)
  • Charles Uwensuji Edosomwon
  • Adeniyi Akintola (SAN)
  • Afolabi Fashanu (SAN)
  • Olumide Olujinmi (Esq)

Check copies of di judgment here and here.

FINAL TOK

Available evidence show sey Amupitan bin no dey inside Tinubu legal team for di 2023 election tribunal.

TAGGED: 2023 elections, Amupitan, INEC chairman, News in pidgin

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom October 15, 2025 October 15, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

Amupitan, ẹni tí Ààrẹ Nàìjíríà ṣẹ̀ṣẹ̀ yàn gẹ́gẹ́bí alága tuntun fún INEC kò sí lára àwọn agbẹjọ́rò fún Tinubu ní ilé ẹjọ́ ìbò

Àwọn ènìyàn kan tí wọ́n ń lo àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára sọ pé…

October 15, 2025

Amupitan, wanda INEC ta zaba, ba ya cikin tawagar lauyoyin Tinubu a kotun zabe

Wasu masu amfani da shafukan sada zumunta sun yi ikirarin cewa Joash Amupitan, sabon shugaban…

October 15, 2025

FACT CHECK: Viral video showing ‘Boko Haram taking over army barracks’ NOT from Nigeria

A social media post has attributed certain individuals dressed in camouflage to Boko Haram militants…

October 15, 2025

FACT CHECK: Amupitan, INEC chair nominee, wasn’t part of Tinubu’s legal team at election tribunal

Some social media users claim that Joash Amupitan, the newly nominated chairman of the Independent…

October 11, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Amupitan, ẹni tí Ààrẹ Nàìjíríà ṣẹ̀ṣẹ̀ yàn gẹ́gẹ́bí alága tuntun fún INEC kò sí lára àwọn agbẹjọ́rò fún Tinubu ní ilé ẹjọ́ ìbò

Àwọn ènìyàn kan tí wọ́n ń lo àwọn ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára sọ pé Joash Amupitan, alága tuntun fún…

CHECK AM FOR WAZOBIA
October 15, 2025

Amupitan, wanda INEC ta zaba, ba ya cikin tawagar lauyoyin Tinubu a kotun zabe

Wasu masu amfani da shafukan sada zumunta sun yi ikirarin cewa Joash Amupitan, sabon shugaban hukumar zabe mai zaman kanta…

CHECK AM FOR WAZOBIA
October 15, 2025

Charly Boy yayi da’awar karya kan cewa Dan Nnamdi Kanu yaci gasar ‘kwakwalwa ta Duniya’

Charly Boy, mawakin Najeriya, ya yi ikirarin cewa dan Nnamdi Kanu, shugaban kungiyar masu fafutukar kafa kasar Biafra (IPOB), yaci…

CHECK AM FOR WAZOBIA
October 7, 2025

Charly Boy no tok true sey Nnamdi Kanu son win ‘international brain competition’

Charly Boy, chief Nigerian musician, don claim sey di son of Nnamdi Kanu, leader of di proscribed Indigenous People of…

CHECK AM FOR WAZOBIA
October 7, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?