Some social media users don claim sey one Finnish court give judgment make dem release Simon Ekpa, pro-Biafra agitator, wey don already collect prison sentence.
Plenti social media users bin post di claim for Facebook and Instagram — for wetin resemble copy-and-paste news post trend.
Di post also claim sey di Finnish court give Ekpa $50,000 compensation afta di Nigerian govment allegedly no show court.
Dem join di quote wit judge wey no get name for di post.
“Di Finnish court don officially release Biafran activist Simon Ekpa afta di Nigerian govment no gree appear for court to prove dia allegations against am,” na so di viral post tok.
“According to di court ruling, Ekpa detention bin dey “unlawful and politically motivated,” naim dem give am $50,000 as compensation for di illegal imprisonment.
“Afta im give im final tok, di judge reportedly tok sey:
“Simon Ekpa na free man under Finnish law. Im get evri right to express im views and defend di interests of im people, as long as im dey operate within legal boundaries.”
“Shortly afta dem release am, Simon Ekpa tok sey:
“Dem try silence me, but you no fit put truth for prison. Dis victory no be only my own-e belong to di people of Biafra and everybodi wey dey fight for justice.”
One Facebook page, also known as “I News,” wey get over 167,000 followers, folo publish di claim.
CableCheck notice sey some of di social media users and pages wey post di claim na people wey dey loyal to di separatist leader.
Dem publish di claim here, here, and here.
WETIN HAPUN BEFORE
On September 1, di Päijät-Häme district court for Finland sentence Ekpa to six years in prison for terrorism offences.
Di three-member panel of judges bin find Ekpa guilty of causing terrorism and participating in di activities of terrorist group.
Di court tok sey Ekpa bin use im “significant social media following” to cause tension for Nigeria south-east region between August 2021 and November 2024.
Di court also convict Ekpa of aggravated tax fraud and violating di provisions of di attorneys’ act.
According to di law for Finland, Ekpa get 30 days to file appeal against di district court judgment. That is, di pro-Biafra agitator must file im appeal on or before October 1, 2025.
CableCheck no fit confam weda Ekpa don file appeal, as im lawyer, Kaarle Gummerus, neva respond to our request for informate about di mata.
WETIN WE CHECK
CableCheck search different Finnish media platforms to check weda another court don allegedly release Ekpa as di viral post claim.
No beta media platform report di alleged release.
Since one district court convict am on September 1, no report don comot on weda any appeal court for Finland dey hear di mata as of October 22.
FINAL TOK
Di claim wey tok sey one Finnish court don allegedly release Ekpa no correct.