Charly Boy, chief Nigerian musician, don claim sey di son of Nnamdi Kanu, leader of di proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB), win international world brain competition.
Charly Boy make di claim for tweet on Wednesday.
“Nnamdi Kanu son don shock di the world as e become di first child ever to win English, Mathematics, and Russian Language for one international world brain competition,” na so di post tok.
“Di 11-year-old prodigy outshine di United Kingdom for dia very own language, comot as di champion. E still go defeat some of di strongest young minds for di world, e confam sey e sabi book ontop di global stage.
“Dis historic victory no only place am for evribodi eye but e don folo write im name for di record books as one of di most gifted children for im generation.”
So far, di post don gada 952.2k views, 24k likes, 4.6k retweets, and 689 bookmarks.
Some mixed reactions bin dey among di 1.4k comments. While some users bin dey try verify di informate from Grok, X’s AI assistant, odas welcome di development.
But di informate wey di musician give no complete.
Charly Boy no mention di date, di specifics of the competition including di title, or di winner name.
Na wetin CableCheck find be dis.
WETIN WE CHECK
On June 14-17, di regional British Neuroscience Olympiad (BNO) 2025 bin hapun online. Dem bin hold di national competition for August for London.
Di competition, wey students fit register, dey try inspire young learners to pursue career for neuroscience and oda related STEM fields.
Di regional round competition bin task participants wit questions from neuroscience, while di national competition bin give dem multiple-choice questions, patient diagnosis challenge, togeda wit neuroanatomy and neurohistology tests.
Mehul Rathi win di competi, Pouria Karimi collect second, and Hannah Weissmann chop third.
One separate event wey im name na di “Brain Up International Championship 2025” folo hapun for di UK, wit focus on abacus and mental arithmetic skills for di world.
Dem no publicly list di specific winners of di competition. Howeva, dem mention one Myra Shaikh as di champion for one Instagram post wey bin relate wit one international abacus competition.
International Brain Bee, anoda competition, bin folo hapun but di 2025 world championship event hapun virtually for US.
Di closest tin wey resemble international “world brain competition” for di UK recently na dat BNO event.
CableCheck run Google reverse image search ontop di foto wey Charly Boy post claim sey na Nnamdi Kanu son, and we find different result.
Di foto belong to Alejandro Cooper, one young Namibian actor, wey bin make history for di kontri as im win di ‘Best Youngest African Actor’ award for Burkina Faso on November 16.
Di 12-year-old receive di honour for im role for di film ‘Lukas’, directed by Philippe Talavera
Some Namibian news outlets bin folo report di award.
FINAL TOK
Di foto wey Charly Boy post as Nnamdi Kanu son no correct. E no also clear which “brain competition” im bin dey refer to. Confam competitions wey hapun for di UK dis year no get any winners related to Kanu.