One video wey show as Peter Obi, presidential candidate of di Labour Party (LP) for di 2023 elections, dey allegedly advertise investment platform called “AfriQuantumX” dey trend online.
For di video, Obi dey allegedly tell pipu to invest in for di platform if dem wan get “7 million” evri month.
Di former LP presidential candidate allegedly tok sey dem create di investment platform wit im backing and di support of di federal govment.
“Enough is enough! Our pipu deserve financial freedom now. Evri Nigerian must sabi dis truth today. You fit dey collect N7m evri single month,” na so di voiceover for di video tok.
“More dan 10,000 of our pipu don already quit dia jobs not be because dem dey lazy but because dem don see beta.
“Dem collect early retirement and now dem dey enjoy life. All dis na sake of new financial platform, AfriQuantumX, wey dem develop wit my support, togeda wit di Nigerian govment.”
Di video bin comot for one page identified as “News24”.
Na so di caption tok: “AfriQuantumX — one opportunity wey you no fit miss! Start wit just ₦400,000 and in 7 days you go get ₦2,000,000 for your account. Dis one no be promise, na di real result wey thousands of Nigerians don already dey get. Spots no plenty, registration go soon close — act now!”
WETIN WE CHECK
One link bin folo di post. If you click di post, e go cari you go website wey resemble Channels Television, one national television station for Nigeria. Di logo for di website no dey cari pesin go home page.
Di website get video of Seun Okinbaloye, host of Channels Television’s ‘Politics Today’ programme, as e dey interview Obi.
Dem edit di video make e be like sey Okinbaloye and Obi dey talk about di investment platform.
Anoda clue wey show sey di video no real be sey Obi mouth area bin dey blurry — major sign sey di video na AI.
Closer inspection of di mouth area show sey na anoda mouth dem cut paste.
Wen CableCheck analyse keyframes from di video for Google Lens, we discover sey di original video na from Obi speech during di May 2017 edition of ‘The Platform Nigeria” programme.
The Covenant Nation organise di programme to discuss political, economic, and social issues wey dey affect Nigeria.
Di original video dey here.
Di testimonials for di website folo be AI.
Search for di name “AfriQuantumX” for Google show sey GCB Bank, one financial institution for Ghana, bin earlier release one statement sey notin join dem wit di investment platform.
Di Ghanaian bank tok sey AfriQuantumX use di bank logo to advertise di investment platform.
“GCB Bank PLC wish to alert customers and di general public sey di circulating social media post wey advertise investment named “AfriQuantumX” allegedly from GCB na fake,” na so di statement tok.
“Di post misuse di Bank logo, show video wey no relate, and dey carry users go non-GCB website.
“GCB neva launch any product wit dis name. Di Bank dey advise di public make dem no click, share personal or banking details, and no transfer funds sake of dis post.”
Di techniques wey di originators of “AfriQuantumX” investment platform be like scam and e dey raise red flags.
FINAL TOK
Di video wey show as Obi advertise investment platform na AI. Di advertisement na to mislead di public.