TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Na true sey dem kill Christians for Nigeria dis year pass Palestinians for Gaza?
Share
Latest News
È nwélá ọ́nwụ́ ńdị́ ụ́kà nà Naijiria n’áfọ̀ 2025 kárị́á ọ́nụ́ ọ́gụ́gụ́ ndị́ Palestinian é gbụ́rụ́ na Gaza?
Ǹjẹ́ àwọn ẹlẹ́sìn ìgbàgbọ́ tí wọ́n pa ní Nàìjíríà ju àwọn ọmọ Palestine tí wọ́n pa ní Gaza lọ ní 2025?
Yi Kiristoci da aka kashe a Nijeriya a 2025 sunfi na faltunawan dake Gaza?
FAKE NEWS ALERT: We didn’t declare Iyabo Ojo wanted, say police
MISINFO ALERT: Viral video of clash between tricycle rider, our officers from 2020, says FRSC
DISINFO ALERT: Photo showing European leaders ‘sitting outside Trump’s office’ is doctored
MISINFO ALERT: No evidence Shettima said ‘N8,000 can change the life of a youth’
Ụ́zọ̀ àsáà é jì àmátá íhé ńgósị́ é jìrì AI nwòghárị́á
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Na true sey dem kill Christians for Nigeria dis year pass Palestinians for Gaza?

Claire Mom
By Claire Mom Published August 21, 2025 3 Min Read
Share

One social media post don claim sey di Christians wey die for Nigeria pass Palestinians wey die for Gaza since 2025 begin.

Di post comot for X(formerly Twitter) on Saturday.

“Dis year, dem kill Christians for Nigeria pass Palestinian civilians for Gaza,” di X user identified as Eyal Yakoby tweet give im 181,500 followers.

Di post don gada pass 828,000 views, 32,000 likes, 9,200 reposts, 1,200 bookmarks, and over 800 comments.

But di claim get head so?

HOW MANY PALESTINIAN CIVILIANS DEM DON KILL FOR GAZA?

As of August 17, di death toll for di Gaza Strip bin reach 61,944, according to WAFA, Palestinian news agency.

Di report tok sey di majority of di casualties since di war begin on October 7, 2023, na children and women.

On August 16, di day wey Yakoby tok sey di 2025 Christian deaths for Nigeria pass di total number of Palestinian civilians wey die for Gaza, WAFA put di death toll for 61,897.

Dis year alone (from January to August), 16,223 Palestinians don die, according to di WHO Health Cluster unified dashboard.

Over 70 percent na women and children.

HOW MANY CHRISTIANS DEM KILL FOR NIGERIA DIS YEAR?

According to one report by di International Society for Civil Liberties and Rule of Law (Intersociety) — one pro-Christian civil rights group wey dey always promote sectional interests — dem don kill at least 7,087 Christians inside 2025.

Di report cover di period from January 1 to August 10.

Intersociety dey always look most of di killings for Nigeria as religious mata. Dia reports dey primarily blame di killings ontop Fulani herders, jihadist groups, and oda extremist organisations.

WETIN WE FIND

Di findings show sey di death nombas, wen you look am side by side, no align wit wetin Yakoby claim.

Since di war for Gaza start, more dan 60,000 Palestinians don die.

On year-by-year basis, more dan 16,000 Palestinians don die for Gaza dis year — more than double di nomba of Christians wey dem claim sey die for Nigeria inside 2025.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey dem kill Christians pass Palestinian civilians for Gaza dis year no align wit available data. Despite di heavy pro-Christian and sometimes sectarian views wey Intersociety dey get, di alleged Christian deaths dey significantly lower dan di WHO tally of Palestinian deaths dis year alone.

TAGGED: Christians killed in Nigeria, News in pidgin, Palestinians killed in Gaza

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom August 21, 2025 August 21, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

È nwélá ọ́nwụ́ ńdị́ ụ́kà nà Naijiria n’áfọ̀ 2025 kárị́á ọ́nụ́ ọ́gụ́gụ́ ndị́ Palestinian é gbụ́rụ́ na Gaza?

Ótù ozi na soshal midia ekwuola na enwéla ọnwụ ndị ụka na Naijiria karịa ọnụ…

August 21, 2025

Ǹjẹ́ àwọn ẹlẹ́sìn ìgbàgbọ́ tí wọ́n pa ní Nàìjíríà ju àwọn ọmọ Palestine tí wọ́n pa ní Gaza lọ ní 2025?

Ọ̀rọ̀ kan lórí ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára tí sọ pé iye àwọn ẹlẹ́sìn ìgbàgbọ́…

August 21, 2025

Yi Kiristoci da aka kashe a Nijeriya a 2025 sunfi na faltunawan dake Gaza?

Wani rubutu da aka wallafa a dandalin sada zumunta ya yi zargin cewa an kashe…

August 21, 2025

FAKE NEWS ALERT: We didn’t declare Iyabo Ojo wanted, say police

The Nigeria Police Force (NPF) has denied viral reports claiming that actress Iyabo Ojo was…

August 21, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ǹjẹ́ àwọn ẹlẹ́sìn ìgbàgbọ́ tí wọ́n pa ní Nàìjíríà ju àwọn ọmọ Palestine tí wọ́n pa ní Gaza lọ ní 2025?

Ọ̀rọ̀ kan lórí ohun ìgbàlódé íbaraẹnise orí ayélujára tí sọ pé iye àwọn ẹlẹ́sìn ìgbàgbọ́ (àwọn kristẹni) tí wọ́n ti…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 21, 2025

Yi Kiristoci da aka kashe a Nijeriya a 2025 sunfi na faltunawan dake Gaza?

Wani rubutu da aka wallafa a dandalin sada zumunta ya yi zargin cewa an kashe Kiristoci a Najeriya fiye da…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 21, 2025

Ụ́zọ̀ àsáà é jì àmátá íhé ńgósị́ é jìrì AI nwòghárị́á

Íhé ngosị na-ekwupụta nkesa ọgwụ na-agwọ ọrịa diabetes pụtara ìhè na soshal midia Naịjiria. Íhé ńgósị́ ahụ kwuru na Ali…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 19, 2025

Ọ̀nà méje tí ó lè fi mọ fídíò tí wọ́n fi AI se

Fídíò kan tí ó ń se ìkéde ìtọ́jú aarun suga káàkiri orílẹ̀ èdè Nàìjíríà ti káàkiri orí ohun ìgbàlódé íbaraẹnise…

CHECK AM FOR WAZOBIA
August 19, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?