One social media post don claim sey di Christians wey die for Nigeria pass Palestinians wey die for Gaza since 2025 begin.
Di post comot for X(formerly Twitter) on Saturday.
“Dis year, dem kill Christians for Nigeria pass Palestinian civilians for Gaza,” di X user identified as Eyal Yakoby tweet give im 181,500 followers.
Di post don gada pass 828,000 views, 32,000 likes, 9,200 reposts, 1,200 bookmarks, and over 800 comments.
But di claim get head so?
HOW MANY PALESTINIAN CIVILIANS DEM DON KILL FOR GAZA?
As of August 17, di death toll for di Gaza Strip bin reach 61,944, according to WAFA, Palestinian news agency.
Di report tok sey di majority of di casualties since di war begin on October 7, 2023, na children and women.
On August 16, di day wey Yakoby tok sey di 2025 Christian deaths for Nigeria pass di total number of Palestinian civilians wey die for Gaza, WAFA put di death toll for 61,897.
Dis year alone (from January to August), 16,223 Palestinians don die, according to di WHO Health Cluster unified dashboard.
Over 70 percent na women and children.
HOW MANY CHRISTIANS DEM KILL FOR NIGERIA DIS YEAR?
According to one report by di International Society for Civil Liberties and Rule of Law (Intersociety) — one pro-Christian civil rights group wey dey always promote sectional interests — dem don kill at least 7,087 Christians inside 2025.
Di report cover di period from January 1 to August 10.
Intersociety dey always look most of di killings for Nigeria as religious mata. Dia reports dey primarily blame di killings ontop Fulani herders, jihadist groups, and oda extremist organisations.
WETIN WE FIND
Di findings show sey di death nombas, wen you look am side by side, no align wit wetin Yakoby claim.
Since di war for Gaza start, more dan 60,000 Palestinians don die.
On year-by-year basis, more dan 16,000 Palestinians don die for Gaza dis year — more than double di nomba of Christians wey dem claim sey die for Nigeria inside 2025.
FINAL TOK
Di claim wey tok sey dem kill Christians pass Palestinian civilians for Gaza dis year no align wit available data. Despite di heavy pro-Christian and sometimes sectarian views wey Intersociety dey get, di alleged Christian deaths dey significantly lower dan di WHO tally of Palestinian deaths dis year alone.