One social media post claim sey Francis Nwifuru, govnor of Ebonyi, suspend 25 commissioners and oda appointees becos dem no gree attend im pikin birthday party.
Di claim wey IgboHistory&Facts post for X don gada pass 117k views, 1.3k likes, 777 reposts, and 505 comments.
Dem join foto of Nwifuru, im wife and pikin wit di post. Social media users also post di claim here, here, and here.
On Tuesday, Nwifuru suspend 25 commissioners, 14 senior special assistants, 24 special assistants, and 22 permanent secretaries allegedly becos dem no gree attend important government function.
Di govnor tok sey di affected officials go serve one-month working suspension without salary and dem no go fit sign any official documents during di period.
WETIN WE CHECK
CableCheck review di governor’s Facebook page and we discover sey di foto wey dem use for di claim na from im dota birthday thanksgiving mass, on Sunday, July 27 — two days before dem announce di suspension.
We also folo Monday Uzor, chief press secretary to di Ebonyi governor, tok and im describe di claim as “mischievous”.
Uzor tok sey dem knack di officials suspension sake of sey dem no attend di basic school sports competition, wey di state Universal Basic Education Board (UBEC) organise.
According to am, di govnor bin ask Patricia Obila, im deputy, to represent am for di event and im instruct oda officials to also attend, but most of dem no go,
“Di govnor bin no dey and im bin instruct im deputy to represent am for di grand finale of di Basic School Sports competition wey di Universal Basic Education Board (UBEC) organise. Howeva, most of im commissioners and appointees no attend,” na so Uzor tell CableCheck.
“So, as di govnor hear wetin hapun, im take action, becos no be di first time wey dis tin dey hapun.
“Di pipu wey dey spread dis narrative just dey mischievous. Dem sabi di truth.
“And dat foto wey dey circulate, e no join wit di suspension. Dem bin snap am for private event wey di govnor host for July.”
We also search Obila Facebook page and discover sey di said event bin hapun on Friday, July 25 — two days before Nwifuru dota birthday.
FINAL TOK
Di claim wey tok sey Nwifuru suspend im commissioners and appointees becos dem no gree attend im dota birthday no correct.