TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: No, Emefiele no return N4trn to FG
Share
Latest News
FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated
MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army
Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́
Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true
Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà
Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne
FACT CHECK: Kemi Badenoch’s claim that her children can’t get Nigerian citizenship is false
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

No, Emefiele no return N4trn to FG

Claire Mom
By Claire Mom Published July 4, 2025 4 Min Read
Share

One video wey dey waka for social media show as Facebook user claim sey Godwin Emefiele, di forma govnor of di Central Bank of Nigeria (CBN), return N4 trillion to di federal govment. 

For di video wey last one minute, 15 seconds, one narrator quote im source of information as “di news”.

“I just read for di news sey Emefiele just return N4 trillion. No be N4 million N40 million, or N400 million. No be even N1 billion, N4 billion, N40 billion, N900 billion, N1 trillion or N2 trillion,” na so im tok.

“One pesin, as forma govnor of .., return to di federation account and dis kain pesin dey go church.”

Im ask sey if dem share dat kain moni give Nigerians, “you know how much evribodi go collect?”

Di user tok sey dem “discover” di moni and e no include “di one for foreign account”.

CableCheck discover sey dem post di video on June 29 by one Facebook user wey im name na Gio TV.

Di post don gada pass 9,000 views, 112 likes, and 29 comments, with commentators wey dey express mixed feelings about how true di informate fit be.

WETIN HAPPEN BEFORE

Emefiele dey face plenti charges, including allegations of using im privileged position to buy properties and control serious amount of moni wey dey suspected to be profits of illegal activities.

On November 1, 2024, Deinde Dipeolu, judge of federal high court for Lagos, order di permanent forfeiture of moni (including $2.045 million), seven choice landed properties, and two share certificates of Queensdorf Global Fund Limited Trust wey belong to Emefiele, give di federal government.

Dem reasonably suspect sey dem use profits of illegal activities buy di assets.

Di forfeited properties bin include two fully detached duplexes wey resemble demselves for No. 17b Hakeem Odumosu Street, Lekki Phase 1, Lagos; one undeveloped land, wey measure up to 1919.592 sqm with Survey Plan No. DS/LS/340 at Oyinkan Abayomi Drive (formerly Queens Drive), Ikoyi, Lagos; one bungalow for No. 65a Oyinkan Abayomi Drive (formerly Queens Drive), Ikoyi, Lagos, and one four-bedroom duplex for 12a Probyn Road, Ikoyi.

Odas na one industrial complex under construction ontop 22 plots of land for Agbor, Delta state; eight units of undetached apartment ontop plot of 2457.60sqm for No. 8a Adekunle Lawal Road, Ikoyi, and one duplex togeda with all im accessories ontop plot of land measuring 2217.87sqm at 2a Bank Road, Ikoyi, Lagos.

Howeva, di court of appeal for Lagos overturn di final forfeiture order wey dem issue for di Emefiele assets.

WETIN WE CHECK

CableCheck analyse key frames of di video using reverse image search tools.

Di results reveal sey di footage don dey online since 2023.

Di claim comot for November 2023, wen one X user, @Gen_Buhar, make post about di alleged return of N4 trillion by Emefiele.

Di claim later comot again for January 2024, May 2024, and June 2024.

CableCheck also check confam media platforms wey dey cover di court proceedings and we no find any claim like dat.

Additionally, one Google search bin dey conducted to check di claim. Di results show sey di tori bin no comot from confam sources but na from sake of claims wey no dey correct.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey Emefiele return N4 trillion to di federal govment no correct.

TAGGED: Emefiele, former CBN governor, News in pidgin

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom July 4, 2025 July 4, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated

A video showing a bridge collapse incident is circulating across social media platforms, especially on…

July 24, 2025

MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army

The Nigerian Army says a viral video claiming the arrest of a foreign arms dealer…

July 24, 2025

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị…

July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass…

July 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị enyenwu ụmụ ya ikike ịbụ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass her right of Nigerian citizenship…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà

Kemi Badenoch, arábìnrin tó jẹ́ olórí ẹgbẹ́ òsèlú alátakò tí wọ́n ń pè ní Conservative Party ní orílẹ̀ èdè United…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne

Kemi Badenoch, shugabar jam'iyyar masu ra'ayin rikau ta Burtaniya, ta yi ikirarin cewa ba za ta iya mika hakkinta na…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?