TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Foto wey show as Peter Obi dey kneel down for Tinubu inside Vatican na photoshop
Share
Latest News
FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated
MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army
Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́
Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true
Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà
Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne
FACT CHECK: Kemi Badenoch’s claim that her children can’t get Nigerian citizenship is false
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Foto wey show as Peter Obi dey kneel down for Tinubu inside Vatican na photoshop

Claire Mom
By Claire Mom Published May 24, 2025 4 Min Read
Share

One foto wey don waka for social media show as Peter Obi, presidential candidate of di Labour Party (LP) for 2023, dey kneel down to greet President Bola Tinubu.

Social media users wey post di foto claim sey Obi kneel down greet Tinubu during di inauguration of Pope Leo XIV for Rome, Italian capital.

On May 20, one Facebook user identified as Atu Lazarus post di viral image write: “Peter Obi don win my heart. Im kneel down for my papa. Make im calm down. Im suppose join hand wit Tinubu fix Nigeria”.

Anoda Facebook user identified as Pankwaye Bulus Kanam post di foto write: “Peter Obi bin kneel down for President Bola Ahmed Tinubu for di Vatican church. Di same Obi wey bin dey raise dust against di president”.

Di foto folo comot here, here, and here.

WETIN HAPUN BEFORE

Di installation mass of Pope Leo XIV bin hapun for Saint Peter’s Square inside di Vatican City, on May 18,

Leo bin dey elected as di new leader of di Catholic Church on May 8, afta Pope Francis, di pope before am, die.

Many world leaders, including Tinubu, attend di installation mass.

For di mass, Tinubu bin folo Kayode Fayemi, forma govnor of Ekiti, and Obi, tok. Di both of dem be strong Catholics.

Bayo Onanuga, Tinubu special adviser on information and strategy, publish one statement wey describe as Tinubu greet Obi and Fayemi for di mass.

Onanuga bin tok sey na Fayemi first see di president where im bin sidan wit oda leaders before im cari Obi folo am go “pay homage” to Tinubu.

“As im reach di President, Fayemi scata di tension between Obi and Tinubu. Im tok sey: ‘Mr. President, welcome to our church, and thank you as you for honouring di Pope with your presence.’ President Tinubu, wey sharp, tok sey, ‘Na me suppose welcome you and Peter. Na me be di Head of di Nigerian Delegation.’ Wetin di President tok funny Obi, wey agree wit di President,” na so Onanuga write for X.

Onanuga also post foto of di interaction between di three men for di installation mass.

Obi folo post statement wey tok sey im greet Fayemi and Tinubu for di mass.

Pictures and videos wey show Tinubu togeda wit oda Nigerian religious and political leaders comot for social media afta di event.

As di religious gathering pass, Tinubu and Obi supporters begin argue about how di two politicians dey stand for di world.

As dem dey debate, di viral foto comot for social media.

WETIN WE CHECK

One close look at di viral foto show sey dem touch am to fit di narrative. Na computer dem use put di figures for di viral foto.

The manipulated image

For di viral picture, Obi hand look like sey dem join am — proof sey dem don touch di foto.

More checks also show sey Olusegun Dada, di president special assistant on social media, post di original foto for X on May 18.

For di foto wey Dada post, Tinubu dey sedan only am for front seat as Fayemi and Obi dey try see di president.

Original picture posted by Olusegun Dada via X

Valentine Obienyem, Obi media adviser, release statement wey tok sey di viral foto dey “clearly photoshopped”.

FINAL TOK

Di foto wey show as Obi dey kneel down for Tinubu for Rome na photoshop.

TAGGED: News in pidgin, Obi, Obi kneels for Tinubu, Tinubu

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom May 24, 2025 May 24, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated

A video showing a bridge collapse incident is circulating across social media platforms, especially on…

July 24, 2025

MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army

The Nigerian Army says a viral video claiming the arrest of a foreign arms dealer…

July 24, 2025

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị…

July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass…

July 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị enyenwu ụmụ ya ikike ịbụ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass her right of Nigerian citizenship…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà

Kemi Badenoch, arábìnrin tó jẹ́ olórí ẹgbẹ́ òsèlú alátakò tí wọ́n ń pè ní Conservative Party ní orílẹ̀ èdè United…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne

Kemi Badenoch, shugabar jam'iyyar masu ra'ayin rikau ta Burtaniya, ta yi ikirarin cewa ba za ta iya mika hakkinta na…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?