TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Viral video wey show as Trump dey call for Nnamdi Kanu release na AI
Share
Latest News
Video wey tok sey Nigerian church dey on fire na lie, na Ghana school
Ị́hé ńgósị́ ụ́lọ́ákwụ́kwọ́ Ghana gbáráọ́kụ́ ká á sị́ n’ọ́bụ́ ụ́lọ́ ụ́ká dị́ nà Naijiria
Bidiyon gobarar da ta faru a makarantar Ghana da aka bayyana karya a matsayin kona cocin Najeriya
Ghana ni ìṣẹ̀lẹ iná ní ilé ìwé kan tí àwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ kiri ti ṣẹlẹ̀, kìí se ilé ìjọsìn àwọn Kristẹni ní Nàìjíríà
FACT CHECK: Video of Ghanaian school fire incident falsely described as razed Nigerian church
RoundCheck to host poetry festival on media and information literacy on December 12
Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́
Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Viral video wey show as Trump dey call for Nnamdi Kanu release na AI

Claire Mom
By Claire Mom Published March 2, 2025 2 Min Read
Share

One Facebook page — Republicans for United States of Biafra — don post one video wey dem use artificial intelligence do. For di video, US President Donald Trump bin dey call for di release of Nnamdi Kanu.

Di page wey get more dan 2,700 followers post di video on February 19.

Di video don gada pass 20,000 views, 200 shares, and 40 comments since dem post am.

In di less dan one-minute video, one figure wey resemble Trump dey tok as im go free Kanu, leader of di Indigenous Peoples of Biafra (IPOB), from di Nigerian govment hand.

Trump also allegedly tok sey im administration go make sure sey dem allow “Biafra people” conduct election.

Dem create di page in April 2020 to share and promote contents weu dey support di agitators’ views.

On February 18, di page share one AI-generated video wey show as Trump dey support di mata.

WETIN WE CHECK

Close observation of di video show sey Trump image bin dey digitally manipulated to make am look like sey di US president bin dey deliver speech.

Di mouth region bin no clear, and e look like sey dem put anoda picture ontop di foto to make am look like sey Trump bin dey tok.

CableCheck discover sey di video bin dey created using one website wey dey allow users create AI videos using di foto of some popular celebrities.

Di website dey allow users create AI videos using di images of Trump, Elon Musk, billionaire tech entrepreneur; forms US President Barack Obama; Kanye West, US rapper, among odas.

One feature for di website dey also allow users chuk di words wey dem want for di video.

FINAL TOK
Di video wey dey show as Trump dey call for Kanu release na AI.

TAGGED: Donald Trump, News in pidgin, Nnamdi Kanu

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom March 2, 2025 March 2, 2025
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Video wey tok sey Nigerian church dey on fire na lie, na Ghana school

One TikTok user claim sey jihadists burn church for di northern part of Nigeria. One…

December 12, 2025

Ị́hé ńgósị́ ụ́lọ́ákwụ́kwọ́ Ghana gbáráọ́kụ́ ká á sị́ n’ọ́bụ́ ụ́lọ́ ụ́ká dị́ nà Naijiria

Ótú onye na TikTok ekwuola na ndị jihad a gbaala ụlọ ụka ọkụ na mpaghara…

December 12, 2025

Bidiyon gobarar da ta faru a makarantar Ghana da aka bayyana karya a matsayin kona cocin Najeriya

Wani mai amfani da TikTok ya yi ikirarin cewa mayakan jihadi sun lalata wata Coci…

December 12, 2025

Ghana ni ìṣẹ̀lẹ iná ní ilé ìwé kan tí àwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ kiri ti ṣẹlẹ̀, kìí se ilé ìjọsìn àwọn Kristẹni ní Nàìjíríà

Ẹnì kan tó ń lo TikTok, ibì kan lórí ayélujára tí áwọn ènìyàn ti máa…

December 12, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Video wey tok sey Nigerian church dey on fire na lie, na Ghana school

One TikTok user claim sey jihadists burn church for di northern part of Nigeria. One TikTok user — @WakaWakaplanet —…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 12, 2025

Ị́hé ńgósị́ ụ́lọ́ákwụ́kwọ́ Ghana gbáráọ́kụ́ ká á sị́ n’ọ́bụ́ ụ́lọ́ ụ́ká dị́ nà Naijiria

Ótú onye na TikTok ekwuola na ndị jihad a gbaala ụlọ ụka ọkụ na mpaghara ụ́gwụ́ nke Naịjiria. @WakaWakaplanet jiri…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 12, 2025

Bidiyon gobarar da ta faru a makarantar Ghana da aka bayyana karya a matsayin kona cocin Najeriya

Wani mai amfani da TikTok ya yi ikirarin cewa mayakan jihadi sun lalata wata Coci a yankin arewacin Najeriya. Wani…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 12, 2025

Ghana ni ìṣẹ̀lẹ iná ní ilé ìwé kan tí àwọn ènìyàn ń pín fídíò rẹ̀ kiri ti ṣẹlẹ̀, kìí se ilé ìjọsìn àwọn Kristẹni ní Nàìjíríà

Ẹnì kan tó ń lo TikTok, ibì kan lórí ayélujára tí áwọn ènìyàn ti máa ń fi àwòrán tàbí fídíò…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 12, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?