One social media post don claim sey di federal govment don“privatise secondary school education including unity colleges” for Nigeria.
Di user, identified as Olorunyemi Kehinde Patrick, claim for Facebook sey President Bola Tinubu “unsurprisingly” make di announcement as plans to “introduce anoda form of tax”.
For di post, di user claim sey evri student for public secondary schools suppose pay total of N380,000 per session.
Di user also share breakdown of di fees wey reach N380,000 including tuition fee of N97, 000; N10,000 as boarding fee; N45,000 for textbooks; and N13,000 for exercise books.
Oda fees include N50,000 for uniform; N10,000 for insurance; stationery N5000, and N10,000 for extra lessons.
“Since na from Tinubu, no be news. If to sey e no do am, na dat one for be news,” na so im write.
“Maybe na anoda form of tax for secondary education so dat e go fit see moni buy new planes for Akpabio and Speaker Abbas for all di ” SUPPORT” wey dem don give am to chop Nigerians and finish di kontri.”
Di post don gada 80 likes, 77 comments, and 26 shares by social media users.
HOW WE CHECK DI CLAIM
TheCable notice plenti mistake for di supposed notice laik typography errors and wrong address.
First, one of di fees wey be like sey dem wan spell “school media” na “skool media”.
Also, di user claim sey di fees bin comot from di “office of the director, senior secondary school education operatives” instead of di “office of the director, senior secondary school department” — wey be di correct address.
TheCable also notice sey di signature for di supposed post no rhyme wit di signature of Binta Abdulkadir, di director of senior secondary school education, afta we compare am.
Also, beta news outlets no publish di tori, na only some bloggers share am.
Di federal ministry of education folo dismiss di report, sey na “fraudulent” tori.
Di ministry tok sey di highest amount wey Federal Unity Colleges (FUCs) students don pay na N100,000 wey be for new students. Di moni dey cover dia uniforms and oda writing materials.
Di ministry tok sey di claim na attempt to cause “misinformation and mislead parents of students”.
FINAL TOK
Di claim wey tok sey federal govment don increased fees of Federal Unity Schools to N380,000 no correct.