TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Di flag wey dey behind Tinubu during address no be Russia own
Share
Latest News
MISINFO ALERT: Video of man shot by operative over ‘N5k bribe’ is from 2019, says customs
How to protect yourself from misinformation, disinformation in the AI age
FACT CHECK: Did Ibrahim Traore cancel Burna Boy’s proposed Burkina Faso concert?
CableCheck wins IFCN global fact check fund
Íhé ńgósị́ ébé Peter Obi sékpù àlà n’íhú Tinubu bụ̀ ǹkè é jìrì AI nwóghàrị̀á
Hoton Peter Obi ya durkusa ma Tinubu a Rome na hadi ne
Foto wey show as Peter Obi dey kneel down for Tinubu inside Vatican na photoshop
Peter Obi kò kúnlẹ̀ fún Tinubu ní Rome
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Di flag wey dey behind Tinubu during address no be Russia own

Claire Mom
By Claire Mom Published August 12, 2024 2 Min Read
Share

Some posts for social media don suggest sey one of di flags behind President Bola Tinubu during im national address last Sunday na Russia own.

For televised broadcast, Tinubu tok about di nationwide #EndBadGovernance protest and im call for suspension of di demonstrations, sey make protesters give chance for negotiation.

Tinubu tok sey pipu wey dey take advantage of di protests to cause wahala go enta problem, sey chance no dey for ethnic bigotry for di kontri.

Di president tok wella about im achievements for office, defend im policies, and stress ontop di mata sey di decisions wey im take dey necessary for di economic revival and survival of di kontri.

Two flags bin dey behind di president  — one wey cari di national colours and anoda wit different sign.

“Why Russian flag tanda next to di Nigerian flag? Tinubu dey Russia abi wetin???” na so one X user tweet.

Some comments under one post wey dey ask Nigerians to identify di second flag also tok sey e belong to Russia, wit several social media users wey dey show fear.

Di panic come as some protesters dey wave Russian flags during di protests.

Di flags bin first comot for Kano on di first day of di protest and e don enta Jos, Plateau capital, and di federal capital territory (FCT).

Di protesters bin dey call for Russian President Vladimir Putin intervention for Nigeria, sey Tinubu dey dance to di music of im “masters” — di Western kontris.

WHICH FLAG BIN DEY BESIDE TINUBU?

Di second flag beside di national flag cari four colours — red, blue, white, and green. Na di colours of di presidential standard of Nigeria.

Di four-band flag wey belong to di Nigerian armed forces mean sey Tinubu na di commander-in-chief as well as di president.

E no suppose dey confused with di Russian flag wey get three colours — white, blue, and red.

TAGGED: Fact check in pidgin, News in pidgin, Russian flag, Tinubu

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom August 12, 2024 August 12, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

MISINFO ALERT: Video of man shot by operative over ‘N5k bribe’ is from 2019, says customs

The Nigeria Customs Service (NCS) has reacted to a viral video showing its operatives implicated…

June 5, 2025

How to protect yourself from misinformation, disinformation in the AI age

The internet has made life somewhat easier, right? You want to read the news and…

June 4, 2025

FACT CHECK: Did Ibrahim Traore cancel Burna Boy’s proposed Burkina Faso concert?

There are reports that Ibrahim Traore, Burkina Faso’s military leader, has cancelled Afrofusion star Burna…

June 3, 2025

CableCheck wins IFCN global fact check fund

CableCheck, the fact-checking initiative of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), has been awarded the…

May 30, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

MISINFO ALERT: Video of man shot by operative over ‘N5k bribe’ is from 2019, says customs

The Nigeria Customs Service (NCS) has reacted to a viral video showing its operatives implicated in the shooting of a…

Exclusives & FeaturesFact Check
June 5, 2025

How to protect yourself from misinformation, disinformation in the AI age

The internet has made life somewhat easier, right? You want to read the news and keep abreast of happenings around…

Fact CheckTop Stories
June 4, 2025

FACT CHECK: Did Ibrahim Traore cancel Burna Boy’s proposed Burkina Faso concert?

There are reports that Ibrahim Traore, Burkina Faso’s military leader, has cancelled Afrofusion star Burna Boy's free concert in the…

Fact Check
June 3, 2025

CableCheck wins IFCN global fact check fund

CableCheck, the fact-checking initiative of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), has been awarded the BUILD 2025 grant by the…

Fact CheckTop Stories
May 30, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?