TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: No, Woodberry neva comot prison
Share
Latest News
FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated
MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army
Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́
Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true
Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà
Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne
FACT CHECK: Kemi Badenoch’s claim that her children can’t get Nigerian citizenship is false
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

No, Woodberry neva comot prison

Claire Mom
By Claire Mom Published June 9, 2024 2 Min Read
Share

One social media post claim sey dem don release Olalekan Ponle, aka Woodberry, from prison.

Di post don gada pass 14,000 views, 213 likes and 83 repost on X.

Woodberry is back. I have the feeling that hushpuppi will soon be released. pic.twitter.com/sGCKN8smpr

— Omo Kogi (Yagba)🦅🦍 (@Oladapomikky1) May 29, 2024

Hushpuppi’s friend , woodberry
has being released. He was arrested for fraud in 2020 and released 4 years later . pic.twitter.com/p29Dv4ML3S

— Champion – wtmg. (@Championwtmg) May 29, 2024

WHO BE WOODBERRY?

Woodberry na Naija internet celebrity and friend of Ramon Abbas, aka Hushpuppi, anoda Nigerian wey enta prison sake of internet fraud in November 2022.

On June 10, 2020, dem arrest both of dem for Dubai, United Arab Emirates, ontop extensive international online fraud.

Dem bin come carry dem go di United States for separate trials.

Woodberry, wey bin dey accused of defrauding one US company of $188,000, bin plead not guilty to di charges for over two years.

However, im come change mouth plead guilty to one-count-charge of wire fraud for change of plea hearing in April 2023, at di US District Court for Northern Illinois.

Robert Gettleman, di presiding judge, accept im change of plea for ruling on April 6, convicted am on 8-count charge.

On July 11 2023, dem sentenced Woodberry to 8 years imprisonment, come order am make im pay back about $8 million in restitution to seven of im victims.

WETIN WE CHECK

To confam di claim and check where Woodberry dey, TheCable look di inmate register of The Federal Bureau of Prisons.

The register dey show di name, register number, age, release date and present location of di inmate.

The search show sey Woodberry currently dey di Fort Dix Federal Correctional Institution and im release date na October 2027, two years before Huspuppi go comot.

FINAL TOK

Di claim wey tok sey dem don release Woodberry no correct.

Based on informate from di US Federal Bureau of Prisons, di internet celebrity still dey custody dey serve im 8-year jail term.

TAGGED: Olalekan Ponle, prison, released, Woodberry

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom June 9, 2024 June 9, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated

A video showing a bridge collapse incident is circulating across social media platforms, especially on…

July 24, 2025

MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army

The Nigerian Army says a viral video claiming the arrest of a foreign arms dealer…

July 24, 2025

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị…

July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass…

July 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị enyenwu ụmụ ya ikike ịbụ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass her right of Nigerian citizenship…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà

Kemi Badenoch, arábìnrin tó jẹ́ olórí ẹgbẹ́ òsèlú alátakò tí wọ́n ń pè ní Conservative Party ní orílẹ̀ èdè United…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne

Kemi Badenoch, shugabar jam'iyyar masu ra'ayin rikau ta Burtaniya, ta yi ikirarin cewa ba za ta iya mika hakkinta na…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?