TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Senegal president-elect bin criticise France for viral video?
Share
Latest News
Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́
Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar
Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́
Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu
FACT CHECK: Viral photos of Nigerian Christians bearing arms in churches are misleading
Da’awar cewa Davido da Chioma suna tsammanin ɗansu na uku karya ne
Òótọ́ kọ́ ni ọ̀rọ̀ tó sọ pé Davido àti Chioma ń gbaradì fún ọmọ wọn kẹta
Evidence no dey sey Davido and Chioma dey expect dia third pikin
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Senegal president-elect bin criticise France for viral video?

Claire Mom
By Claire Mom Published April 5, 2024 4 Min Read
Share

If you don dey active for social media platforms in di last 48 hours, you fit don watch one video wey dey supposedly show as Bassirou Diomaye Faye, president-elect of Senegal, dey criticise France.

Dem share di video — wey don go viral for social media for Nigeria and some oda African countries — for TikTok, X(former Twitter), Facebook, LinkedIn, and WhatsApp.

“Time don reach make France comot leg from our neck make dis wicked oppression stop. Hundreds of years of misery, human trafficking, colonialism, and neo-colonialism don cause suffering wey no fit dey measured. Time don reach to end dis cycle of oppression,” na so di speaker tok for di video.

Many pipu wey share di video happy sey Faye, wey dey road to become di youngest elected African president, dey put leg for ground ontop France mata.

One X user, @von_Bismack, with ova 100,000 followers, post di video on Tuesday afternoon. Since im post di clip, e don gada 500 likes, 333 retweets, 32 comments, and ova 20,000 views. Di link don dey archive for here.

“Time don reach make France leave Africa alone”…Mr. Bassirou Diomaye Faye, di newly sworn-in president of Senegal. Dis simply show as France popularity don dey reduce for Africa,” na so di X user caption di video.

For Facebook, O’Kay Adedayo post di video with di caption: “Africa don wake. Make God protect di new Senegalese president. Nigeria dey next in 2027. No more puppet regime for anybody. Time don come to start to jump into di developed world economically.”

WETIN WE CHECK

TheCable check different keyframes for di viral video inside reverse image search, observe sey di clip na from di speech wey Ousmane Sonko, Senegal top opposition leader, give for one press conference for July 2021, in Dakar, Senegal.

Sonko bin give im speech for French, no be English, as e dey for di viral video.

During di press conference, di opposition leader no free for di proposed decision of di Senegalese govment to adopt one anti-terrorism law.

Im bin also criticise France for wetin im describe as di inability of di European kontri to allow dia former colonies thrive.

Dem live-stream di press conference for di YouTube channel of Senegal 7, one local media outlet for di French-speaking kontri. Throughout di one-hour and thirty-minute press conference, Sonko tok for French.

Im folo publish di full transcript of di press conference for im X account. Di transcript also dey for French.

TheCable also discover sey di deepfake technology wey dem use change Sonko voice for di clip give di impression sey im speak for English.

Furthermore, we still discover sey di viral portion of di speech wey dem attribute to di Senegalese president-elect don dey YouTube since 2023.

ANYTIN JOIN SONKO AND FAYE?

Sonko na di leader of Patriots of Senegal (PASTEF), di political party wey sponsor Faye for di presidential election.

Many political analysts for Senegal believe sey Faye na protégé of Sonko. Both men bin dey prison in di build-up to di presidential election but dem release dem weeks before di election.

Howeva, di kontri supreme court ban Sonko from contesting di election. In response, PASTEF put Faye as dia standard bearer.

FINAL TOK

Di speaker for di viral video wey dey criticise France no be Faye, di Senegalese president-elect, but Sonko, di leader of PASTEF. Di viral video na manipulated version of one press conference wey Sonko hold for 2021.

TAGGED: Bassirou Faye, France

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom April 8, 2024 April 5, 2024
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke…

December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church…

December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní…

December 4, 2025

Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu

Afta bandits attack worshippers Christ Apostolic Church (CAC) branch for Oke Isegun inside di Eruku…

December 4, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ị́hé ńgósị́ ébé ńdị́ ụ́ká Naijiria jị́ égbè n’ụ́lọ́ ụ́ká ézị́ghị́ézị́

Ka ndị omekome wakpochara ndị gara ụka na Christ Apostolic Church (CAC) dị na Oke Isegun n'obodo Eruku nke Kwara…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Hotunan da ke yawo na kiristocin Najeriya rike da makamai a coci suna yaudarar

Biyo bayan harin da wasu ‘yan bindiga suka kai kan mabiya cocin Christ Apostolic Church (CAC) a reshen cocin Christ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Àwọn fọ́tò tó sàfihàn àwọn ọmọ Nàìjíríà ẹlẹ́sìn Kristẹni tí wọ́n di nnkan ìjà mọ́ra kò seé gbàgbọ́

Lẹ́hìn ìgbà tí àwọn oníwà jàgídíjàgan kan kọlu àwọn ènìyàn tí wọ́n ń jọ́sìn ní ẹ̀ka Christ Apostolic Church (CAC)…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

Viral foto wey show as Nigerian Christians dey cari gun for church dey mislead pipu

Afta bandits attack worshippers Christ Apostolic Church (CAC) branch for Oke Isegun inside di Eruku community for Kwara state on…

CHECK AM FOR WAZOBIA
December 4, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?