TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Sylva greet Diri for house afta im win Delta govnorship election?
Share
Latest News
Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́
Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true
Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà
Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne
FACT CHECK: Kemi Badenoch’s claim that her children can’t get Nigerian citizenship is false
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?
Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Sylva greet Diri for house afta im win Delta govnorship election?

Claire Mom
By Claire Mom Published November 26, 2023 5 Min Read
Share

One video wey Timipre Sylva, former minister of state for petroleum resources, dey shak hand wit Douye Diri, govnor of Bayelsa state, don comot for internet. 

According to di pipu wey post di video, Sylva bin dey congratule Diri sake of im victory for di Bayelsa govnorship election wey hapun on Saturday.

Diri, wey bin contest ontop di Peoples Democratic Party (PDP), chop 175,196 votes, troway Sylva of di All Progressives Congress (APC), wey gada 110,108 votes.

Di video wey don dey circulate for social media, especially X, don gada thousands of views and engagements.

“Chief Timipre Sylva, di candidate of APC don visit Govnor Douye Diri of PDP to congratulate am. Abeg, no die for dia fight. Imagine di pipu wey don die ontop notin. E too pain,” na so one X user wey share di video write.

Chief Timipre Sylva, the candidate of APC pays congratulatory visit to Governor Douye Diri of PDP. Those who died in the course of the #BayelsaDecides2023 contest died for nothing.

Good thing is that Governor Diri will concentrate on development of the state. pic.twitter.com/gzRpRDAjuh

— Tonye Barcanista (@TonyeBarcanista) November 15, 2023

For di video wey don dey everywhere, Sylva dey shak Diri hand wella, come dey tok wit am but di audio no clear. 

Anoda X user write sey: “Chief Timipre Sylva, di candidate of APC don visit Govnor Douye Diri of PDP to congratulate am. Di pipu wey kpai ontop #BayelsaDecides2023 mata die for notin. Di good tin be sey Govnor Diri go concentrate on di development of di state.”

WHY WE SUPPOSE CHECK DI CLAIM 

Even though permanent enemies no dey for politics, Sylva and Diri no dey jam as e be so, sake of how di Bayelsa govnorship election comot.

On election day, Diri bin tok sey Sylva dey chook hank for wetin go increase violence during di electoral process.

“Timipre Sylva dey cari violence come for every election. If you rememba, di leader of di Ijaw nation, elder Edwin Clark, bin write letter to ask am why e no wan gree drop di violent way im dey take win election,” na so Diri bin tok afta im cast im vote.

“Anyhow e be, God dey throne and we no go gree for am for di violent way im dey take win election.”

On im part, Sylva claim sey di PDP bin cause violence during di election. Di former minister bin also tok sey security agencies bin dey “play on di side of di PDP”.

“PDP dey bring plenty violence to attack our voters wit security (agents). In fact, in some cases, our pipu believe sey our election no be against PDP, but na against security (agents) but we dey chuk head small small,” na so Sylva tok.

WETIN WE CHECK

TheCable cari reverse image search check some of di screenshots from di video, and e cari us go one TikTok account wey get GbaramatuVoiceTV as im username.

GbaramatuVoiceTV bin post di video in May 2023, six months before di govnorship election in Bayelsa.

Di video bin get one caption wey dem write: “HE Timipre Sylva attend HE Douye Diri fada burial for Sampou.”

Diri fada, di late Pa Abraham, retired headmaster, bin die on February 12, 2023, at di age of 88. Dem bury am on May 6.

Di GbaramatuVoiceTV TikTok account also get some oda posts of different events, including weddings and anniversaries.

FINAL TOK

Di video don tey and no be visit wey Sylva go meet Diri to congratulate am sake of im election win.  

Dem shoot di video, come post am in May 2023 wen Sylva visit Diri to show am support as im papa die. 

Even as Diri don hail INEC for di election wey dem do, di APC for di state no gree for im victory and dem tok sey make INEC cari eye look di results again within one week.

TAGGED: Bayelsa guber election, Bayelsa State, Douye Diri, Off-cycle election, timipre sylva

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom November 26, 2023 November 26, 2023
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị…

July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass…

July 22, 2025

Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà

Kemi Badenoch, arábìnrin tó jẹ́ olórí ẹgbẹ́ òsèlú alátakò tí wọ́n ń pè ní Conservative…

July 22, 2025

Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne

Kemi Badenoch, shugabar jam'iyyar masu ra'ayin rikau ta Burtaniya, ta yi ikirarin cewa ba za…

July 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị enyenwu ụmụ ya ikike ịbụ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass her right of Nigerian citizenship…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà

Kemi Badenoch, arábìnrin tó jẹ́ olórí ẹgbẹ́ òsèlú alátakò tí wọ́n ń pè ní Conservative Party ní orílẹ̀ èdè United…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne

Kemi Badenoch, shugabar jam'iyyar masu ra'ayin rikau ta Burtaniya, ta yi ikirarin cewa ba za ta iya mika hakkinta na…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?