TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: To first pour water for head wen pesin dey baff dey cause stroke?
Share
Latest News
Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́
Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true
Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà
Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne
FACT CHECK: Kemi Badenoch’s claim that her children can’t get Nigerian citizenship is false
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Ǹjẹ́ Nàìjíríà dá àjọṣe lórí àwọn àlùmọ́ọ́nì láàárín òhun àti Amẹ́ríkà dúró nítorí visa?
Nigeria stop ‘mineral deal’ with US afta visa restriction?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

To first pour water for head wen pesin dey baff dey cause stroke?

Claire Mom
By Claire Mom Published October 31, 2023 5 Min Read
Share

One report wey dey for internet claim sey pipu dey get stroke wen dem dey baff becos dem dey pour water for head first.

Di report claim sey wen pesin start to dey baff like dis, blood dey quick rush go head cause di arteries for inside head jam, next tin stroke go follow.

“According to different studies around di world, di nomba of pipu wey don kpai or get paralysis sake of stroke during baff dey increase evriday. According to doctors, pesin suppose dey obey instructions wen dem dey baff,” na so di article tok.

“If you dey baff wey you no obey di correct instruction, you fit kpai.”

Di tori wey don dey evriwhere for social media add sey doctors advise sey make pesin no dey pour water for head first wen im dey baff becos e fit increase di way wey blood dey flow, wey go increase di chances of stroke, especially for those pipu wey get high blood pressure, high cholesterol, or migraines.

Di post advise sey wen pesin dey baff, make e first start from leg, dey cari am go up small small before im reach head.

TheCable check see sey di article don dey internet since 2019, when one Facebook user, Mohammd Ullah, share am for im profile.

Anoda Facebook user bin folo share di post in 2020 wey e gada pass 300 reactions, 170 shares, and 65 comments.

Even for 2021 and 2022, dem share di article plenti times.

In di past few weeks, di tori begin dey waka again for internet, wit di same words and di same foto.

TINS WEY DEY CAUSE STROKE AND HOW E DEY AFFECT BRAIN

According to di US Centre for Disease Control (CDC), stroke dey hapun wen blood no dey gree flow to some parts of di brain again or wen blood vessel inside di brain burst. When di tin hapun, parts of di brain go spoil or die. Di CDC tok sey stroke fit cause lasting brain damage, long-term disability, or even death.

TheCable check some medical websites including di UK national health service, Mayo Clinic ,and Johns Hopkins Medicine, to check di tins wey fit cause stroke.

Some of di things dem mention include high blood pressure (hypertension), obesity, high cholesterol levels, diabetes, excessive alcohol intake, stress, age, family history, and ethnicity.

None of di medical websites tok anytin about di “wrong way to baff” as problem wey dey cause stroke.

‘NOTHIN JOIN STROKE WIT DI WAY PESIN DEY BAFF’

Omojowolo Olubunmi, stroke physician and neurologist for di UK, tell TheCable sey di claim no correct.

Im explain sey wen pesin pour water for head, e dey mainly affect some of di blood vessels wey no too dey important, and e go make dem either shrink or expand based on di water temperature.

“However, no be those blood vessels dey cause stroke. Na di blood vessels wey dey deep inside di brain dey cause stroke. Water no dey affect those ones. So di claim no get scientific head,” na so im tok.

“Stroke no dey hapun like dat. Specific reasons dey wey dey cause stroke. E no get anytin to do wit how you baff, whether you pour water for head or leg first. E no change anytin, notin join stroke wit am at all.

“Wetin dey cause stroke na clearly recognised problem like hypertension, diabetes, atrial fibrillation, irregular heartbeats, some types of stroke na becos of haemorrhages, dat is, wen blood dey enta brain.”

FINAL TOK

Di claim wey tok sey to pour water for head first dey cause stroke no correct. Science no support di claim.

TAGGED: causes of stroke, Fact Check, Fact check pidgin, Pidgin news

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom October 31, 2023 October 31, 2023
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị…

July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass…

July 22, 2025

Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà

Kemi Badenoch, arábìnrin tó jẹ́ olórí ẹgbẹ́ òsèlú alátakò tí wọ́n ń pè ní Conservative…

July 22, 2025

Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne

Kemi Badenoch, shugabar jam'iyyar masu ra'ayin rikau ta Burtaniya, ta yi ikirarin cewa ba za…

July 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị enyenwu ụmụ ya ikike ịbụ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass her right of Nigerian citizenship…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà

Kemi Badenoch, arábìnrin tó jẹ́ olórí ẹgbẹ́ òsèlú alátakò tí wọ́n ń pè ní Conservative Party ní orílẹ̀ èdè United…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne

Kemi Badenoch, shugabar jam'iyyar masu ra'ayin rikau ta Burtaniya, ta yi ikirarin cewa ba za ta iya mika hakkinta na…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?