TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: No, di Canadian wildfires no bi planned mata
Share
Latest News
FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated
MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army
Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́
Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true
Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà
Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne
FACT CHECK: Kemi Badenoch’s claim that her children can’t get Nigerian citizenship is false
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

No, di Canadian wildfires no bi planned mata

Claire Mom
By Claire Mom Published July 18, 2023 5 Min Read
Share

Since di Canadian wildfires start as we enta new year, different pipu for social media claim sey dem plan di wild fire.

“Na set-up,” na so dem write for one video wey dem post in June for Instagram. Di video gada more dan 17,800 likes.

Anoda post for Instagram follow tok sey di wildfire come dey look like sey na planned mata.

For di video wey dey evriwhere, you fit hear di voice of plenty pipu wey dey watch as di wildfire dey burn for inside TV. Ontop di TV screen, you fit see as helicopter dey drop fire for di trees wey dey forest.

“Na so dem take start di fire”, na so one person wey dey watch TV tok. “Dem set am up”

“Video show as helicopter dey drop fire for trees for Canada,” na so anoda post talk.

CANADA ENTA RECORD FOR WILDFIRE

Since 2023 start, na so Canada just dey count plenti wildfire. As e dey hapun, na so smoke sef dey follow, come even enter some parts of US. For June like dis, di kontri don count more dan 400 wildfires, and as e dey burn dey go, more dan half of di fire no get control at all.

Di nomba of Canadians wey don run comot for dia house sake of di kasala don reach thousands. Di mata also make di kontri take break for oil and gas production.

On Thursday, July 7, some ogas for top tok sey di fire wey start bin just near to finish, dem even talk sey di fire break record for di area wey e burn, di money wey dem use stop di fire, and di pipu wey no get choice but to comot for dia house on top di fire mata.

Di question bi sey, di Canadian fire na planned issue?

TheCable check di video wey dey evriwhere come see sey e get one logo wey dem write British Columbia Wildfire Service for di bottom right-hand corner.

We cari eye, come use computer look di mata wella, come discova di original video wey dey YouTube. Dem title am: “Donnie Creek Wildfire – Planned Ignition Update June 2, 2023”.

VIDEO SHOW SEY E GET PLAN WEY SUPPOSE HELP REDUCE DI PLENTI WILDFIRE 

As e show for di Youtube video wey get clear message, di plan wey di Britsh Columbia Wildfire Service bin get na to help manage di wildfire. Dem bin use fire manage fuel.

Di video wey show as helicopter dey drop fire on top tree for forest no mean sey di wildfire na planned mata. Instead e show planned ignition wey hapun for June for Donnie creek.

Dis kain ignition na important tactics wey dem dey use manage wildfires. Dem dey use am manage fire incident wen dem cari am come di edge of control lines, so dat di fire no go too spread.

Di pipu wey dey quench fire dey use am manage plenti fire wey start. Inside di process, dem go remove plenti fuel wey don dey before di wildfire, so dat fuel no go come dey plenti again wey go make di fire burn wella.


For one video wey dem post for di YouTube channel of di British Columbia Wildfire Service, pipu wey sabi di mata explain how di planned ignition dey work.

Dem tok sey di planned ignition dey help to “reduce fire wey dey spread anytime wen dem comot di fuel wey dey between di fire perimeter and di control line – one barrier wey dey natural or wey dem fit construct to help manage fire”.

Usually, di area wey di fire dey burn no normally get shape. But di planned ignition dey come make di perimeter dey straight, and since di areas wey don burn no fit burn again, e dey help make way so dat pipu wey wan control di fire go fit reach am easily.

Dis strategy dey help make efforts wey dey reduce fire dey safe and efficient. 

FINAL TOK

Di Instagram video dey misyarn. E no show anywhere sey di wildfires for Canada na planned mata. E only show sey na planned ignition, wey di British Columbia Wildfire Service use, so dat dem go fit control fire wen e dey burn.

TAGGED: Canadaian wildfire, Climate Change, Climate disinformation

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom July 18, 2023 July 18, 2023
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated

A video showing a bridge collapse incident is circulating across social media platforms, especially on…

July 24, 2025

MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army

The Nigerian Army says a viral video claiming the arrest of a foreign arms dealer…

July 24, 2025

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị…

July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass…

July 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị enyenwu ụmụ ya ikike ịbụ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass her right of Nigerian citizenship…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà

Kemi Badenoch, arábìnrin tó jẹ́ olórí ẹgbẹ́ òsèlú alátakò tí wọ́n ń pè ní Conservative Party ní orílẹ̀ èdè United…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne

Kemi Badenoch, shugabar jam'iyyar masu ra'ayin rikau ta Burtaniya, ta yi ikirarin cewa ba za ta iya mika hakkinta na…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?