TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: To swallow semen fit make person body relax?
Share
Latest News
FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated
MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army
Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́
Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true
Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà
Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne
FACT CHECK: Kemi Badenoch’s claim that her children can’t get Nigerian citizenship is false
Naijiria ọ̀ kàgbùrù ńkwékọ́rị́tá àzụ́máhị́á àkụ̀ ọ̀nàtàràchí yá nà US nwèrè n’íhì ḿmáchí visa?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

To swallow semen fit make person body relax?

Claire Mom
By Claire Mom Published October 3, 2022 5 Min Read
Share

One Twitter post claim sey when pesin swallow semen, e dey help am sleep well, comot stress for body, and make am no dey overthink.

“If you swallow semen, you no go dey depressed; if you swallow semen, your mood go jolly; if you swallow semen, e go comot stress for your body; if you swallow semen, you no go overthink; if you swallow semen, you go begin dey sleep well,” na so di tweet tok.

Swallowing Semen can help deal with depression
Swallowing semen can boost mood
Swallowing semen can help with stress
Swallowing semen can help deal with anxiety
Swallowing semen can help regulate sleep cycle
Don’t Read Without sharing

— Dr Penking™🇳🇬🇦🇺 (@drpenking) September 6, 2022

Di post gather pass 8,700 likes and 4,300 retweets.

Dem share di post for some Facebook accounts plus one wey im name na Nurse Practitioner.

Semen, wey get anoda name as seminal fluid, dey comot from di male reproductive tract during sexual activities. Di thick liquid wey wan resemble white colour contain sperm cells wey fit fertilize di eggs wey dey woman body.

Semen get plenti tins inside am including vitamin C, B12, ascorbic acid, calcium, citric acid, fructose, lactic acid, magnesium, zinc, potassium, sodium, fat, and some oda proteins.

WETIN RESEARCH TOK?

Even though health experts never too do research to check weda benefits dey ontop swallowing semen, plenti tori for internet dey make di same claim.

Many of di tins wey dem sey swallowing semen dey do for body na because of di tins wey full inside am and how those proteins dey take help body normally.

TheCable check see sey na one study wey dem do since 2002 na im pipu dey use make all these claims. Dem been study 293 sexually active women, come check di connect between semen and dia mood. Dem discover sey di women wey get direct exposure to semen been no too dey depressed like oda women.

But di study bin only focus on semen wey dey enter vagina instead of for mouth, and e tok sey di results na “di first test so di answers no too correct”.

Anoda study wey pipu dey folo quote na one wey comot for 2015. E tok sey semen contain melatonin wey bi di  natural chemical for body wey dey help pesin sleep. Di study only focus on how melatonin dey affect man fertility. E no tok anything about how di melatonin for semen dey affect pesin wey swallow am.

WETIN EXPERTS TOK?

TheCable come folo some medical experts tok to confam if science support di claim.

Best Ordinioha, professor of public health and community medicine, sey notin jam pesin wey swallow semen wit all those benefits wey pipu claim.

“If any advantage even dey, maybe na from di main sex and no be because pesin swallow am. Na true say semen get some kain nutrients but di nutrients na to help di sperm wey dey go fertilize di egg. Di nutrients no bi di kain one wey go come dey help body. Na just small calories we dey tok about here,” na so im tok.

“You know sey some pipu no dey feel comfortable to dey swallow semen during sex so e fit be sey di pesin wey make di claim just dey use style encourage dem. Sometimes make pipu dey carry eye check wetin dey di mind of di pesin wey make di claim.”

Ayo Ajeigbe, clinical psychologist, sey these claims no correct because beta research never comot to support am.

“Most of these claims go just pick one or two things come relate am to each other. Just because sey sperm contain melatonin no mean sey e dey help pesin wey swallow am,” na so im tok.

“If to sey research dey support am, e for don be solution for pipu wey get some kain problems. In fact, dem for even use am do medicine make pipu swallow.”

Di psychologist come sey most of di studies wey dey support di claim no test plenti pipu and e no dey enough to come up with that kain conclusion. Also, di semen wey dey comot from man body too small to get all di kain nutrients wey go fit benefit the body well well.

FINAL TOK

Di claim wey sey to swallow semen dey help cure depression, make your mood jolly, reduce stress and overthinking, and to help with sleep no dey confam. Beta research neva comot to support di claims.

TAGGED: Fact check pidgin, Oral Sex, semen

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom October 3, 2022 October 3, 2022
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

FACT CHECK: Video showing ‘bridge collapsing in Nasarawa’ is AI-generated

A video showing a bridge collapse incident is circulating across social media platforms, especially on…

July 24, 2025

MISINFO ALERT: Viral video of ‘foreign arms dealer’ in Zamfara is from 2021, says army

The Nigerian Army says a viral video claiming the arrest of a foreign arms dealer…

July 24, 2025

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị…

July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass…

July 22, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ókwú Badenoch nà ụ́mụ̀ yá ápụ̀ghị̀ ínwétá íkíké ị́bụ ńdị́ Naijiria bụ̀ àsị́

Kemi Badenoch, onye ndú òtù Conservative Party nke obodo United Kingdom, ekwuola na ọ gaghị enyenwu ụmụ ya ikike ịbụ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Kemi Badenoch claim sey her children no fit get Nigerian citizenship but she no tok true

Kemi Badenoch, leader of di United Kingdom Conservative Party, claim sey she no fit pass her right of Nigerian citizenship…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Irọ́ ni Kemi Badenoch pa pé òfin kò fààyè gba àwọn ọmọ òhun láti di ọmọ Nàìjíríà

Kemi Badenoch, arábìnrin tó jẹ́ olórí ẹgbẹ́ òsèlú alátakò tí wọ́n ń pè ní Conservative Party ní orílẹ̀ èdè United…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

Maganar Kemi Badenoch na cewa ‘ya’yanta ba za su iya samun shaidar zama dan Najeriya ba karya ne

Kemi Badenoch, shugabar jam'iyyar masu ra'ayin rikau ta Burtaniya, ta yi ikirarin cewa ba za ta iya mika hakkinta na…

CHECK AM FOR WAZOBIA
July 22, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?