TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Naija fuel na di cheapest for di world as Eniola Badmus tok?
Share
Latest News
Ṣé àwọn ọmọ ológun Nàìjíríà lo àwòrán tó ti pẹ́ gẹ́gẹ́bí àwòrán iṣẹ́ igbanisilẹ̀ tí wọ́n se láìpẹ́ yìí?
Na true sey di Nigerian army use old foto for recent rescue operation?
Shin sojojin Najeriya sun yi amfani da tsofaffin hotuna don aikin ceto kwanan nan?
Ọ̀rọ̀ tí Tinubu sọ lórí owó orí tí Trump fi síta ni àwọn sa sìse pè ní ọ̀rọ̀ Ààrẹ Nàìjíríà lórí àwọn tí Amẹ́ríkà ń ṣọ́
Tinubu speech ontop Trump tariff dey misrepresented as recent comment ontop US watchlist
Maganan Tinubu akan sharhi na baya-bayan nan akan jerin sa ido na Amurka
FACT CHECK: Did Nigerian army use old pictures for recent rescue operation?
FACT CHECK: Tinubu’s speech on Trump’s tariff misrepresented as recent comment on US watchlist
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Naija fuel na di cheapest for di world as Eniola Badmus tok?

Claire Mom
By Claire Mom Published July 31, 2023 6 Min Read
Share

Eniola Badmus, one Nollywood actress, tok sey even as dem comot petrol subsidy, fuel price for Nigeria na still di cheapest for di world. 

Di actress, pesin wey no dey hide to support President Bola Tinubu, make di claim wen Daddy Freeze, media pesin, invite her make she tok for im Instagram live.  

Badmus tok sey many of di pipu wey dey use mouth finish Tinubu govment no sabi di beta wey come as dem remove petrol subsidy. 

“As Naija citizen, I get right for wetin I dey tink. I fit support anybodi wey I wan support,” na so she tok.

“All dis pipu wey go just gada for phone dey type no even sabi wetin subsidy bi. Na wen govment comot am naim dem come sabi wetin dey hapun. Even now laik dis, bi like sey na us still dey buy di cheapest fuel for di whole world. 

“President Tinubu tanda gidigba. Comot di support wey I dey support am, I don see wetin im dey do and I know wetin e go do. I neva see pesin wey kind wey get good heart like di wey our current presido bi. Till e comot from dia, I go dey by im side.”

DI PETROL SUBSIDY WEY DEM COMOT

On May 29, Tinubu, as im dey give im first speech as presido, tok sey petrol subsidy no dey again.  

“Ontop fuel subsidy mata, unfortunately, di moni wey dem kip before I enta office show sey no space dey for fuel subsidy. So fuel subsidy no dey again,” na so im tok.

Im add sey di moni wey dey increase ontop subsidy no make sense again especially as resources dey finish for kontri. 

“We salute wetin di forma govment do as dem comot petrol subsidy wey bin dey favour di rich pass di poor,” na so im tok.

“Instead, we go shift di moni do beta investment for public infrastructure, education, health care and jobs wey go improve di lives of millions of pipu.”

Afta Tinubu make im speech, e no tey wey petrol price jump from N190 per litre pass N500 per litre.

On July 18, oil marketers again increase di price of petrol for stations go N617 per litre for Abuja and N568 per litre for Lagos. 

But na true sey fuel for Nigeria na di cheapest for di world? TheCable check di price of petrol for different kontris for di world and na wetin we find bi dis. 

AS WE CHECK DI PRICE OF PETROL FOR DI WORLD

According to Globalpetrolprices, world market leader wey dey track di prices of motor fuel, electricity, and natural gas for over 150 countries, di oil wey dem dey sell for Venezuela na di cheapest for di world. Di current price na N3.1274 per litre.

TheCable still check more informate see sey aside from Venezuela, e still get 20 other kontris wey dem dey sell petrol for less dan N617.

Di kontris na; Iran, Libya, Algeria, Kuwait, Angola, Egypt, Turkmenistan, Malaysia,Kazakhstan, Bahrain, Bolivia, Iraq, Qatar, Azerbaijan, Russia, Oman, Saudi Arabia,Ecuador, Kyrgyzstan, and Afghanistan.

S/N Country Price in $ as of July 24 CBN Exchange rate on July 24 price in Naira
1. Venezuela 0.004 781.85 3.1274
2. Iran 0.029 781.85 22.67365
3. Libya 0.031  781.85 24.23735
4. Algeria* 0.34 781.85 265.829
5. Kuwait* 0.342 781.85 267.3927
6. Angola 0.364  781.85 284.5934
7. Egypt* 0.372 781.85 290.8482
8. Turkmenistan 0.429 781.85 335.41365
9. Malaysia* 0.448 781.85 350.2688
10. Kazakhstan 0.488  781.85 381.5428
11. Bahrain 0.531  781.85 415.16235
12. Bolivia* 0.542  781.85 423.7627
13. Iraq 0.573  781.85 448.00005
14. Qatar* 0.577  781.85 451.12745
15. Azerbaijan 0.588  781.85 459.7278
16. Russia* 0.589 781.85 460.50965
17. Oman* 0.621 781.85 485.52885
18. Saudi Arabia* 0.621 781.85 485.52885
19. Ecuador* 0.634 781.85 495.6929
20. Kyrgyzstan* 0.741 781.85 579.35085
21. Afghanistan 0.743 781.85 580.91455
22. Nigeria 0.778 781.85 608.2793
23. UAE* 0.787 781.85 615.31595
24. Tunisia 0.832 781.85 650.4992
25. Bhutan 0.845 781.85 660.66325
26. Lebanon* 0.863 781.85 674.73655
27. Indonesia* 0.864 781.85 675.5184
28. Colombia* 0.867 781.85 677.86395
29. Pakistan* 0.878 781.85 686.4643
30. Argentina* 0.924 781.85 722.4294
31. Belarus* 0.935 781.85 731.02975

Make you sabi sey 19 out of di 23 kontris dey sell petrol for less dan N568 per litre, wey bi di cheapest price for Naija today.

FINAK TOK

Di claim by di popular actress sey Naija petrol na di cheapest for di world no correct. As e bi, 19 kontris for di world dey sell petrol less dan di N568 wey dem dey sell am for Lagos.

For dis tori, di exchange rate wey we use na $1 = 781.85 according to di Central Bank of Nigeria (CBN) as of July 24, 2023, di tym wen di actress make di claim.

TAGGED: cheapest fuel in the world, Eniola Badmus, Fact check pidgin, Nigeria fuel price, Petrol subsidy removal

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom July 31, 2023 July 31, 2023
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Ṣé àwọn ọmọ ológun Nàìjíríà lo àwòrán tó ti pẹ́ gẹ́gẹ́bí àwòrán iṣẹ́ igbanisilẹ̀ tí wọ́n se láìpẹ́ yìí?

Ní ọjọ́ ajé, àwọn òṣìṣẹ́ ológun orílẹ̀ èdè Nàìjíríà fi ọ̀rọ̀ kan síta pẹ̀lú àwọn…

November 5, 2025

Na true sey di Nigerian army use old foto for recent rescue operation?

On Monday, di Nigerian army publish one statement togeda wit some pictures across dia official…

November 5, 2025

Shin sojojin Najeriya sun yi amfani da tsofaffin hotuna don aikin ceto kwanan nan?

A ranar Litinin din da ta gabata ne rundunar sojin Najeriya ta fitar da sanarwa…

November 5, 2025

Ọ̀rọ̀ tí Tinubu sọ lórí owó orí tí Trump fi síta ni àwọn sa sìse pè ní ọ̀rọ̀ Ààrẹ Nàìjíríà lórí àwọn tí Amẹ́ríkà ń ṣọ́

Ní ọjọ́ ìsinmi, Politics Nigeria, wẹbusaiti kan fi fídíò tí kò pé ìṣẹ́jú kan síta…

November 5, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ṣé àwọn ọmọ ológun Nàìjíríà lo àwòrán tó ti pẹ́ gẹ́gẹ́bí àwòrán iṣẹ́ igbanisilẹ̀ tí wọ́n se láìpẹ́ yìí?

Ní ọjọ́ ajé, àwọn òṣìṣẹ́ ológun orílẹ̀ èdè Nàìjíríà fi ọ̀rọ̀ kan síta pẹ̀lú àwọn àwòrán lórí àwọn ohun ìgbàlódé…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 5, 2025

Na true sey di Nigerian army use old foto for recent rescue operation?

On Monday, di Nigerian army publish one statement togeda wit some pictures across dia official social media platform to announce…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 5, 2025

Shin sojojin Najeriya sun yi amfani da tsofaffin hotuna don aikin ceto kwanan nan?

A ranar Litinin din da ta gabata ne rundunar sojin Najeriya ta fitar da sanarwa tare da wasu hotuna a…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 5, 2025

Ọ̀rọ̀ tí Tinubu sọ lórí owó orí tí Trump fi síta ni àwọn sa sìse pè ní ọ̀rọ̀ Ààrẹ Nàìjíríà lórí àwọn tí Amẹ́ríkà ń ṣọ́

Ní ọjọ́ ìsinmi, Politics Nigeria, wẹbusaiti kan fi fídíò tí kò pé ìṣẹ́jú kan síta lórí Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 5, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?