One viral video wey show as Seyi, President Bola Tinubu pikin, dey collect wetin resemble military salute don cause kasala for social media.
On December 22nd, Mahdi Shehu, one public affairs and political commentator, post di nearly four-minute video with one caption wey dey condemn di greeting.
“Na only for Nigeria wey one non- commissioned Bloody civilian go collect full military honor just because im papa be presido,” na so Shehu tweet.
Di tweet don gada pass 106k views, 880 likes, 575 retweets, 262 comments, and 150 bookmarks.
On Sunday, Atiku Abubakar, former vice-president, criticise di full “military parade”.
For statement wey im media office issue, Abubakar demand investigation into di incident, sey na big disrespect of military tradition.
WETIN BE FULL MILITARY HONOUR?
Military honours na ceremonies wey soldiers dey perform as mark of respect for VIPs or to honour important pesin wey die.
Military parades and guard of honour parades dey serve different ceremonial purposes, even though dem fit dey share some similarities in terms of military tradition and display.
Military parade, according to di Federal Road Safety Corps (FRSC), na formation of soldiers wey dey typically involve marching and drilling to show dia military power, discipline, and readiness.
Guard of honour na group of people wey dem appoint to perform ceremonial duties like to receive big guests for event, to guard important sites, or to participate for state functions.
Guards of honour na usually specially trained pipu wey who perform precise movements and rituals to honor the individuals or events they are associated with.
WETIN WE CHECK
Di group wey receive di president pikin for di viral video na di CADETN (Community Auxiliary Development for Effective Transformation Network), one youth uniformed volunteer organisation.
As pipu dey talk different tins for internet, J.G Fatoye, di group corps commander, release statement on Monday explain sey Seyi collect guard of honour and not military honour.
“As a youth uniformed volunteer organization, we wan set di record straight and clear any doubts about di guard of Honour. We dey use di guard of Honour welcome important pipu to di event as na youth empowerment program and di organization na youth organization,” na so di statement tok.
Fatoye add sey no be only Seyi collect di greetingi.
“Di guard folo honour oda important pipu like di PA to di President on Special Duties as di many big pipu attend di like di Minister of Youth Development, Minister of Digital Economy, SSA to di President on Citizenship & Leadership, SSA to di President on Digital Comm & New Media, CoS to Ogun State Governor and so many oda dignitaries wey grace di occasion,” na so im tok.
“Di CADETN na youth uniformed organization no be military group and we no get any business wit di military or Armed Forces as some trouble makers dey claim.
“Di organization na voluntary organization wey dey operate like dem Man O War, Peace Corps, Royal Ambassador, Man of Order, WAI Brigade and oda relevant uniformed voluntary organizations.”
Fatoye also explain sey dem no use any army uniform, sey even di guns wey dem bin use na fake.
Di corps commander sey make pipu no spread accusations wey no get head.
FINAL TOK
Seyi Tinubu no receive military honour as dem claim.