TheCable Fact Check
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Reading: Na south-east governors form ESN as Obi tok?
Share
Latest News
Anambra guber: Six misconceptions about BVAS, IREV voters should know
Ṣé àwọn ọmọ ológun Nàìjíríà lo àwòrán tó ti pẹ́ gẹ́gẹ́bí àwòrán iṣẹ́ igbanisilẹ̀ tí wọ́n se láìpẹ́ yìí?
Na true sey di Nigerian army use old foto for recent rescue operation?
Shin sojojin Najeriya sun yi amfani da tsofaffin hotuna don aikin ceto kwanan nan?
Ọ̀rọ̀ tí Tinubu sọ lórí owó orí tí Trump fi síta ni àwọn sa sìse pè ní ọ̀rọ̀ Ààrẹ Nàìjíríà lórí àwọn tí Amẹ́ríkà ń ṣọ́
Tinubu speech ontop Trump tariff dey misrepresented as recent comment ontop US watchlist
Maganan Tinubu akan sharhi na baya-bayan nan akan jerin sa ido na Amurka
FACT CHECK: Did Nigerian army use old pictures for recent rescue operation?
Advertisement
Aa
TheCable Fact CheckTheCable Fact Check
Search
  • Home
  • Fact Check
  • Fake News
  • Check Am For Wazobia
Follow US

Na south-east governors form ESN as Obi tok?

Claire Mom
By Claire Mom Published October 27, 2022 4 Min Read
Share

Peter Obi, di presidential candidate of di Labour Party (LP), claim sey na di govnors for south-east form di Eastern Security Network (ESN).

Di presidential candidate make di claim on Monday, October 15, 2022, for one event wey di Arewa Joint Committee for Kaduna organise.

For di video, one pesin wey attend di event ask Obi sey “why north suppose trust you, since I dey hear news, I neva hear sey you open your mouth tok sey di sit at home wey dem dey do evri Monday for south-east no good?”

“Why north suppose trust you, wen, even di campaign council wey you form wey neva tey, for Sokoto and oda states for north, all di chairman na Igbo pipu?

“Why north suppose trust you wen I neva hear, maybe you don tok am before, but I neva hear you say wetin IPOB and di Eastern Security Network (ESN) dey do no good?” na so di pesin ask.

To ansa am, Obi sey im no fit tok sey wetin ESN dey do no good sake of sey na di govment of di eastern states chuk hand inside. 

“E bi like say you no dey follow my campaign. Na di govment of di eastern states create di Eastern Security Network. Di govnors naim form di security team, how I go tok sey wetin dem dey do no good? I don chuk mouth for di sit-at-home mata and e get one place wey dem even call my name. Evritin wey I dey tok, go confam…”

But na true sey di eastern govnors form ESN?

WETIN WE CHECK

TheCable check see sey na Nnamdi Kanu, leader of di Indigenous People of Biafra (IPOB),  form di Eastern Security Network in December 2020.

IPOB, wey Kanu create since 2012, don dey tok sey dem want dia own kontri wey go get all di pipu for south-east sake of sey Nigeria no dey treat dem beta. 

On December 13, 2020, Kanu come announce di launch of di ESN. Im say di main work na to protect di south-east from terrorists and oda criminals.

Before dis tin hapun, some tori wey tok sey some suspected armed Fulani herdsmen bin dey enta pipu farm for di area bin dey internet.

Meanwhile, for di announcement wey Kanu make, e tok sey di security wey im form be like Amotekun wey dey southwest and Miyetti-Allah for di north.

Im come tok sey as di south-east govnors no fit protect di Igbo pipu na why need bin dey to create di security group. 

If you remember, for 2021, di south-east govnors bin come form dia own security group wey dem bin call Ebube Agu, “to fight insecurity for di area”.

Dave Umahi, Ebonyi govnor, wey bin tok on behalf of di oda governors sey na as all di states no come safe again na why dem create di security group.

“For di meeting, all of us gree sey we go chuk hand to create security vigilante for di south-east wey go be Ebube Agu. Di meeting gree sey di vigilante, wey get headquarters for Enugu, go coordinate all di security activities for south-east,” na so Umahi tok.

FINAL TOK

Obi claim wey sey na di eastern govnors form ESN no correct. Na IPOB create di group. Di LP presidential candidate mistake Eastern Security Network wit Ebube Agu.

TAGGED: Eastern Security Network (ESN), Fact check pidgin, Indigenous People of Biafra (IPOB), Nnamdi Kanu, peter obi

Please send your feedback, claims to fact check and corrections requests to [email protected]

Claire Mom October 27, 2022 October 27, 2022
Share this Article
Facebook Twitter Email Copy Link Print
Leave a comment Leave a comment

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

POPULAR POSTS

Advertisement

Anambra guber: Six misconceptions about BVAS, IREV voters should know

Elections in Nigeria have always been defined by controversies. Electoral malpractice, ranging from ballot snatching…

November 7, 2025

Ṣé àwọn ọmọ ológun Nàìjíríà lo àwòrán tó ti pẹ́ gẹ́gẹ́bí àwòrán iṣẹ́ igbanisilẹ̀ tí wọ́n se láìpẹ́ yìí?

Ní ọjọ́ ajé, àwọn òṣìṣẹ́ ológun orílẹ̀ èdè Nàìjíríà fi ọ̀rọ̀ kan síta pẹ̀lú àwọn…

November 5, 2025

Na true sey di Nigerian army use old foto for recent rescue operation?

On Monday, di Nigerian army publish one statement togeda wit some pictures across dia official…

November 5, 2025

Shin sojojin Najeriya sun yi amfani da tsofaffin hotuna don aikin ceto kwanan nan?

A ranar Litinin din da ta gabata ne rundunar sojin Najeriya ta fitar da sanarwa…

November 5, 2025
Advertisement
Advertisement

YOU MAY ALSO LIKE

Ṣé àwọn ọmọ ológun Nàìjíríà lo àwòrán tó ti pẹ́ gẹ́gẹ́bí àwòrán iṣẹ́ igbanisilẹ̀ tí wọ́n se láìpẹ́ yìí?

Ní ọjọ́ ajé, àwọn òṣìṣẹ́ ológun orílẹ̀ èdè Nàìjíríà fi ọ̀rọ̀ kan síta pẹ̀lú àwọn àwòrán lórí àwọn ohun ìgbàlódé…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 5, 2025

Na true sey di Nigerian army use old foto for recent rescue operation?

On Monday, di Nigerian army publish one statement togeda wit some pictures across dia official social media platform to announce…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 5, 2025

Shin sojojin Najeriya sun yi amfani da tsofaffin hotuna don aikin ceto kwanan nan?

A ranar Litinin din da ta gabata ne rundunar sojin Najeriya ta fitar da sanarwa tare da wasu hotuna a…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 5, 2025

Ọ̀rọ̀ tí Tinubu sọ lórí owó orí tí Trump fi síta ni àwọn sa sìse pè ní ọ̀rọ̀ Ààrẹ Nàìjíríà lórí àwọn tí Amẹ́ríkà ń ṣọ́

Ní ọjọ́ ìsinmi, Politics Nigeria, wẹbusaiti kan fi fídíò tí kò pé ìṣẹ́jú kan síta lórí Facebook, ohun ìgbàlódé íbaraẹnisọrẹ…

CHECK AM FOR WAZOBIA
November 5, 2025

CableCheck seeks to provide reliable tools and resources for readers to tackle the menace of fake and misleading materials constantly pushed into the public space from various sources. We monitor the accuracy of claims made in traditional and social media. We also provide a tracker to hold politicians and policymakers accountable for the plans and promises they make to the public. CableCheck is a project of the Cable Newspaper Journalism Foundation (CNJF), supported by the MacArthur Foundation and implemented by TheCable newspaper.

Follow US: 

LINKS

  • Contact
  • About Us
  • Non-Partisanship Policy
  • Funding
  • Correction Policy
© Copyright TheCable. All Rights reserved.
Welcome Back!

Sign in to your account

Lost your password?